Atos 24
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Wen five days don pass, Ananias, wey bi di High Priest, kom with some eldas and one lawyer wey dem dey koll Tertullus and dem read wetin dem sey Paul do, give di govnor.
1 Cinco dias depois o sumo sacerdote Ananias desceu com alguns anciãos e um certo Tertulo, orador, os quais fizeram, perante o governador, queixa contra Paulo.
2 Wen dem orda make dem bring Paul kom out, Tertullus tell di govnor sey, “E don tey wen wi dey enjoy peace, bikos of how yu dey rule and all di betta-betta tins wey yu dey do take shange di kountry.
2 Sendo este chamado, Tertulo começou a acusá-lo, dizendo:
3 Oga God Felix, wi dey si all dis tins wey yu dey do for evriwhere. Na evriday wi dey tok about am and dey tank yu.
3 Visto que por ti gozamos de muita paz e por tua providência são continuamente feitas reformas nesta nação, em tudo e em todo lugar reconhecemo-lo com toda a gratidão, ó excelentíssimo Félix.
4 But make my story for nor long too mush, Abeg make yu hear us well-well as yu dey always do.
4 Mas, para que não te detenha muito rogo-te que, conforme a tua eqüidade, nos ouças por um momento.
5 Bikos wi don si dis man sey e find trobol and kause wahala among all di Jew pipol for di world and naim dey lead di gang wey dem dey koll, ‘Di Nazarenes’.
5 Temos achado que este homem é uma peste, e promotor de sedições entre todos os judeus, por todo o mundo, e chefe da seita dos nazarenos;
6 E even take Greek pipol enter di temple, so wi kon arrest am.
6 o qual tentou profanar o templo; e nós o prendemos, e conforme a nossa lei o quisemos julgar.
7 But Lysias, di kommanding offisa kon take am komot from awa hand with force.
7 Mas sobrevindo o comandante Lísias no-lo tirou dentre as mãos com grande violência,
8 So wen yu ask am kweshon, yu go fit hear by yorsef all di tins wey wi sey e do.”
8 mandando aos acusadores que viessem a ti; e dele tu mesmo, examinando-o, poderás certificar-te de tudo aquilo de que o acusamos.
9 As e dey tok, di Jew pipol too dey support sey, wetin e tok, na true.
9 Os judeus também concordam na acusação, afirmando que estas coisas eram assim.
10 Wen di govnor sey make Paul tok, e kon sey, “I know sey yu don bi judge for dis kountry for many years naw, so I nor go fear dey tok as I dey defend mysef.
10 Paulo, tendo-lhe o governador feito sinal que falasse, respondeu: Porquanto sei que há muitos anos és juiz sobre esta nação, com bom ânimo faço a minha defesa,
11 As yu go fit shek for yorsef, e neva pass twelf days naw wey I go Jerusalem go woship.
11 pois bem podes verificar que não há mais de doze dias subi a Jerusalém para adorar,
12 Dem nor si mi dey argue with anybody or dey gada crowd for di temple varanda or inside di sinagog or even for di whole town,
12 e que não me acharam no templo discutindo com alguém nem amotinando o povo, quer nas sinagogas quer na cidade.
13 dem nor fit show yu di offence wey dem akuiz mi sey I kommit.
13 Nem te podem provar as coisas de que agora me acusam.
14 But I go let yu know sey I dey woship di God wey awa grand-grand papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na one kind gang). Dem bilive evritin wey di law tok and wey di profets rite down.
14 Mas confesso-te isto: que, seguindo o caminho a que eles chamam seita, assim sirvo ao Deus de nossos pais, crendo tudo quanto está escrito na lei e nos profetas.
15 I get hope for God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipol wey don die, weda na bad or good pipol, go wake-up.
15 Tendo esperança em Deus, como estes mesmos também esperam, de que há de haver ressurreição tanto dos justos como dos injustos.
16 Na bikos of dis I dey always try my best to get klean belle for God and pipol front.
16 Por isso procuro sempre ter uma consciência sem ofensas diante de Deus e dos homens.
17 Afta many years, I kom Jerusalem back kon give gift to poor pipol and offa sakrifice.
17 Vários anos depois vim trazer à minha nação esmolas e ofertas.
18 Dis na wetin I dey do wen dem si mi for di temple; I dey klean and I nor gada any crowd or disturb anybody.
18 Ocupado nestas coisas, me acharam já santificado no templo não em ajuntamento, nem com tumulto, alguns judeus da Ásia,
19 But some Jew from Asia suppose dey here dey tok di tin wey dem get against mi, if dem get anytin to tok at-all.
19 os quais deviam comparecer diante de ti e acusar-me se tivessem alguma coisa contra mim;
20 Or make dis men wey dey here tok di crime wey I kommit as I face di kansol,
20 ou estes mesmos digam que iniqüidade acharam, quando compareci perante o sinédrio,
21 bikos if e pass dis one, I go shaut as I stand for dia front sey, ‘Una dey judge mi today, bikos I bilive sey pipol wey don die, go wake-up.’ ”
21 a não ser acerca desta única palavra que, estando no meio deles, bradei: Por causa da ressurreição dos mortos é que hoje estou sendo julgado por vós.
22 Den Felix, wey bi sey e know di true story about di Way, pospone di kase kon sey, “Wen Lysias, di kommanding offisa kom, I go judge yor kase.”
22 Félix, porém, que era bem informado a respeito do Caminho, adiou a questão, dizendo: Quando o comandante Lísias tiver descido, então tomarei inteiro conhecimento da vossa causa.
23 E kon orda di soja oga make e guide Paul, but make e gi-am small freedom and make e nor drive en friends if dem won gi-am anytin.
23 E ordenou ao centurião que Paulo ficasse detido, mas fosse tratado com brandura e que a nenhum dos seus proibisse servi-lo.
24 Afta some days, wen Felix with en wife Drusilia wey bi Jew, sidan togeda, dem kon sey make dem bring Paul, so dat dem go listin to am, as e dey tok about how pesin go fit take bilive Jesus Christ.
24 Alguns dias depois, vindo Félix com sua mulher Drusila, que era judia, mandou chamar a Paulo, e ouviu-o acerca da fé em Cristo Jesus.
25 Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”
25 E discorrendo ele sobre a justiça, o domínio próprio e o juízo vindouro, Félix ficou atemorizado e respondeu: Por ora vai-te, e quando tiver ocasião favorável, eu te chamarei.
26 Bikos e dey hope sey Paul go bribe am, naim make am sey make dem bring Paul kom meet am many times.
26 Esperava ao mesmo tempo que Paulo lhe desse dinheiro, pelo que o mandava chamar mais freqüentemente e conversava com ele.
27 Afta two years, Porcius Festus take-ova from Felix and bikos Felix one make di Jew pipol happy, e kon leave Paul for prison.
27 Mas passados dois anos, teve Félix por sucessor a Pórcio Festo; e querendo Félix agradar aos judeus, deixou a Paulo preso.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.