Atos 22
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 “My brodas and fada, make una hear mi as I dey defend mysef.”
1 Irmãos e pais, ouvi o que vos tenho a dizer em minha defesa.
2 (Wen dem hear sey e dey tok to dem with Aramaik language, dem kon kwayet well-well.) Den Paul sey,
2 Quando ouviram que lhes falava em língua hebraica, escutaram-no com a maior atenção.
3 “I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.
3 Continuou ele: Eu sou judeu, nasci em Tarso da Cilícia, mas criei-me nesta cidade, instruí-me aos pés de Gamaliel, em toda a observância da lei de nossos pais, partidário entusiasta da causa de Deus como todos vós também o sois no dia de hoje.
4 I sofa Christians and I dey kill pipol wey dey serve God, dey tie pipol trow for prison, weda dem bi man or woman
4 Eu persegui de morte essa doutrina, prendendo e metendo em cárceres homens e mulheres.
5 and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arrest pipol wey bilive Christ kon bring dem kom Jerusalem put for prison.
5 O sumo sacerdote e todo o conselho dos anciãos me são testemunhas. E foi deles que também recebi cartas para os irmãos de Damasco, para onde me dirigi, com o fim de prender os que lá se achassem e trazê-los a Jerusalém, para que fossem castigados.
6 As I dey go, near Damaskus, around aftanoon, one kind lite from heaven kon shine round mi.
6 Ora, estando eu a caminho, e aproximando-me de Damasco, pelo meio-dia, de repente me cercou uma forte luz do céu.
7 Den I fall for groun kon hear one vois wey sey, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi?’
7 Caí por terra e ouvi uma voz que me dizia: Saulo, Saulo, por que me persegues?
8 I ansa, ‘Who yu bi Oga God?’ E kon sey, ‘I bi Jesus Christ wey kom from Nazaret, wey yu dey ponish.’
8 Eu repliquei: Quem és tu, Senhor? A voz me disse: Eu sou Jesus de Nazaré, a quem tu persegues.
9 Di pipol wey follow mi si di lite, but dem nor undastand di vois wey dey tok to mi.
9 Os meus companheiros viram a luz, mas não ouviram a voz de quem falava.
10 So I ask am, ‘Oga God! Wetin yu wont make I do?’ God ansa, ‘Get up make yu go Damaskus; for der, dem go tell yu evritin wey God don choose sey yu go do.’
10 Então eu disse: Senhor, que devo fazer? E o Senhor me respondeu: Levanta-te, vai a Damasco e lá te será dito tudo o que deves fazer.
11 Bikos of how di lite shine for my eye, I nor fit si again, so di pipol wey dey follow mi kon whole my hand go Damaskus.
11 Como eu não pudesse ver por causa da intensidade daquela luz, guiado pela mão dos meus companheiros, cheguei a Damasco.
12 One man wey dem dey koll Ananias, wey dey holy and dey serve God akordin to di law and di Jew pipol wey dey stay der, dey tok good about am.
12 Um certo Ananias, homem piedoso e observador da lei, muito bem conceituado entre todos os judeus daquela cidade,
13 Na di man kom meet and stand near mi sey, ‘Broda Saul, make yu bigin si again!’ So for dat same time, I look up kon si am.
13 veio ter comigo e disse-me: Irmão Saulo, recobra a tua vista. Naquela mesma hora pude enxergá-lo.
14 Den e sey, ‘God wey awa grand-grand papa dem serve don already choose yu to do wetin e wont, so dat yu go take yor eye si di Raitious Pesin. So make yu hear and listin to am,
14 Continuou ele: O Deus de nossos pais te predestinou para que conhecesses a sua vontade, visses o Justo e ouvisses a palavra da sua boca,
15 bikos yu go bi witness to all di pipol, about wetin yu don si and hear.
15 pois lhe serás, diante de todos os homens, testemunha das coisas que tens visto e ouvido.
16 Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’
16 E agora, por que tardas? Levanta-te. Recebe o batismo e purifica-te dos teus pecados, invocando o seu nome.
17 Wen I go Jerusalem back and dey pray for di temple, I kon si vishon
17 Voltei para Jerusalém e, orando no templo, fui arrebatado em êxtase.
18 and Jesus Christ sey, ‘Make yu komot for Jerusalem kwik-kwik, bikos dem nor go asept wetin yu dey tok about mi.’
18 E vi Jesus que me dizia: Apressa-te e sai logo de Jerusalém, porque não receberão o teu testemunho a meu respeito.
19 I ansa, ‘Oga God, dem diasef know sey I dey beat and trow pipol wey bilive yu put for prison.
19 Eu repliquei: Senhor, eles sabem que eu encarcerava e açoitava com varas nas sinagogas os que crêem em ti.
20 And wen dem kill yor savant Stefen, I stand der support dem kon keep dia koat for dem.’
20 E quando se derramou o sangue de Estêvão, tua testemunha, eu estava presente, consentia nisso e guardava os mantos dos que o matavam.
21 But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”
21 Mas ele me respondeu: Vai, porque eu te enviarei para longe, às nações...
22 As e tok finish, pipol wey gada dey listin to am kon dey shaut, “Karry dis man komot! Make dem nor allow am live!”
22 Haviam-no escutado até essa palavra. Então levantaram a voz: Tira do mundo esse homem! Não é digno de viver!
23 As dem dey shaut dey vex pul shirt and trowey san-san,
23 Como vociferassem, arrojassem de si as vestes e lançassem pó ao ar,
24 di kommanding offisa kon give orda sey make dem take Paul go inside barrak. E sey make dem flog and ask Paul kweshon, so dat dem go fit know why di pipol dey shaut for Paul head like dat.
24 o tribuno mandou recolhê-lo à cidadela, açoitá-lo e submetê-lo a torturas, para saber por que causa clamavam assim contra ele.
25 Wen dem don put am for groun make dem start to flog am, Paul kon ask di soja wey stand near am, “E dey rite make una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva judge en kase?”
25 Quando o iam amarrando com a correia, Paulo perguntou a um centurião que estava presente: É permitido açoitar um cidadão romano que nem sequer foi julgado?
26 Wen di soja hear dis, e go tell di kommanding offisa, “Wetin yu won do so? Dis man kom from Rome o-o.”
26 Ao ouvir isso, o centurião foi ter com o tribuno e avisou-o: Que vais fazer? Este homem é cidadão romano.
27 So di kommanding offisa ask Paul, “Tell mi, yu bi Roman citizin?” Paul ansa, “Yes.”
27 Veio o tribuno e perguntou-lhe: Dize-me, és romano? Sim, respondeu-lhe.
28 Di kommanding offisa kon sey, “Na big money I spend to bi Roman citizin.” Paul ansa, “But dem born mi for Rome.”
28 O tribuno replicou: Eu adquiri este direito de cidadão por grande soma de dinheiro. Paulo respondeu: Pois eu o sou de nascimento.
29 Den doz men wey bi won ask am kweshon kon komot and fear katch di kommanding offisa wen e know sey Paul, wey dem tie, na Roman citizin.
29 Apartaram-se então dele os que iam torturá-lo. O tribuno alarmou-se porque o mandara acorrentar, sendo ele um cidadão romano.
30 Di next day, bikos di kommanding offisa won know di rizin wey make di Jew pipol dey akuiz Paul, e release am kon orda di priest oga dem and di whole kansol make dem gada. So e bring Paul kon stand for dia front.
30 No dia seguinte, querendo saber com mais exatidão de que os judeus o acusavam, soltou-o e ordenou que se reunissem os sumos sacerdotes e todo o Grande Conselho. Trouxe Paulo e o mandou comparecer diante deles.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.