Atos 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Paul look di kansol pipol kon tell dem, “My brodas, I dey live my life with klean mind for God eye kon rish today.”
1 Fitando Paulo os olhos no Sinédrio, disse: Varões, irmãos, tenho andado diante de Deus com toda a boa consciência até ao dia de hoje.
2 Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout.
2 Mas o sumo sacerdote, Ananias, mandou aos que estavam perto dele que lhe batessem na boca.
3 So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?”
3 Então, lhe disse Paulo: Deus há de ferir-te, parede branqueada! Tu estás aí sentado para julgar-me segundo a lei e, contra a lei, mandas agredir-me?
4 Di pipol wey stand near am kon sey, “Yu dey curse God High Priest?”
4 Os que estavam a seu lado disseram: Estás injuriando o sumo sacerdote de Deus?
5 Paul ansa, “I nor know before sey naim bi di High Priest, bikos God word sey, ‘Make yu nor tok bad about di pesin wey dey rule yor pipol.’ ”
5 Respondeu Paulo: Não sabia, irmãos, que ele é sumo sacerdote; porque está escrito: Não falarás mal de uma autoridade do teu povo.
6 Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”
6 Sabendo Paulo que uma parte do Sinédrio se compunha de saduceus e outra, de fariseus, exclamou: Varões, irmãos, eu sou fariseu, filho de fariseus! No tocante à esperança e à ressurreição dos mortos sou julgado!
7 Wen e tok dis tin, kworel kon start between di Farisee and di Sadusi pipol and di kansol kon divide.
7 Ditas estas palavras, levantou-se grande dissensão entre fariseus e saduceus, e a multidão se dividiu.
8 (Bikos Sadusi pipol bilive sey pipol wey don die, nor go wake again and dem nor bilive sey anytin like angel or spirit dey sef, but Farisee pipol bilive all dis tins.)
8 Pois os saduceus declaram não haver ressurreição, nem anjo, nem espírito; ao passo que os fariseus admitem todas essas coisas.
9 So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”
9 Houve, pois, grande vozearia. E, levantando-se alguns escribas da parte dos fariseus, contendiam, dizendo: Não achamos neste homem mal algum; e será que algum espírito ou anjo lhe tenha falado?
10 Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.
10 Tomando vulto a celeuma, temendo o comandante que fosse Paulo espedaçado por eles, mandou descer a guarda para que o retirassem dali e o levassem para a fortaleza.
11 For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.” Di Jews Leaders dey kweshon Paul |alt="Paul standing beofre di Sanhedrin" src="DN00511b.tif" size="col" loc="ACTS 23:1-11" copy="Dunham" ref="23:1-11"
11 Na noite seguinte, o Senhor, pondo-se ao lado dele, disse: Coragem! Pois do modo por que deste testemunho a meu respeito em Jerusalém, assim importa que também o faças em Roma.
12 Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.
12 Quando amanheceu, os judeus se reuniram e, sob anátema, juraram que não haviam de comer, nem beber, enquanto não matassem Paulo.
13 Di pipol wey make dis bad plan pass forty.
13 Eram mais de quarenta os que entraram nesta conspirata.
14 Dem go meet di priest oga dem and di eldas tell dem sey, “Wi don swear sey wi nor go chop anytin until wi kill Paul.
14 Estes, indo ter com os principais sacerdotes e os anciãos, disseram: Juramos, sob pena de anátema, não comer coisa alguma, enquanto não matarmos Paulo.
15 So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”
15 Agora, pois, notificai ao comandante, juntamente com o Sinédrio, que vo-lo apresente como se estivésseis para investigar mais acuradamente a sua causa; e nós, antes que ele chegue, estaremos prontos para assassiná-lo.
16 But wen Paul sista pikin hear about dis plan, e run go inside di barrak go tell Paul.
16 Mas o filho da irmã de Paulo, tendo ouvido a trama, foi, entrou na fortaleza e de tudo avisou a Paulo.
17 Paul koll one soja oga kon tell am, “Take dis boy go meet di kommanding offisa, bikos e get sometin wey e won tell am.”
17 Então, este, chamando um dos centuriões, disse: Leva este rapaz ao comandante, porque tem alguma coisa a comunicar-lhe.
18 So di soja oga take di boy go meet di kommanding offisa kon sey, “Paul, wey dey prison, sey make I bring dis boy kon meet yu, bikos e get sometin wey e won tell yu.”
18 Tomando-o, pois, levou-o ao comandante, dizendo: O preso Paulo, chamando-me, pediu-me que trouxesse à tua presença este rapaz, pois tem algo que dizer-te.
19 Di kommanding offisa whole di boy for hand go one korna kon ask am, “Wetin yu won tell mi?”
19 Tomou-o pela mão o comandante e, pondo-se à parte, perguntou-lhe: Que tens a comunicar-me?
20 Di boy ansa, “Jew pipol dey plan sey dem go ask yu make yu bring Paul kom di kansol tumoro, like sey dem won ask am kweshon again.
20 Respondeu ele: Os judeus decidiram rogar-te que, amanhã, apresentes Paulo ao Sinédrio, como se houvesse de inquirir mais acuradamente a seu respeito.
21 So make yu nor allow dem deceive yu, bikos dem pass forty wey hide for bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anytin, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu.”
21 Tu, pois, não te deixes persuadir, porque mais de quarenta entre eles estão pactuados entre si, sob anátema, de não comer, nem beber, enquanto não o matarem; e, agora, estão prontos, esperando a tua promessa.
22 So di kommanding offisa tell di boy make e dey go kon warn am sey, “Nor tell anybody sey yu don ripot dis matter give mi.”
22 Então, o comandante despediu o rapaz, recomendando-lhe que a ninguém dissesse ter-lhe trazido estas informações.
23 Den e koll two soja oga kon tell dem, “For nine oklok dis nite, make una ready two hundred sojas wey go-go Caesaria, plus seventy, wey go ride horse and two hundred, wey go karry spear.
23 Chamando dois centuriões, ordenou: Tende de prontidão, desde a hora terceira da noite, duzentos soldados, setenta de cavalaria e duzentos lanceiros para irem até Cesareia;
24 Make una arrange horse wey Paul go sidan put, so dat una go fit guide am well-well go meet Felix wey bi di govnor.”
24 preparai também animais para fazer Paulo montar e ir com segurança ao governador Félix.
25 E rite leta like dis:
25 E o comandante escreveu uma carta nestes termos:
26 “From Klaudius Lysias to Govnor Felix, I salot yu!
26 Cláudio Lísias ao excelentíssimo governador Félix, saúde.
27 Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin.
27 Este homem foi preso pelos judeus e estava prestes a ser morto por eles, quando eu, sobrevindo com a guarda, o livrei, por saber que ele era romano.
28 Bikos I won know di offence wey e kommit, I kon karry am go dia kansol.
28 Querendo certificar-me do motivo por que o acusavam, fi-lo descer ao Sinédrio deles;
29 I kon si sey en offence, na about wetin dem dey argue about for dia law, but e nor do anytin wey rish to kill-am or put am for prison.
29 verifiquei ser ele acusado de coisas referentes à lei que os rege, nada, porém, que justificasse morte ou mesmo prisão.
30 Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”
30 Sendo eu informado de que ia haver uma cilada contra o homem, tratei de enviá-lo a ti, sem demora, intimando também os acusadores a irem dizer, na tua presença, o que há contra ele. [Saúde.]
31 So di sojas karry Paul for nite until dem rish Antipatris, just as dia oga kommand dem.
31 Os soldados, pois, conforme lhes foi ordenado, tomaram Paulo e, durante a noite, o conduziram até Antipátride;
32 Di next day, di two soja oga leave di men wey dey ride horse follow Paul and dem kon go dia barrak back.
32 no dia seguinte, voltaram para a fortaleza, tendo deixado aos de cavalaria o irem com ele;
33 Wen di men wey dey ride horse rish Caesaria, dem kon take Paul and di leta give di govnor.
33 os quais, chegando a Cesareia, entregaram a carta ao governador e também lhe apresentaram Paulo.
34 Wen di govnor don read di leta, e ask dem where Paul from kom. Wen e hear sey e kom from Silisia,
34 Lida a carta, perguntou o governador de que província ele era; e, quando soube que era da Cilícia,
35 e kon sey, “I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here.” Den e orda sey make dem guide Paul for inside Herod palis.
35 disse: Ouvir-te-ei quando chegarem os teus acusadores. E mandou que ele fosse detido no pretório de Herodes.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.