Atos 21

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Afta wi don leave dem, wi enter ship kon travel go Kos. Di next day, wi go Rhodes and from der, wi kon go Patara.
1 Depois de nos separarmos deles, navegamos diretamente para a ilha de Cós. No dia seguinte, chegamos a Rodes, e dali fomos a Pátara.
2 Wi si one ship dey cross go Foenicia, so wi kon enter am.
2 Encontrando um navio que ia para a Fenícia, embarcamos nele, seguindo viagem.
3 Afta wi rish Cyprus, wi kon leave der travel go Siria, kom stop for Tyre, bikos di ship won put load down.
3 Quando a ilha de Chipre já estava à vista, deixando-a à esquerda, navegamos para a Síria e chegamos a Tiro, pois o navio devia ser descarregado ali.
4 Wi kon go find di disciples wey dey for di town, wen wi si dem, wi stay with dem for seven days. Dem kon tell Paul many times sey make e nor go Jerusalem.
4 Encontrando os discípulos, permanecemos lá durante sete dias. Movidos pelo Espírito, eles recomendavam a Paulo que não fosse a Jerusalém.
5 Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside
5 Passados aqueles dias, saímos para continuar a viagem. Todos os discípulos, cada um com a sua mulher e os seus filhos, nos acompanharam até fora da cidade; e, ajoelhados na praia, oramos.
6 kon tell dem bye-bye and as wi enter ship, dem kon go back to dia house.
6 Despedindo-nos uns dos outros, embarcamos; e eles voltaram para casa.
7 Wi kontinue awa journey from Tyre go rish Ptolemais and wen wi don greet di brodas, wi stay with dem for one day.
7 Quanto a nós, concluindo a viagem iniciada em Tiro, chegamos a Ptolemaida, onde saudamos os irmãos, passando um dia com eles.
8 Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.
8 No dia seguinte, partimos e fomos para Cesareia. E, entrando na casa de Filipe, o evangelista, que era um dos sete, ficamos com ele.
9 (E get for dotas wey neva marry, wey dey profesai.)
9 Filipe tinha quatro filhas solteiras, que profetizavam.
10 As wi stay der for some days, one profet wey en name na Agabus kom from Judea.
10 Demorando-nos ali alguns dias, veio da Judeia um profeta chamado Ágabo,
11 E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ”
11 que, aproximando-se de nós, pegou o cinto de Paulo e, amarrando com ele os próprios pés e mãos, declarou: — Assim diz o Espírito Santo: É isto que os judeus em Jerusalém farão ao dono deste cinto para entregá-lo nas mãos dos gentios.
12 Wen wi hear wetin e tok, wi and di pipol wey dey der kon beg Paul sey make e nor go Jerusalem.
12 Quando ouvimos estas palavras, tanto nós como os daquele lugar rogamos a Paulo que não fosse a Jerusalém.
13 But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”
13 Mas ele respondeu: — O que estão fazendo, ao chorar assim e partir o meu coração? Pois estou pronto não só para ser preso, mas até para morrer em Jerusalém pelo nome do Senhor Jesus.
14 Bikos wi nor fit stop am again, wi kon keep kwayet and only en kon sey, “Wetin God wont make e happen, go happen.”
14 Como Paulo não se deixou persuadir, conformados, dissemos: — Seja feita a vontade do Senhor!
15 Afta dat day, wi prepare kon go Jerusalem.
15 Passados aqueles dias, tendo feito os preparativos, fomos para Jerusalém.
16 Some disciples from Caesaria follow us go, dem kon take us go Mnason house for Cyprus. Dis Mnason dey among di first disciples and wi stay der with am.
16 Alguns dos discípulos também vieram de Cesareia conosco, trazendo consigo Mnasom, natural de Chipre, velho discípulo, com quem nos deveríamos hospedar.
17 Wen wi rish Jerusalem, di brodas welkom us with happiness.
17 Quando chegamos a Jerusalém, os irmãos nos receberam com alegria.
18 Di next day, Paul kon follow us go si James and all di eldas wey dey der.
18 No dia seguinte, Paulo foi conosco encontrar-se com Tiago, e todos os presbíteros se reuniram.
19 Wen Paul don greet dem, e kon start to tok di story about wetin God don do for Gentile pipol thru en ministry.
19 E, tendo-os saudado, contou em detalhes o que Deus tinha feito entre os gentios por seu ministério.
20 Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey praiz God. Den, dem tell am, “Yu si, awa broda, many Jew don bilive and dem still dey obey di law!
20 Ouvindo isso, eles deram glória a Deus e lhe disseram: — Você percebe, irmão, que há milhares de judeus que creram, e todos são zelosos da Lei.
21 Dem hear sey yu dey tish Jew pipol wey dey stay with Gentile pipol, sey make dem trowey Moses Law; make dem nor sekonsaiz dia shidren again and make dem nor follow awa laws again.
21 Eles foram informados que você ensina todos os judeus entre os gentios a apostatarem de Moisés, dizendo-lhes que não devem circuncidar os filhos, nem andar segundo os costumes da Lei.
22 So, wetin wi go do? Bikos dem go really hear sey yu don kom.
22 Que faremos, então? Certamente saberão que você já chegou.
23 So make yu do wetin wi won tell yu: For men dey with us here wey make vow;
23 Faça, portanto, o que vamos dizer: Estão entre nós quatro homens que, voluntariamente, fizeram um voto.
24 take dem follow body make una go do wetin Moses Law tok and make yu pay all di money wey dem spend take shave dia head. Den, evribody go know sey all di story wey dem hear about yu, nor bi true and dem go si sey yu yorsef dey obey di law.
24 Leve esses homens, participe da cerimônia de purificação com eles e pague a despesa deles, para que rapem a cabeça. Assim todos saberão que não procede a informação que receberam a respeito de você e que, pelo contrário, você mesmo vive de conformidade com a lei.
25 But for Gentile pipol wey don bilive, wi don rite leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.”
25 Quanto aos gentios que creram, já lhes transmitimos decisões para que se abstenham das coisas sacrificadas a ídolos, do sangue, da carne de animais sufocados e da imoralidade sexual.
26 Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
26 Então Paulo, levando aqueles homens, no dia seguinte, tendo-se purificado com eles, entrou no templo, acertando o cumprimento dos dias da purificação, até que se fizesse a oferta em favor de cada um deles.
27 Wen di seven days don dey finish, di Jew pipol wey kom from Asia kon si am for di temple, naim dem start wahala and pipol kon gada. Dem seize Paul
27 Quando já estavam por findar os sete dias, os judeus que tinham vindo da província da Ásia, ao verem Paulo no templo, alvoroçaram todo o povo e o agarraram,
28 dey shaut sey, “Israel pipol, make una kom o-o! Dis na di man wey dey tish pipol for evriwhere, about tins wey dey against awa pipol, awa law and against dis Temple. Even sef e don take Greek pipol enter inside di temple kon make dis Holy Place dirty.”
28 gritando: — Israelitas, socorro! Este é o homem que por toda parte anda ensinando todos a serem contra o povo, contra a Lei e contra este lugar. E mais ainda: introduziu até gregos no templo e profanou este recinto sagrado.
29 (Bikos dem si Trofimus wey kom from Efesus for di town with am before, so dem kon tink sey, Paul don karry am enter di temple.)
29 Disseram isso, pois antes tinham visto Trófimo, o efésio, em sua companhia na cidade e pensavam que Paulo o havia levado para dentro do templo.
30 Di whole town start to shake and all di pipol kon gada. Dem seize Paul, drag am komot from di temple kon klose di door.
30 Toda a cidade ficou em grande alvoroço, e o povo veio correndo. Agarraram Paulo e o arrastaram para fora do templo; e imediatamente as portas foram fechadas.
31 As dem dey try to kill-am, news kon rish di kommanding offisa for di Roman soja wey dey guide di town sey, di whole Jerusalem don skata.
31 Procurando eles matá-lo, chegou ao conhecimento do comandante das tropas romanas que toda a Jerusalém estava amotinada.
32 At wons, e karry plenty sojas and ofisas kon run go where di pipol gada. Wen dem si di kommanding offisa and di sojas, dem kon stop to beat Paul.
32 Então este, levando logo soldados e centuriões, correu para o meio do povo. Ao verem chegar o comandante e os soldados, pararam de espancar Paulo.
33 Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do.
33 O comandante se aproximou e ordenou que Paulo fosse preso e amarrado com duas correntes. Então perguntou quem era e o que havia feito.
34 Some pipol among di crowd kon dey tok difren-difren tins and wen di kommanding offisa nor fit know wetin kause di wahala, e kon give orda sey, make dem karry Paul go barrak.
34 Na multidão, uns gritavam uma coisa, outros gritavam outra. Não podendo ele, porém, saber a verdade por causa do tumulto, ordenou que Paulo fosse recolhido à fortaleza.
35 Wen e rish di step for di temple, di sojas kon karry Paul, bikos of di crowd wey won kill-am.
35 Ao chegar às escadas, foi preciso que os soldados o carregassem, por causa da violência da multidão,
36 So dem follow di sojas for back kon dey shaut, “Kill-am!”
36 pois a massa de povo o seguia gritando: — Mate-o!
37 As dem won karry Paul enter di barrak, e kon ask di kommanding offisa, “I go fit tok to yu first?” Di offisa ansa, “So yu dey hear Greek language?
37 E, quando Paulo ia sendo recolhido à fortaleza, disse ao comandante: — Seria possível dizer algo para o senhor? O comandante respondeu: — Você sabe grego?
38 So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?”
38 Você não é, por acaso, aquele egípcio que algum tempo atrás começou uma revolta e levou quatro mil guerrilheiros para o deserto?
39 Paul ansa, “I bi Jew wey kom from Tarsus wey dey Silisia. I bi citizin for dis town and dem know mi well-well. Abeg allow mi follow di pipol tok.”
39 Paulo respondeu: — Eu sou judeu, natural de Tarso, uma importante cidade da Cilícia. E peço ao senhor que me permita falar ao povo.
40 Wen di kommanding offisa allow am, Paul kon stand for di step, wave en hand sey make dem kwayet. Wen evriwhere don kwayet, e kon use Aramaik language follow dem tok.
40 Obtida a permissão, Paulo, em pé na escadaria, fez com a mão sinal ao povo. Fez-se grande silêncio, e ele falou em língua hebraica, dizendo:

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.