Atos 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 As Pita and John still dey tok, di priests, di temple guide oga and di Sadusi pipol waka kon meet dem.
1 Enquanto eles falavam ao povo, vieram os sacerdotes, o chefe do templo e os saduceus,
2 Dem dey vex, bikos Pita and John dey tish di pipol sey, na only thru Jesus Christ, pipol go fit wake-up from deat.
2 contrariados porque ensinavam ao povo e anunciavam, na pessoa de Jesus, a ressurreição dos mortos.
3 So dem arrest dem put for prison till di next day, bikos nite don rish.
3 Prenderam-nos e os meteram no cárcere até o outro dia, pois já era tarde.
4 But pipol wey hear wetin dem tok kon bilive Jesus Christ and di pipol wey bilive, rish 5,000.
4 Muitos, porém, dos que tinham ouvido a pregação creram; e o número dos fiéis elevou-se a mais ou menos cinco mil.
5 Di next day, all di rulers, eldas and lawyers kon gada go Jerusalem.
5 No dia seguinte reuniram-se em Jerusalém os chefes do povo, os anciãos, os escribas,
6 Annas, wey bi di High Priest dey der with Kaiafas, John, Alexanda and some membas for di High Priest family.
6 com Anás, sumo sacerdote, Caifás, João, Alexandre e todos os que eram da linhagem pontifical.
7 Dem drag Pita and John enter dia centre kon bigin ask dem, “Who give una pawa to do dis tins? Na wish pesin name una dey use so?”
7 Colocando-os no meio, perguntaram: Com que poder ou em que nome fizestes isso?
8 Pita wey di Holy Spirit dey use well-well kon ansa, “Awa rulers and eldas,
8 Então Pedro, cheio do Espírito Santo, respondeu-lhes: Chefes do povo e anciãos, ouvi-me:
9 na bikos of di good wey wi do for dis pesin wey nor well, naim make una dey kweshon us today sey, ‘How dis man take well?’
9 se hoje somos interrogados a respeito do benefício feito a um enfermo, e em que nome foi ele curado,
10 My pipol and di oga dem for Israel, make una know sey, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di pesin wey una kill and God raiz am from deat, naim name make dis man wey una dey si so, well.
10 ficai sabendo todos vós e todo o povo de Israel: foi em nome de Jesus Cristo Nazareno, que vós crucificastes, mas que Deus ressuscitou dos mortos. Por ele é que esse homem se acha são, em pé, diante de vós.
11 Dis Jesus Christ, di good stone wey una trowey, God don make am di main pila wey dey whole di house.
11 Esse Jesus, pedra que foi desprezada por vós, edificadores, tornou-se a pedra angular.
12 And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”
12 Em nenhum outro há salvação, porque debaixo do céu nenhum outro nome foi dado aos homens, pelo qual devamos ser salvos.
13 Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.
13 Vendo eles a coragem de Pedro e de João, e considerando que eram homens sem estudo e sem instrução, admiravam-se. Reconheciam-nos como companheiros de Jesus.
14 As dem si sey di man wey God heal stand der with Pita and John, dem nor fit deny wetin happen.
14 Mas vendo com eles o homem que tinha sido curado, não puderam replicar.
15 So dem sey make Pita and John komot for where dem dey, den dem bigin ask each oda,
15 Mandaram que se retirassem da sala do conselho, e conferenciaram entre si:
16 “Wetin wi go do about dis pipol? Bikos evribody wey dey for Jerusalem don know sey na big mirakle naim God use dem do so and wi nor go fit deny am.
16 Que faremos destes homens? Porquanto o milagre por eles feito se tornou conhecido de todos os habitantes de Jerusalém, e não o podemos negar.
17 But make di matter nor for kontinue dey spread among di pipol, make wi warn dem make dem nor tok about dis name again.”
17 Todavia, para que esta notícia não se divulgue mais entre o povo, proibamos com ameaças, que no futuro falem a alguém nesse nome.
18 So dem koll dem go inside kon warn dem make dem nor tok or tish about Jesus Christ name again.
18 Chamaram-nos e ordenaram-lhes que absolutamente não falassem nem ensinassem em nome de Jesus.
19 But Pita and John ansa, “Make una judge wetin good pass for dis matter; make wi obey una or make wi obey God,
19 Responderam-lhes Pedro e João: Julgai-o vós mesmos se é justo diante de Deus obedecermos a vós mais do que a Deus.
20 bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”
20 Não podemos deixar de falar das coisas que temos visto e ouvido.
21 Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so.
21 Eles então, ameaçando-os de novo, soltaram-nos, não achando pretexto para os castigar por causa do povo, porque todos glorificavam a Deus pelo que tinha acontecido.
22 Di man wey receive dis big mirakle, don pass forty years.
22 Pois já passava dos 40 anos o homem em quem se realizara essa cura milagrosa.
23 As dem free dem, Pita and John go meet dia pipol kon tell dem evritin wey di High Priest and di eldas tok.
23 Postos em liberdade, voltaram aos seus irmãos e referiram tudo quanto lhes tinham dito os sumos sacerdotes e os anciãos.
24 Wen dem hear wetin happen, dem kon pray to God sey, “God wey dey for heaven, yu wey make heaven, eart, di sea and evritin wey dey inside dem.
24 Ao ouvirem isso, levantaram unânimes a voz a Deus e disseram: Senhor, vós que fizestes o céu, a terra, o mar e tudo o que neles há.
25 Yor Spirit tok thru yor savant David, awa grand-grand papa sey,
25 Vós que, pelo Espírito Santo, pela boca de nosso pai Davi, vosso servo, dissestes: Por que se agitam as nações, e imaginam os povos coisas vãs?
26 All di kings wey dey di world stand and di rulers gada togeda
26 Levantam-se os reis da terra, e os príncipes se reúnem em conselho contra o Senhor e contra o seu Cristo {Sl 2,1s.}.
27 “True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose
27 Pois na verdade se uniram nesta cidade contra o vosso santo servo Jesus, que ungistes, Herodes e Pôncio Pilatos com as nações e com o povo de Israel,
28 and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.
28 para executarem o que a vossa mão e o vosso conselho predeterminaram que se fizesse.
29 Papa God, make yu si how dem dey treaten us. Wi wey bi yor savants, make yu give us pawa to take prish yor word and
29 Agora, pois, Senhor, olhai para as suas ameaças e concedei aos vossos servos que com todo o desassombro anunciem a vossa palavra.
30 anytime wen wi koll Yor holy pikin Jesus Christ name, make yu heal pipol and do many wonderful mirakles.”
30 Estendei a vossa mão para que se realizem curas, milagres e prodígios pelo nome de Jesus, vosso santo servo!
31 Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.
31 Mal acabavam de rezar, tremeu o lugar onde estavam reunidos. E todos ficaram cheios do Espírito Santo e anunciaram com intrepidez a palavra de Deus.
32 All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.
32 A multidão dos fiéis era um só coração e uma só alma. Ninguém dizia que eram suas as coisas que possuía, mas tudo entre eles era comum.
33 With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well.
33 Com grande coragem os apóstolos davam testemunho da ressurreição do Senhor Jesus. Em todos eles era grande a graça.
34 Nobody among dem sofa, bikos di rish pipol among dem wey get land and house, dey sell dia propaty and bring di money wey dem sell
34 Nem havia entre eles nenhum necessitado, porque todos os que possuíam terras e casas vendiam-nas,
35 kon give di apostles make dem keep am, so dat dem go gi-am to anybody to take buy wetin e wont.
35 e traziam o preço do que tinham vendido e depositavam-no aos pés dos apóstolos. Repartia-se então a cada um deles conforme a sua necessidade.
36 So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus,
36 Assim José {a quem os apóstolos deram o sobrenome de Barnabé que quer dizer Filho da Consolação}, levita natural de Chipre, possuía um campo.
37 sell one land wey e get kon give di money to di apostle make evribody use.
37 Vendeu-o e trouxe o valor dele e depositou aos pés dos apóstolos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.