Atos 28

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Afta wi don rish land and nobody die, wi kon hear sey, na Malta dem dey koll di island.
1 E, havendo escapado, então souberam que a ilha se chamava Malta.
2 Di pipol wey dey stay for der trit us well. Dem make fire for us, bikos rain don start to dey fall and kold dey katch us.
2 E os bárbaros usaram conosco de não pouca humanidade; porque, acendendo uma grande fogueira, nos recolheram a todos por causa da chuva que caía, e por causa do frio.
3 Wen Paul dey gada plenty stik make e put inside di fire, one snake wey dem dey koll, “Vipa”, kom out bikos of di heat kon put e mout for Paul hand.
3 E, havendo Paulo ajuntado uma quantidade de vides, e pondo-as no fogo, uma víbora, fugindo do calor, lhe acometeu a mão.
4 Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”
4 E os bárbaros, vendo-lhe a víbora pendurada na mão, diziam uns aos outros: Certamente este homem é homicida, visto como, escapando do mar, a justiça não o deixa viver.
5 But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all.
5 Mas, sacudindo ele a víbora no fogo, não sofreu nenhum mal.
6 But dem dey tink sey en body go swell-up or e go fall for groun die. So afta dem don wait for sometaim kon si sey nor-tin happen to am, dem kon shange mind sey, Paul na god.
6 E eles esperavam que viesse a inchar ou a cair morto de repente; mas tendo esperado já muito, e vendo que nenhum incômodo lhe sobrevinha, mudando de parecer, diziam que era um deus.
7 Dat time for dat aria, Publius, wey bi di oga, get some land. E welkom us kon give us food for three days.
7 E ali, próximo daquele lugar, havia umas herdades que pertenciam ao principal da ilha, por nome Públio, o qual nos recebeu e hospedou benignamente por três dias.
8 Publius papa kon get fever and en belle dey pain am. Paul go si am kon heal am.
8 E aconteceu estar de cama enfermo de febre e disenteria o pai de Públio, que Paulo foi ver, e, havendo orado, pôs as mãos sobre ele, e o curou.
9 Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.
9 Feito, pois, isto, vieram também ter com ele os demais que na ilha tinham enfermidades, e sararam.
10 Dem kon dey praiz us well-well and wen wi won go, dem give us evritin wey wi nid.
10 Os quais nos distinguiram também com muitas honras; e, havendo de navegar, nos proveram das coisas necessárias.
11 Afta wi don dey der for three monts, wi kon enter ship from Alexandria wey stop for di island for kold time and di sign wey dey di ship front, na “Twins god.”
11 E três meses depois partimos num navio de Alexandria que invernara na ilha, o qual tinha por insígnia Castor e Pólux.
12 Wi stop for Syrakuse kon stay der for three days.
12 E, chegando a Siracusa, ficamos ali três dias.
13 From der wi kon rish Rhegium and afta one day, one kind breeze from sout kon start to dey blow and di sekond day, wi kon rish Puteoli.
13 De onde, indo costeando, viemos a Régio; e soprando, um dia depois, um vento do sul, chegamos no segundo dia a Potéoli.
14 For der, wi si some brodas and dem kon beg us to stay with dem for seven days. Na so wi take rish Rome.
14 Onde, achando alguns irmãos, nos rogaram que por sete dias ficássemos com eles; e depois nos dirigimos a Roma.
15 Wen di brodas for Rome hear about us, dem waka until dem rish “Appius Forum” and di “Three Taverns” kom meet us. Wen Paul si dem, e tank God and di tin kon make en heart strong well-well.
15 E de lá, ouvindo os irmãos novas de nós, nos saíram ao encontro à Praça de Ápio e às Três Vendas, e Paulo, vendo-os, deu graças a Deus e tomou ânimo.
16 Wen Paul enter Rome, dem allow am stay en own house with di sojas wey dey guide am.
16 E, logo que chegamos a Roma, o centurião entregou os presos ao capitào da guarda; mas a Paulo se lhe permitiu morar por sua conta à parte, com o soldado que o guardava.
17 Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.
17 E aconteceu que, três dias depois, Paulo convocou os principais dos judeus, e, juntos eles, lhes disse: Homens irmãos, não havendo eu feito nada contra o povo, ou contra os ritos paternos, vim contudo preso desde Jerusalém, entregue nas mãos dos romanos;
18 Wen dem don kweshon mi, dem won release mi, bikos dem nor si anytin wey go make dem kill mi.
18 Os quais, havendo-me examinado, queriam soltar-me, por não haver em mim crime algum de morte.
19 But wen di Jew pipol nor gri make dem free mi, di tin kon make mi sey, I won go Rome make Caesar for judge my kase, nor bi bikos I get anytin wey I dey komplain against my pipol.
19 Mas, opondo-se os judeus, foi-me forçoso apelar para César, não tendo, contudo, de que acusar a minha nação.
20 Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.”
20 Por esta causa vos chamei, para vos ver e falar; porque pela esperança de Israel estou com esta cadeia.
21 Di pipol ansa, “Dem nor send us any leta about yu from Judea and no one for awa brodas don kom from der kon sey yu dey do bad tins.
21 Então eles lhe disseram: Nós não recebemos acerca de ti carta alguma da Judéia, nem veio aqui algum dos irmãos, que nos anunciasse ou dissesse de ti mal algum.
22 But wi go like to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi know sey evribody for di whole world dey take mout kondemn dis group wey yu dey inside.”
22 No entanto bem quiséramos ouvir de ti o que sentes; porque, quanto a esta seita, notório nos é que em toda a parte se fala contra ela.
23 Dem kon gri for di day wen dem go meet am and dem plenty wey kom en house kon meet am. So, from morning till evening, Paul kon dey esplain tins give dem. E dey tok about God kingdom and dey try to show dem wetin Moses Law and di profets tok about Jesus Christ.
23 E, havendo-lhe eles assinalado um dia, muitos foram ter com ele à pousada, aos quais declarava com bom testemunho o reino de Deus, e procurava persuadi-los à fé em Jesus, tanto pela lei de Moisés como pelos profetas, desde a manhã até à tarde.
24 Some among dem bilive wetin e tok, but some nor bilive.
24 E alguns criam no que se dizia; mas outros não criam.
25 So dem kon go, but dem nor gri among demsef afta Paul sey, “Di word wey di Holy Spirit tok thru di Profet Isaya, na true
25 E, como ficaram entre si discordes, despediram-se, dizendo Paulo esta palavra: Bem falou o Espírito Santo a nossos pais pelo profeta Isaías,
26 sey,
26 Dizendo:Vai a este povo, e dize:De ouvido ouvireis, e de maneira nenhuma entendereis;E, vendo vereis, e de maneira nenhuma percebereis.
27 Una heart nor dey undastand
27 Porquanto o coração deste povo está endurecido,e com os ouvidos ouviram pesadamente,e fecharam os olhos,para que nunca com os olhos vejam,Nem com os ouvidos ouçam,Nem do coração entendam,E se convertam,E eu os cure.
28 “So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”
28 Seja-vos, pois, notório que esta salvação de Deus é enviada aos gentios, e eles a ouvirão.
29 Wen e tok finish, di Jew pipol kon leave der dey vex among demsef.
29 E, havendo ele dito estas palavras, partiram os judeus, tendo entre si grande contenda.
30 So for two full years, Paul stay der for en own house wey e rent and e welkom all di pipol wey kom meet am
30 E Paulo ficou dois anos inteiros na sua própria habitação que alugara, e recebia todos quantos vinham vê-lo;
31 kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.
31 Pregando o reino de Deus, e ensinando com toda a liberdade as coisas pertencentes ao Senhor Jesus Cristo, sem impedimento algum.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 28, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.