Atos 26
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 So Agrippa tell Paul, “Make yu tok for yorsef naw.” Den Paul raiz en hand kon start to tok.
1 Depois, Agripa disse a Paulo: Permite-se-te que te defendas. Então, Paulo, estendendo a mão em sua defesa, respondeu:
2 “King Agrippa, about all dis tins wey di Jew pipol dey akuiz mi sey I do, I tank God sey I won defend mysef give yu today,
2 Tenho-me por venturoso, ó rei Agripa, de que perante ti me haja, hoje, de defender de todas as coisas de que sou acusado pelos judeus,
3 bikos yu know all awa tradishon and di matter wey di Jew pipol dey akuiz mi about. So, Abeg, make yu listin to wetin I won tok.
3 mormente sabendo eu que tens conhecimento de todos os costumes e questões que há entre os judeus; pelo que te rogo que me ouças com paciência.
4 Naw, all di Jew pipol know sey na from small pikin I dey live my life with my own pipol for Jerusalem.
4 A minha vida, pois, desde a mocidade, qual haja sido, desde o princípio, em Jerusalém, entre os da minha nação, todos os judeus a sabem.
5 Since dem know mi, if dem go gri kon tok, dem go gri sey na how wi dey serve God, naim I take live as Farisee.
5 Sabendo de mim, desde o princípio (se o quiserem testificar), que, conforme a mais severa seita da nossa religião, vivi fariseu.
6 Naw, I stand make dem judge mi, bikos I put hope for di promise wey God make give awa grand-grand papa dem
6 E, agora, pela esperança da promessa que por Deus foi feita a nossos pais, estou aqui e sou julgado,
7 sey, awa twelf tribes go gain as dem dey use all dia mind dey serve God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim make di Jew pipol dey akuiz mi so!
7 à qual as nossas doze tribos esperam chegar, servindo a Deus continuamente, noite e dia. Por esta esperança, ó rei Agripa, eu sou acusado pelos judeus.
8 Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?
8 Pois quê? Julga-se coisa incrível entre vós que Deus ressuscite os mortos?
9 Even mi mysef, I bilive before sey make wi fight Jesus Christ wey kom from Nazaret.
9 Bem tinha eu imaginado que contra o nome de Jesus, o Nazareno, devia eu praticar muitos atos,
10 And na wetin I do for Jerusalem bi dat. Nor bi only sey I put many of di bilivers for prison with di pawa wey di priest oga dem give mi, but I even dey support wen dem sey make dem kill dem.
10 o que também fiz em Jerusalém. E, havendo recebido poder dos principais dos sacerdotes, encerrei muitos dos santos nas prisões; e, quando os matavam, eu dava o meu voto contra eles.
11 I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.
11 E, castigando-os muitas vezes por todas as sinagogas, os obriguei a blasfemar. E, enfurecido demasiadamente contra eles, até nas cidades estranhas os persegui.
12 “But one day, as I dey do all dis tins, I kon dey go Damaskus with full pawa wey di priest oga dem give mi.
12 Sobre o que, indo, então, a Damasco, com poder e comissão dos principais dos sacerdotes,
13 My king, around aftanoon for road, I kon si one kind lite from heaven wey shine pass di sun. Di lite shine round mi and di pipol wey dey follow mi travel.
13 ao meio-dia, ó rei, vi no caminho uma luz do céu, que excedia o esplendor do sol, cuja claridade me envolveu a mim e aos que iam comigo.
14 Wen wi don fall for groun, I hear one vois wey use Aramaik language tell mi, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi? Yu dey fight yorsef, bikos na stone yu dey kick so.’
14 E, caindo nós todos por terra, ouvi uma voz que me falava e, em língua hebraica, dizia: Saulo, Saulo, por que me persegues? Dura
15 So I ask am, ‘Oga God! Who yu bi?’ God ansa, ‘I bi Jesus Christ wey yu dey ponish.
15 E disse eu: Quem és, Senhor? E ele respondeu: Eu sou Jesus, a quem tu persegues.
16 But make yu get up, bikos I don show mysef to yu and don choose yu as my savant and witness to di tins wey yu don si and di ones wey I go show yu.
16 Mas levanta-te e põe-te sobre teus pés, porque te apareci por isto, para te pôr por ministro e testemunha tanto das
17 I go save yu from yor own pipol and from Gentile pipol wey I dey send yu go meet, so dat
17 livrando-te deste povo e
18 yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
18 para lhes abrires os olhos e das trevas e
19 “So King Agrippa, I nor do strong head wen I receive dis vishon wey kom from heaven,
19 Pelo que, ó rei Agripa, não fui desobediente à visão celestial.
20 but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.
20 Antes, anunciei primeiramente aos que estão em Damasco e em Jerusalém, e por toda a terra da Judeia, e aos gentios, que se emendassem e se convertessem a Deus, fazendo obras dignas de arrependimento.
21 Bikos of dis, di Jew pipol seize mi for di temple front, won kon kill mi.
21 Por causa disto, os judeus lançaram mão de mim no templo e procuraram matar- me.
22 But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,
22 Mas, alcançando socorro de Deus, ainda até ao dia de hoje permaneço, dando testemunho, tanto a pequenos como a grandes, não dizendo nada mais do que o que os profetas e Moisés disseram que devia acontecer,
23 sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”
23 isto é, que o Cristo devia padecer e, sendo o primeiro da ressurreição dos mortos, devia anunciar a luz a este povo e aos gentios.
24 As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!”
24 E, dizendo ele isto em sua defesa, disse Festo em alta voz: Estás louco, Paulo! As muitas letras te fazem delirar!
25 But Paul ansa am, “I nor dey mad oga Festus, but na betta word wey dey good naim I dey tok so.
25 Mas ele disse: Não deliro, ó potentíssimo Festo! Antes, digo palavras de verdade e de um são juízo.
26 Even di king wey I dey tok to so, I bilive sey e know about all dis tins, bikos dem nor happen for sekret.
26 Porque o rei, diante de quem falo com ousadia, sabe estas coisas, pois não creio que nada disto lhe é oculto; porque isto não se fez em qualquer canto.
27 King Agrippa! Yu bilive di tin wey di profets tok?”
27 Crês tu nos profetas, ó rei Agripa? Bem sei que crês.
28 Agrippa ask Paul, “So yu tink sey just naw-naw, yu fit turn mi to Christian?”
28 E disse Agripa a Paulo: Por pouco me queres persuadir a que me faça cristão!
29 Paul ansa, “I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi only yu, but evribody wey dey here, go bi like mi, but make una nor sofa, as I dey sofa so.”
29 E disse Paulo: Prouvera a Deus que, ou por pouco ou por muito, não somente tu, mas também todos quantos hoje me estão ouvindo se tornassem tais qual eu sou, exceto estas cadeias.
30 So di king, di govnor and Bernice kon get up
30 Dizendo ele isto, se levantou o rei, e o governador, e Berenice, e os que com eles estavam assentados.
31 and as dem dey go, dem kon tell each oda, “Dis man nor do anytin wey go fit make dem kill-am or put am for prison.”
31 E, apartando-se dali, falavam uns com os outros, dizendo: Este homem nada fez digno de morte ou de prisões.
32 Agrippa kon tell Festus, “Wi for fit release dis man, if to sey e nor sey make Caesar judge en kase.”
32 E Agripa disse a Festo: Bem podia soltar-se este homem, se não houvera apelado para César.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 26, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.