Atos 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Afta di wahala for Efesus, Paul send for di disciples and afta e enkourage dem, e tell dem bye-bye kon komot der go Masidonia.
1 Depois que cessou o alvoroço, Paulo chamou a si os discípulos e, abraçando-os, saiu para a Macedônia.
2 Afta e waka round di aria, e enkourage di bilivers wey dey der kon go Greece.
2 E, havendo andado por aquelas terras e exortando-os com muitas palavras, veio à Grécia.
3 E stay for der for three monts. Bikos Jew pipol don plan to wait make dem katch am, as e won enter ship go Siria, e kon go back thru Masidonia.
3 Passando ali três meses e sendo-lhe pelos judeus postas ciladas, como tivesse de navegar para a Síria, determinou voltar pela Macedônia.
4 Pipol wey follow Paul go, na Sopata, wey bi Pyrrhus pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekundus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti with Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.
4 E acompanhou-o, até à Ásia, Sópatro, de Bereia, e, dos de Tessalônica, Aristarco e Segundo, e Gaio, de Derbe, e Timóteo, e, dos da Ásia, Tíquico e Trófimo.
5 All dis pipol don go for front go wait us for Troas.
5 Estes, indo adiante, nos esperaram em Trôade.
6 Wi enter ship from Filippi afta di Passova Feast and afta five days, wi meet dem for Troas kon stay der for seven days.
6 E, depois dos dias dos pães asmos, navegamos de Filipos e, em cinco dias, fomos ter com eles a Trôade, onde estivemos sete dias.
7 For di first day for di week, wen wi whole meetin to break bread togeda, Paul start to tok with di pipol and bikos e won go di next day, e kon prish till mid-nite.
7 No primeiro dia da semana, ajuntando-se os discípulos para partir o pão, Paulo, que havia de partir no dia seguinte, falava com eles; e alargou a prática até à meia-noite.
8 (For di room for upstair where wi for dey meet, lamp many for der),
8 Havia muitas luzes no cenáculo onde estavam juntos.
9 one boy wey dem dey koll Eutikus, sidan for di window kon dey sleep as Paul dey prish. Di sleep karry am go, so e fall from di three story and wen dem rush go karry am, dem si sey e don die.
9 E, estando um certo jovem, por nome Êutico, assentado numa janela, caiu do terceiro andar, tomado de um sono profundo que lhe sobreveio durante o extenso discurso de Paulo; e foi levantado morto.
10 But Paul go down, liedan on-top di boy kon put en hand round am sey, “Make una nor worry, bikos e still dey alive!”
10 Paulo, porém, descendo, inclinou-se sobre ele e, abraçando-o, disse: Não vos perturbeis, que a sua alma nele está.
11 Den Paul go upstair and afta e don break bread with dem, e follow dem tok till day break. Den e kon komot from der.
11 E, subindo, e partindo o pão, e comendo, ainda lhes falou largamente até à alvorada; e, assim, partiu.
12 Dem take di boy go house kon dey happy sey e dey alive.
12 E levaram vivo o jovem, e ficaram não pouco consolados.
13 Wi waka go where di ship dey kon go Asoss, so dat wi go karry Paul for der, bikos e plan sey e go pass land go der.
13 Nós, porém, subindo ao navio, navegamos até Assôs, onde devíamos receber a Paulo, porque assim o ordenara, indo ele por terra.
14 Wen e meet us for Asoss, wi karry am for di sheep kon go Mitilene.
14 E, logo que se ajuntou conosco em Assôs, o recebemos e fomos a Mitilene.
15 From der, wi move and di next day, wi kon rish Miletus.
15 E, navegando dali, chegamos no dia seguinte defronte de Quios, no outro, aportamos a Samos e, ficando em Trogílio, chegamos no dia seguinte a Mileto.
16 Paul don sey e go travel pass Efesus make e for nor spend time for Asia, bikos e dey hurry make e for kwik rish Jerusalem for Pentekost Day.
16 Porque já Paulo tinha determinado passar adiante de Éfeso, para não gastar tempo na Ásia. Apressava-se, pois, para estar, se lhe fosse possível, em Jerusalém no dia de Pentecostes.
17 From Miletus, e send messenja go Efesus sey make di eldas wey dey di church kon meet am der.
17 De Mileto, mandou a Éfeso chamar os anciãos da igreja.
18 Wen dem kom, e tell dem, “All of una know how I dey live my life since di time wey I dey with una and from di first day wey I enter Asia;
18 E, logo que chegaram junto dele, disse-lhes: Vós bem sabeis, desde o primeiro dia em que entrei na Ásia, como em todo esse tempo me portei no meio de vós,
19 how I nor dey karry body up as I dey serve Jesus with pain and wahala wey I dey face, bikos of di wiked plan wey Jew pipol get for mi.
19 servindo ao Senhor com toda a humildade e com muitas lágrimas e tentações que, pelas ciladas dos judeus, me sobrevieram;
20 Una know sey I nor stop to dey tell una anytin wey go help una and I tish una for publik and for una house.
20 como nada, que útil seja, deixei de vos anunciar e ensinar publicamente e pelas casas,
21 I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.
21 testificando, tanto aos judeus como aos gregos, a conversão a Deus e a fé em nosso Senhor Jesus Cristo.
22 Naw, di Spirit dey lead mi go Jerusalem, even doh I nor know wetin go happen to mi for der,
22 E, agora, eis que, ligado eu pelo espírito, vou para Jerusalém, não sabendo o que lá me há de acontecer,
23 escept sey di Holy Spirit dey warn mi sey, from town to town, na prison and sofa dey wait for mi.
23 senão o que o Espírito Santo, de cidade em cidade, me revela, dizendo que me esperam prisões e tribulações.
24 But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.
24 Mas em nada tenho a minha vida por preciosa, contanto que cumpra com alegria a minha carreira e o ministério que recebi do Senhor Jesus, para dar testemunho do evangelho da graça de Deus.
25 “Naw, I know sey non of una wey I prish God kingdom give, go si mi again.
25 E, agora, na verdade, sei que todos vós, por quem passei pregando o Reino de Deus, não vereis mais o meu rosto.
26 So, I won tell una naw sey, nobody blood dey for my head.
26 Portanto, no dia de hoje, vos protesto que estou limpo do sangue de todos;
27 Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.
27 porque nunca deixei de vos anunciar todo o conselho de Deus.
28 Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
28 Olhai, pois, por vós e por todo o rebanho sobre que o Espírito Santo vos constituiu bispos, para apascentardes a igreja de Deus, que ele resgatou com seu próprio sangue.
29 I know sey afta I don go, wiked pipol with bad mind go kom join una and dis pipol nor go sorry for di ship.
29 Porque eu sei isto: que, depois da minha partida, entrarão no meio de vós lobos cruéis, que não perdoarão o rebanho.
30 Even among una, some men go stand dey tish lie-lie tins kon draw pipol follow body.
30 E que, dentre vós mesmos, se levantarão homens que falarão coisas perversas, para atraírem os discípulos após si.
31 So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.
31 Portanto, vigiai, lembrando-vos de que, durante três anos, não cessei, noite e dia, de admoestar, com lágrimas, a cada um de vós.
32 Naw, I leave una for God hand, so make en word wey get grace, keep una. Dis word wey get grace fit make una grow and get share with all God pipol.
32 Agora, pois, irmãos, encomendo-vos a Deus e à palavra da sua graça; a ele, que é poderoso para vos edificar e dar herança entre todos os santificados.
33 Since una know mi, I nor put eye for anybody gold, silva or koat.
33 De ninguém cobicei a prata, nem o ouro, nem a veste.
34 Una know sey na dis my hand I take dey work and get evritin wey I wont and even dey help pipol wey dey with mi.
34 Vós mesmos sabeis que, para o que me era necessário, a mim e aos que estão comigo, estas mãos me serviram.
35 Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
35 Tenho-vos mostrado em tudo que, trabalhando assim, é necessário auxiliar os enfermos e recordar as palavras do Senhor Jesus, que disse: Mais bem-aventurada coisa é dar do que receber.
36 Wen e tok all dis tins finish, e knee down with all of dem kon pray.
36 E, havendo dito isto, pôs-se de joelhos e orou com todos eles.
37 All of dem start to kry, as dem draw Paul near body kon dey kiss am.
37 E levantou-se um grande pranto entre todos e, lançando-se ao pescoço de Paulo, o beijavam,
38 Wetin Paul tok, make dem weak, bikos e sey, “Una nor go si mi again.” So dem follow am go rish where di ship dey.
38 entristecendo-se muito, principalmente pela palavra que dissera, que não veriam mais o seu rosto. E acompanharam-no até ao navio.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.