Atos 27
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group.
1 Logo que foi determinado que embarcássemos para a Itália, Paulo foi entregue com outros presos a um centurião da coorte Augusta, chamado Júlio.
2 Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika, follow us.
2 Embarcamos num navio de Adramito que devia costear as terras da Ásia, e levantamos âncora. Em nossa companhia estava Aristarco, macedônio de Tessalônica.
3 Di next day, wi enter Sidon and Julius kon do good give Paul, e allow am go meet en friends make dem fit gi-am all di tins wey e nid.
3 No dia seguinte, fazendo escala em Sidônia, Júlio, usando de bondade com Paulo, permitiu-lhe ir ver os seus amigos e prover-se do que havia de necessário.
4 From der, wi enter wota travel again face Cyprus island, bikos breeze dey blow di ship.
4 Dali, fazendo-nos ao mar, fomos navegando perto das costas de Chipre, por nos serem contrários os ventos.
5 Afta wi don travel enter di open sea wey dey inside Silisia and Pamfilia, wi kon stop for Myra, wey dey Lycia.
5 Tendo atravessado o mar da Cilícia e da Panfília, chegamos a Mira, cidade da Lícia.
6 For der, di soja kommander kon si one ship wey kom from Alexandria dey drive go Italy and e kon put us for inside.
6 O centurião encontrou ali um navio de Alexandria, que rumava para a Itália, e fez-nos passar para ele.
7 Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus. Bikos di breeze nor make us fit go front again, wi kon drive small-small dey go Krete, wey dey opposite Salmone.
7 Por muitos dias navegamos lentamente e com dificuldade até diante de Cnido, onde o vento não nos permitiu aportar.
8 Before wi rish Krete wotaside, e hard us well-well and wi kon rish one place wey dem dey koll, “Fair Havens” wey dey near Lasea town. Paul Fourt Journey|alt="Paul's Fourt Journey" src="PCM_GPS_Paul4_B&WFlat.indd" size="span" loc="ACT 27:1–28:31" copy="SIL" ref="27:1–28:31"
8 Fomos então costeando ao sul da ilha de Creta, junto ao cabo Salmona. Navegando com dificuldade ao longo da costa, chegamos afinal a um lugar, a que chamam Bons Portos, perto do qual está a cidade de Lasaia.
9 As e bi sey time don go well-well and di journey don hard like dis, bikos di time wey dem dey fast don pass, Paul kon advise dem sey,
9 Passara o tempo - já havia passado a época do jejum - e a navegação se tornava perigosa. Paulo advertiu-os:
10 “My pipol, I dey si sey dis journey na with wahala e go take end and nor bi only di load and di ship go lost, but many pipol go die too.”
10 Amigos, vejo que a navegação não se fará sem perigo e sem graves danos, não somente ao navio e à sua carga, mas ainda às nossas vidas.
11 But di kommander nor listin to am and na wetin di kaptain and di ship owner tok, naim e bilive.
11 O centurião, porém, dava mais crédito ao piloto e ao mestre do que ao que Paulo dizia.
12 Bikos di place where ship dey pak put wen dem si, nor good for kold weda; some for di pipol kon gri sey make wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix, wey dey Krete, wey face sout-west and nort-west, so dat wi go fit spend kold sizin for der.
12 O porto era impróprio para passar o inverno, pelo que a maior parte deles foi de parecer que se retornasse ao mar, na esperança de chegar a Fenice, para passar ali o inverno, por ser esse um porto de Creta, abrigado dos ventos do sudeste e do nordeste.
13 Wen one kind kwayet breeze blow kom from sout, dem tink sey dem go fit do wetin dem plan, so dem kon dey go small-small pass Krete wotaside.
13 Soprava então brandamente o vento sul. Julgavam poder executar os seus planos. Levantaram a âncora e foram costeando de perto a ilha de Creta.
14 Afta di kold breeze, one strong breeze wey dem dey koll, “Hurricane”, kon dey blow kom from di Island.
14 Mas, não muito depois, veio do lado da ilha um tufão chamado Euroaquilão.
15 Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again, wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like.
15 Sem poder resistir à ventania, o navio foi arrebatado e deixamo-nos arrastar.
16 As wi dey run go hide under one small island wey dem dey koll Kauda, nor bi small wahala, before wi fit kontrol di ship.
16 Impelidos rapidamente para uma pequena ilha chamada Cauda, conseguimos, com muito esforço, recolher o batel.
17 Afta dem don drag di ship komot from di wota, dem kon take rope tie am. Wi dey fear sey wi go run around for Sirtis, so wi hook di ship for groun kon leave di breeze make e karry us go.
17 Içaram-no e, depois, como meio de segurança, cingiram o navio com cabos. Então, temendo encalhar em Sirte, arriaram as velas e entregaram-se à mercê dos ventos.
18 Di next day, bikos di breeze worry us well-well, wi kon dey trow awa load put for wota
18 No dia seguinte, sendo a tempestade ainda mais violenta, atiraram fora a carga.
19 and wen di third day rish, dem use dia hand trow wetin dem take dey kontrol di ship put for wota.
19 No terceiro dia, atiramos para fora com as nossas próprias mãos os acessórios do navio.
20 Wen wi nor si sun or star for many days and di breeze still dey worry us, wi kon luz hope sey wi don die bi dat.
20 Ora, não aparecendo por muitos dias nem sol nem estrelas e sendo batidos por forte tempestade, tínhamos por fim perdido toda a esperança de sermos salvos.
21 Afta dem don stay without food for many days, Paul stand for dia front kon sey, “My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala.
21 Desde muito tempo ninguém havia comido nada. Paulo levantou-se no meio deles e disse: Amigos, deveras devíeis ter-me atendido e não ter saído de Creta, e assim evitar esse perigo e essas perdas.
22 Naw, I won make una heart strong, bikos nobody go die among us, but na only di ship go skata.
22 Agora, porém, vos admoesto a que tenhais coragem, pois não perecerá nenhum de vós, mas somente o navio.
23 Bikos yestiday nite, God wey I dey serve, en angel appear to mi
23 Esta noite apareceu-me um anjo de Deus, a quem pertenço e a quem sirvo, o qual me disse:
24 kon sey, ‘Make yu nor fear Paul! Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’
24 Não temas, Paulo. É necessário que compareças diante de César. Deus deu-te todos os que navegam contigo.
25 So, my pipol, make una heart strong, bikos I bilive sey na as God tell mi, na so e go bi.
25 Por isso, amigos, coragem! Eu confio em Deus que há de acontecer como me foi dito.
26 But wi sure sey wi go rish land.”
26 Vamos dar a uma ilha.
27 Afta fourteen days, as di breeze dey karry us pass di Adriatik Sea for mid-nite, di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land.
27 Já estávamos na décima quarta noite, pelo mar Adriático, quando, pela meia-noite, os marinheiros pressentiram que estavam perto de alguma terra.
28 Dem trow long rope wey dem tie sometin put inside di wota to measure how e deep rish and dem si sey di wota still deep rish 40 metres. Afta e don tey small, dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres.
28 Então, atirando a sonda, perceberam que a profundidade era de vinte braças. Depois, um pouco mais adiante, viram que era de quinze braças.
29 Dem dey fear sey di ship go jam rock for di land, so dem trow for big-big shain from di ship back kon dey pray make day kwik break.
29 Temendo que déssemos em algum recife, lançaram quatro âncoras da popa, esperando ansiosos que amanhecesse o dia.
30 Den di sailor try to run leave di ship, dem take di small boat for di ship, put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big shain down for di ship front,
30 Imediatamente, os marinheiros procuraram fugir e, sob o pretexto de largar as âncoras da proa, lançaram o bote ao mar.
31 but Paul tell di offisa and sojas, “Unless all dis men stay inside di ship, all of us go die.”
31 Paulo disse ao centurião e aos soldados: Se estes homens não permanecerem no navio, não podereis salvar-vos.
32 So di sojas kon kut di rope for di boat make e float go.
32 Os soldados cortaram, então, os cabos do bote e deixaram-no cair.
33 As day one break, Paul enkourage dem make dem chop kon sey, “Today make am fourteen days wey una dey worry, sotey una nor gri chop.
33 Enquanto ia amanhecendo, Paulo encorajou a todos que comessem alguma coisa, e disse: Já faz hoje catorze dias que estais em jejum, sem comer nada.
34 So naw, I dey beg una to chop, bikos una nid am to survive. And nobody among una go luz even one hair for en head.”
34 Rogo-vos que comais alguma coisa, no interesse de vossa vida, porque nem um cabelo da cabeça de alguém de vós perecerá.
35 Wen Paul tok finish, e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop.
35 Tendo dito isso, tomou do pão, pronunciou uma bênção na presença de todos e, depois de parti-lo, começou a comer.
36 All of dem get strong heart kon take food chop.
36 Com isso, todos cobraram ânimo e puseram-se igualmente a comer.
37 (Wi bi 276 wey dey inside di ship.)
37 No navio éramos ao todo duzentas e setenta e seis pessoas.
38 Wen dem don chop beleful, dem kon trowey all di remainin bread inside di wota make di ship nor for heavy again.
38 Depois de terem comido à vontade, aliviaram o navio, atirando o trigo ao mar.
39 Wen day break, dem nor know where dem dey, but dem si one small land wey near di sea and dem tok for dia mind sey, if e dey possibol dem go use di ship take enter di land.
39 Afinal, clareou o dia. Os marinheiros não reconheceram a terra, mas viram uma enseada com uma praia, na qual tencionavam encalhar o navio, caso o pudessem.
40 So dem kut all di shains wey whole di ship kon let dem fall inside di sea. Dem still luz di ones wey dey whole wetin dey kontrol di ship. Dem let breeze blow di ship go front and wi kon move face land.
40 Levantaram as âncoras e largaram ao mesmo tempo as amarras dos lemes. Desfraldaram ao vento a vela mestra e rumaram para a praia.
41 But dem meet san-san for di sea. So di ship front kon hook and e nor fit move again, di back skata, bikos of di way di wave dey blow am.
41 Mas deram numa língua de terra, e o navio encalhou aí. A proa, encalhada, permanecia imóvel, ao mesmo tempo que a popa se abria com a força do mar.
42 Di sojas kon plan to kill all di prisonas make dem nor for fit swim kon eskape.
42 Os soldados tencionavam matar os presos, por temerem que algum deles fugisse a nado.
43 But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land
43 O centurião, porém, querendo salvar Paulo, impediu que o fizessem e ordenou que aqueles que pudessem nadar fossem os primeiros a lançar-se ao mar e alcançar a terra.
44 and di rest pipol kon follow for back, some whole di wood and odas whole di ship body wey break. Na so all of dem take rish land and nobody die.
44 Os demais, uns atingiram a terra em tábuas, outros em cima dos destroços do navio. Desse modo, todos conseguiram chegar à terra, sãos e salvos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 27, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.