Atos 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples
1 Enquanto Apolo estava em Corinto, Paulo viajou pelas regiões do interior até chegar a Éfeso, no litoral, onde encontrou alguns discípulos.
2 kon ask dem, “Una don receive di Holy Spirit, since una don bilive Christ?” Dem ansa, “No! Wi neva even hear sey Holy Spirit dey.”
2 Ele lhes perguntou: “Vocês receberam o Espírito Santo quando creram?”. “Não”, responderam eles. “Nem sequer ouvimos que existe o Espírito Santo.”
3 Paul ask dem, “Na how dem kon take baptize una?” Dem ansa, “Na John baptizim.”
3 “Então que batismo vocês receberam?”, perguntou ele. “O batismo de João”, responderam.
4 Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”
4 Paulo disse: “João batizava com o batismo de arrependimento, dizendo ao povo que cresse naquele que viria depois, isto é, em Jesus”.
5 Wen dem hear wetin Paul tok, dem kon baptize dem with Jesus Christ name
5 Assim que ouviram isso, foram batizados em nome do Senhor Jesus.
6 and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.
6 Paulo lhes impôs as mãos e o Espírito Santo veio sobre eles, e falaram em línguas e profetizaram.
7 (Na twelf disciples Paul follow tok.)
7 Eram ao todo uns doze homens.
8 So Paul enter di sinagog kon dey tok with boldness for three monts. E dey show di pipol how dem go take bilive God Kingdom.
8 Em seguida, Paulo foi à sinagoga e ali pregou corajosamente durante três meses, argumentando de modo convincente sobre o reino de Deus.
9 But wen some sturbon pipol nor gri bilive, dem kon dey spoil Jesus Christ name for all di pipol front, so Paul with en disciples kon leave dem. Paul dey take en disciples follow body evriday, go tish for Tirannus Hall.
9 Mas alguns deles se mostraram endurecidos, rejeitaram a mensagem e falaram publicamente contra o Caminho. Paulo, então, deixou a sinagoga e levou consigo os discípulos, passando a realizar discussões diárias na escola de Tirano.
10 Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
10 Isso continuou durante os dois anos seguintes, e gente de toda a província da Ásia, tanto judeus como gregos, ouviu a palavra do Senhor.
11 Dat time, God use Paul dey do many wonderful mirakles,
11 Deus concedeu a Paulo o poder de realizar milagres extraordinários.
12 even handkachief and klot wey dem take tosh Paul body, dey heal sick pipol and drive evil spirit from pipol body, wen dem use am tosh dem.
12 Quando lenços ou aventais usados por ele eram colocados sobre enfermos, estes eram curados de suas doenças e deles saíam espíritos malignos.
13 But some Jew wey dey waka about kon try to koll Jesus Christ name for pipol wey evil spirit dey disturb dey sey, “I kommand yu with Jesus Christ name wey Paul dey prish.”
13 Alguns judeus viajavam pelas cidades expulsando espíritos malignos. Tentavam usar o nome do Senhor Jesus, dizendo: “Ordeno que saia em nome de Jesus, a quem Paulo anuncia!”.
14 (So, Skeva wey bi Jew priest, get seven sons wey dey do dis kind tin.)
14 Os homens que faziam isso eram os sete filhos de Ceva, um dos principais sacerdotes.
15 But di evil spirit ansa dem, “Yes! I know who Jesus Christ bi, I still know Paul too, but who una bi?”
15 Certa ocasião, o espírito maligno respondeu: “Eu conheço Jesus e conheço Paulo, mas quem são vocês?”.
16 Naim di man wey di evil spirit dey inside en body kon jump for dia body beat dem well-well, until dem start to beg. E beat dem till dem run komot from di house with nakednes and all dia body full with sore.
16 O homem possuído pelo espírito maligno saltou em cima deles e os atacou com tanta violência que fugiram da casa, despidos e feridos.
17 Wen evribody wey dey stay Efesus, both Jew and Greek, hear di story, fear katch dem and Jesus Christ name kon dey reign.
17 A notícia do ocorrido se espalhou rapidamente por toda a cidade de Éfeso, tanto entre judeus como entre gregos, e sobre eles veio um temor reverente, e o nome do Senhor Jesus era engrandecido.
18 Pipol wey nor bilive, kom out kon dey konfess all di bad tins wey dem dey do.
18 Muitos dos que creram confessaram suas obras pecaminosas.
19 Some wey dey do majik, bring all dia book kon burn dem to ashes for evribody front. Wen dem add di prize for all di book, e rish 50,000 silva koins.
19 Vários deles, que haviam praticado feitiçaria, trouxeram seus livros de encantamentos e os queimaram publicamente. O valor dos livros totalizou cinquenta mil moedas de prata.
20 So God word kon dey grow more-more and dem kon dey win many souls.
20 Assim, a mensagem a respeito do Senhor se espalhou amplamente e teve efeito poderoso.
21 Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”
21 Depois disso, Paulo se sentiu impelido pelo Espírito a passar pela Macedônia e a Acaia antes de ir a Jerusalém. “E, de lá, devo prosseguir para Roma!”, disse ele.
22 So, afta e send two men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon still stay Asia small.
22 Então, enviou adiante dele à Macedônia dois assistentes, Timóteo e Erasto, e permaneceu um pouco mais na província da Ásia.
23 Dat time sirious wahala happen bikos of “Christ Way” wey dem dey prish.
23 Por essa época, houve enorme tumulto em Éfeso por causa do Caminho.
24 E get one man, en name na Demetrius and e dey mold silva image. Na dis man mold Artemis shrine and dey help pipol wey dey mold, make plenty money.
24 Começou com Demétrio, ourives que fabricava modelos de prata do templo da deusa grega Ártemis e que empregava muitos artífices.
25 Di man kon gada all di pipol wey dey mold, with oda men wey dey do dat kind work, den e tell dem, “My pipol, una know sey na dis business wi take dey chop.
25 Ele os reuniu a outros que trabalhavam em ofícios semelhantes e disse: “Senhores, vocês sabem que nossa prosperidade vem deste empreendimento.
26 And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all.
26 Mas, como vocês viram e ouviram, esse sujeito, Paulo, convenceu muita gente de que deuses feitos por mãos humanas não são deuses de verdade. Fez isso não apenas aqui em Éfeso, mas em toda a província.
27 So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”
27 Claro que não me refiro apenas à perda do respeito público por nossa atividade. Também me preocupa que o templo da grande deusa Ártemis perca sua influência e que esta deusa magnífica, adorada em toda a província da Ásia e ao redor do mundo, seja destituída de seu grande prestígio!”.
28 Wen di pipol hear dis tins, dem vex well-well kon start to shaut, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!”
28 Ao ouvir isso, ficaram furiosos e começaram a gritar: “Grande é Ártemis dos efésios!”.
29 Di whole town kon dey shake with nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey escort Paul.
29 Em pouco tempo, a cidade toda estava uma confusão. O povo correu para o anfiteatro, arrastando os macedônios Gaio e Aristarco, companheiros de viagem de Paulo.
30 But wen Paul one enter di stadium, di disciples nor allow am.
30 Ele também quis entrar, mas os discípulos não permitiram.
31 Even some for di oga dem wey bi en friend, send message go meet am sey, make e nor enter di stadium.
31 Alguns amigos de Paulo, oficiais da província, também lhe enviaram um recado no qual suplicaram que não arriscasse a vida entrando no anfiteatro.
32 Na so all di pipol dey shaut anyhow and konfushon kon full evriwhere, many pipol wey gada dey shaut, nor even know why dem gada.
32 Lá dentro, em polvorosa, o povo todo gritava, e cada um dizia uma coisa. Na verdade, a maioria nem sabia por que estava ali.
33 Some pipol sey na about Alexanda, bikos di Jew pipol don push am go front. Alexanda wave en hand kon sey, make dem kwayet, make e for fit tok to defend di Jew pipol.
33 Entre a multidão, os judeus empurraram Alexandre para a frente e ordenaram que explicasse a situação. Ele fez sinal pedindo silêncio e tentou falar.
34 But wen dem si sey na Jew e bi, dem kon start to shaut again, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!” Dem shaut like dis rish two hours.
34 No entanto, quando a multidão percebeu que ele era judeu, começou a gritar novamente e continuou por cerca de duas horas: “Grande é Ártemis dos efésios!”.
35 “Afta di town sekretary don make di pipol kwayet, e kon sey, My pipol wey dey Efesus, wish pesin dey among una wey nor know sey na Artemis bi Efesus god wey fall from heaven?
35 Por fim, o escrivão da cidade conseguiu acalmar a multidão e disse: “Cidadãos de Éfeso, todos sabem que Éfeso é a guardiã do templo da grande Ártemis, cuja imagem caiu do céu para nós.
36 So bikos nobody fit argue dis matter, make una kwayet and make una nor do anytin wey nor get head.
36 Portanto, sendo este um fato inegável, acalmem-se e não façam nada precipitadamente.
37 Una don bring dis men kom here, nor bi bikos dem spoil di temple or curse awa goddes.
37 Vocês trouxeram estes homens aqui, mas eles não roubaram nada do templo nem disseram coisa alguma contra nossa deusa.
38 If Demetrius and di pipol wey dey with am get any komplain against anybody, kourt dey and judge dem dey der too. So make dem take dia kase go der.
38 “Se Demétrio e seus artífices têm alguma queixa contra eles, os tribunais estão abertos e há oficiais disponíveis para ouvir o caso. Que façam acusações formais.
39 But if una wont anytin wey pass dis one, na kourt dem go for setol am.
39 E, se há outras queixas que desejam apresentar, elas podem ser resolvidas em assembleia, conforme a lei.
40 Bikos dem fit take all of us go kourt today sey wi dey rayot, bikos wi nor get any rizin for dis konfushon wey dey happen so.”
40 Corremos o perigo de ser acusados de provocar desordem, pois não há motivo para este tumulto. E, se exigirem de nós uma explicação, não teremos o que dizer”.
41 Afta e tok finish, e kon sey make evribody go dia house.
41 Então os despediu, e a multidão se dispersou.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.