Atos 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 One day, Pita and John dey go di temple go pray for three oklok for aftanoon.
1 Pedro e João iam subindo ao templo para rezar à hora nona.
2 Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple.
2 Nisto levavam um homem que era coxo de nascença e que punham todos os dias à porta do templo, chamada Formosa, para que pedisse esmolas aos que entravam no templo.
3 As di man si Pita and John wen dem won enter di temple, e kon dey beg dem for money,
3 Quando ele viu que Pedro e João iam entrando no templo, implorou a eles uma esmola.
4 but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!”
4 Pedro fitou nele os olhos, como também João, e disse: Olha para nós.
5 So di man wey nor fit waka kon look dem well-well, bikos e tink sey dem won gi-am money.
5 Ele os olhou com atenção esperando receber deles alguma coisa.
6 Pita kon tell am, “I nor get silva or gold to give yu: but na wetin I get, I go give yu. With Jesus Christ name wey kom from Nazaret, stand up make yu bigin waka!”
6 Pedro, porém, disse: Não tenho nem ouro nem prata, mas o que tenho eu te dou: em nome de Jesus Cristo Nazareno, levanta-te e anda!
7 Pita hold di man for en rite hand kon drag am up and at wons, di man legs kon strong.
7 E tomando-o pela mão direita, levantou-o. Imediatamente os pés e os tornozelos se lhe firmaram. De um salto pôs-se de pé e andava.
8 Di man jump up bigin waka, e follow dem enter di temple dey waka, dey jump up-and-down, dey praiz God.
8 Entrou com eles no templo, caminhando, saltando e louvando a Deus.
9 Pipol si am dey waka dey praiz God
9 Todo o povo o viu andar e louvar a Deus.
10 and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.
10 Reconheceram ser o mesmo coxo que se sentava para mendigar à porta Formosa do templo, e encheram-se de espanto e pasmo pelo que lhe tinha acontecido.
11 Di man still dey jump follow Pita and John with happiness and di pipol still dey sopraiz. Den di pipol run go meet Pita and John for di place wey dem dey koll “Solomon Varanda.”
11 Como ele se conservava perto de Pedro e João, uma multidão de curiosos afluiu a eles no pórtico chamado Salomão.
12 Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka?
12 À vista disso, falou Pedro ao povo: Homens de Israel, por que vos admirais assim? Ou por que fitais os olhos em nós, como se por nossa própria virtude ou piedade tivéssemos feito este homem andar?
13 Na Abraham, Isaak, Jakob and awa grand-grand papa God, naim karry en savant Jesus Christ go up, di one wey una rijet kon gi-am to Pilate make e judge am, even wen e won free am.
13 O Deus de Abraão, de Isaac, de Jacó, o Deus de nossos pais glorificou seu servo Jesus, que vós entregastes e negastes perante Pilatos, quando este resolvera soltá-lo.
14 Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una.
14 Mas vós renegastes o Santo e o Justo e pedistes que se vos desse um homicida.
15 Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.
15 Matastes o Príncipe da vida, mas Deus o ressuscitou dentre os mortos: disso nós somos testemunhas.
16 Dat Jesus Christ name wey wi bilive, naim make dis man wey una dey si and know well-well, strong. Yes! Naim name don heal dis man as una dey si so.
16 Em virtude da fé em seu nome foi que esse mesmo nome consolidou este homem, que vedes e conheceis. Foi a fé em Jesus que lhe deu essa cura perfeita, à vista de todos vós.
17 So my brodas, I know sey una and una oga dem nor know wetin una do.
17 Agora, irmãos, sei que o fizestes por ignorância, como também os vossos chefes.
18 God don tok before-before thru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don make am happen, thru wetin una do.
18 Deus, porém, assim cumpriu o que já antes anunciara pela boca de todos os profetas: que o seu Cristo devia padecer.
19 So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,
19 Arrependei-vos, portanto, e convertei-vos para serem apagados os vossos pecados.
20 so dat una go fit get freedom wey God dey give and E go send Jesus Christ, di Mezaya wey E don prepare down, kom meet una.
20 Virão, assim, da parte do Senhor os tempos de refrigério, e ele enviará aquele que vos é destinado: Cristo Jesus.
21 Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets.
21 É necessário, porém, que o céu o receba até os tempos da restauração universal, da qual falou Deus outrora pela boca dos seus santos profetas.
22 Even Moses sef tok before sey, Jehovah wey bi una God go send one profet to una, just as E send mi and e go bi una family memba. Una must obey evritin wey e sey make una do.
22 Já dissera Moisés: O Senhor, nosso Deus, vos suscitará dentre vossos irmãos um profeta semelhante a mim: a este ouvireis em tudo o que ele vos disser.
23 Anybody wey nor obey dat profet, dem go distroy am and dem go remove am from God family.
23 Todo aquele que não ouvir esse profeta será exterminado do meio do povo {Dt 18,15.19}.
24 God don tok about all dis tins wey dey happen so, from Profet Samuel time go rish di profets wey kom afta am.
24 Todos os profetas, que têm falado sucessivamente desde Samuel, anunciaram estes dias.
25 All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’
25 Vós sois filhos dos profetas e da aliança que Deus estabeleceu com os nossos pais, quando disse a Abraão: Na tua descendência serão abençoadas todas as famílias da terra {Gn 22,18}.
26 So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”
26 Foi em primeiro lugar para vós que Deus suscitou o seu servo, para vos abençoar, a fim de que cada um se aparte da sua iniqüidade.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.