Atos 25
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Wen three days don pass, Festus komot from Caesaria go Jerusalem.
1 Três dias depois que Festo chegou a Cesareia para assumir suas novas responsabilidades no governo da província, partiu para Jerusalém,
2 So di priest oga dem and all di big men among di Jew pipol kon tell am wetin dem sey Paul do.
2 onde os principais sacerdotes e outros líderes judeus se reuniram com ele e lhe apresentaram as acusações contra Paulo.
3 Dem beg am make e give orda sey make dem bring Paul kom Jerusalem back, bikos dem plan to attack and kill-am for road.
3 Pediram a Festo, como favor, que transferisse Paulo para Jerusalém, pois planejavam armar uma emboscada para matá-lo no caminho.
4 Den Festus ansa, Paul dey for Caesaria and mi mysef go soon go der.
4 Festo respondeu que Paulo estava em Cesareia e que ele próprio voltaria para lá em breve.
5 So e sey, “Make yor leaders follow mi go der and if dis man do anytin wey bad, make dem akuiz am.”
5 “Alguns de vocês que têm autoridade voltem comigo”, disse ele. “Se Paulo tiver feito algo de errado, vocês poderão apresentar suas acusações.”
6 Festus nor stay rish eight or ten days wen e go Caesaria and di next day, e sidan for di judgement seat kon give orda sey make dem bring Paul kom.
6 Oito ou dez dias depois, Festo voltou a Cesareia e, no dia seguinte, convocou o tribunal e mandou que trouxessem Paulo.
7 Wen Paul rish der, di Jew pipol wey kom from Jerusalem kon stand round am, dey akuiz am sey e kommit sin wey dem nor fit show.
7 Quando Paulo chegou, os líderes judeus vindos de Jerusalém se juntaram ao seu redor e fizeram várias acusações graves que não podiam provar.
8 Paul defend ensef sey, “I nor kommit any offence against di Jew law or di temple or against Caesar.”
8 Paulo se defendeu: “Não sou culpado de nenhum crime contra as leis judaicas, nem contra o templo, nem contra o governo romano”.
9 Bikos Festus one make di Jew pipol happy, e kon ask Paul, “Yu ready to go Jerusalem make I judge yor kase for der?”
9 Então Festo, querendo agradar aos judeus, perguntou: “Você está disposto a ir a Jerusalém e ali ser julgado diante de mim?”.
10 Paul ansa, “I stand for Caesar judgement seat, na here dem go for judge my kase. I nor kommit any offence to Jew pipol and even yu yorsef know.
10 Paulo respondeu: “Este é um tribunal oficial romano, portanto devo ser julgado aqui mesmo. O senhor sabe muito bem que não fiz nenhum mal aos judeus.
11 I nor do bad and I nor kommit any offence wey dem fit take kill mi, I nor dey try to run sey make dem nor kill mi, but if evritin wey dem tok against mi nor bi true, nobody go fit karry mi, give dem. I sey make dem karry my kase go give Caesar!”
11 Se fiz algo para merecer a pena de morte, não me recuso a morrer. Mas, se sou inocente, ninguém tem o direito de me entregar a estes homens. Eu apelo para César”.
12 Festus kon sey, “Yu don tok sey make Caesar judge yor kase, so, na Caesar yu go-go meet!”
12 Festo consultou seus conselheiros e, por fim, respondeu: “Muito bem, você apelou para César, então irá para César”.
13 Afta some days, King Agrippa and Bernice go Caesaria, go salot Festus.
13 Alguns dias depois, o rei Agripa chegou com sua irmã, Berenice, para visitar Festo.
14 As dem dey der for many days, Festus kon tell dem about Paul kase, so dat e go hear wetin dem go tok about di matter, so e koll Agrippa kon sey, “One man dey for here wey Felix leave for prison.
14 Durante a estada deles, que durou vários dias, Festo discutiu o caso de Paulo com o rei. “Tenho aqui um prisioneiro que Félix deixou para mim”, disse ele.
15 Wen I dey Jerusalem, di priest oga dem and di eldas kon tell mi about am sey make I kill-am.
15 “Quando estive em Jerusalém, os principais sacerdotes e líderes judeus apresentaram acusações contra ele e pediram que eu o condenasse.
16 But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’
16 Eu lhes disse que a lei romana não condena ninguém sem julgamento. O acusado deve ter a oportunidade de confrontar seus acusadores e se defender.
17 So afta dem follow mi kom here, I kon pospone di kase, but di next day I sidan for judgement seat kon orda make dem bring di man kom.
17 “Quando eles vieram aqui para o julgamento, não me demorei. Convoquei o tribunal logo no dia seguinte e mandei chamar Paulo.
18 Wen pipol wey dey akuiz am stand up, dem nor tok any bad tin against am as I bin suspet.
18 Os judeus, porém, não o acusaram de nenhum dos crimes que eu esperava.
19 Instead, dem dey argue matter with am, about how dem dey serve God and one man wey dem dey koll Jesus Christ wey don die, wey Paul sey e still dey alive.
19 Ao contrário, era algo relacionado à sua religião e a um morto chamado Jesus, que Paulo insiste que está vivo.
20 Bikos I nor know how I go take judge di matter, I kon ask am weda e go like go Jerusalem make dem judge am der.
20 Sem saber como investigar essas questões, perguntei a Paulo se estava disposto a ir a Jerusalém e ali ser julgado por essas acusações,
21 But Paul sey make dem take am go Rome, so dat Caesar go judge en kase, so I kon orda sey make dem keep am for prison, until I go fit send am go meet Caesar.”
21 mas ele apelou ao imperador para que julgue seu caso. Por isso, ordenei que fosse mantido sob custódia até eu tomar as providências necessárias para enviá-lo a César.”
22 Agrippa kon tell Festus, “Mi too go like hear from di man.” So Festus tell am, “Yu go hear from di man tumoro.”King Agrippa and Festus dey kweshon Paul |alt="King Agrippa and Festus interogating Paul" src="WA03992b.tif" size="col" loc="ACTS 25:22-27" copy="Wade" ref="25:22-27"
22 Então Agripa disse a Festo: “Gostaria de ouvir esse homem pessoalmente”. E Festo respondeu: “Amanhã poderá ouvi-lo!”.
23 So di next day, Agrippa and Bernice kon dey make yanga enter di hall, with all di big men wey dey di town. Afta Festus don give orda, dem kon bring Paul.
23 No dia seguinte, Agripa e Berenice chegaram à sala de audiência com grande pompa, acompanhados de oficiais militares e homens importantes da cidade. Festo mandou trazer Paulo e,
24 Den Festus sey, “King Agrippa and all of una wey dey here with us, make una si dis man wey di whole Jew pipol dey beg mi both for here and for Jerusalem sey, make I kill.
24 em seguida, disse: “Rei Agripa e demais presentes, este é o homem cuja morte é exigida pelos judeus tanto daqui como de Jerusalém.
25 But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar.
25 Em minha opinião, ele não fez coisa alguma para merecer a morte. Contudo, uma vez que apelou ao imperador para que julgue seu caso, decidi enviá-lo a Roma.
26 But I nor know wetin I go rite go give di emperor about am. So naim make mi bring am kom all of una and king Agrippa front, so dat afta una don kweshon am finish, I go get sometin wey I go fit rite.
26 “Não sei, porém, o que escrever ao imperador, pois não há nenhuma acusação clara contra ele. Por isso eu o trouxe hoje diante dos senhores, especialmente do rei Agripa, para que, depois de o interrogarmos, eu tenha algo para escrever.
27 Bikos for my mind, e nor dey rite to send prisona go kourt, wen yu nor rite wetin e do.”
27 Pois não faz sentido enviar um prisioneiro ao imperador sem especificar as acusações contra ele”.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.