Atos 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Afta dis tins, Paul komot from Atens go Korint.
1 Depois disso Paulo saiu de Atenas e foi para Corinto.
2 For der, e kon si one Jew wey dem dey koll Akwila, wey kom from Pontus and e just kom back from Italy with en wife Priscilla, bikos Klaudius orda sey make all Jew pipol komot from Rome. Paul go meet dem
2 Ali, encontrou um judeu chamado Áqüila, natural do Ponto, que havia chegado recentemente da Itália com Priscila, sua mulher, pois Cláudio havia ordenado que todos os judeus saíssem de Roma. Paulo foi vê-los
3 and bikos dem dey do di same work, e kon stay with dem dey follow dem work (na tent dem dey make sell).
3 e, uma vez que tinham a mesma profissão, ficou morando e trabalhando com eles, pois eram fabricantes de tendas.
4 E dey tok to both Jew and Greek pipol for di sinagog evry Sabat Day, so dat dem go bilive.
4 Todos os sábados ele debatia na sinagoga, e convencia judeus e gregos.
5 Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ.
5 Depois que Silas e Timóteo chegaram da Macedônia, Paulo se dedicou exclusivamente à pregação, testemunhando aos judeus que Jesus era o Cristo.
6 Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”
6 Opondo-se eles e lançando maldições, Paulo sacudiu a roupa e lhes disse: "Caia sobre a cabeça de vocês o seu próprio sangue! Estou livre da minha responsabilidade. De agora em diante irei para os gentios".
7 Den Paul komot for di sinagog go Titus Justus house; di man na Gentile wey dey woship God and en house dey near di sinagog.
7 Então Paulo saiu da sinagoga e foi para a casa de Tício Justo, que era temente a Deus e que morava ao lado da sinagoga.
8 Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.
8 Crispo, chefe da sinagoga, creu no Senhor, ele e toda a sua casa; e dos coríntios que o ouviam, muitos criam e eram batizados.
9 Jesus kon tell Paul for vishon for nite, “Make yu nor kwayet bikos of fear, but make yu open yor mout dey tok,
9 Certa noite o Senhor falou a Paulo em visão: "Não tenha medo, continue falando e não fique calado,
10 I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”
10 pois estou com você, e ninguém vai lhe fazer mal ou feri-lo, porque tenho muita gente nesta cidade".
11 So Paul stay der for one year and six monts dey tish di pipol God word.
11 Assim, Paulo ficou ali durante um ano e meio, ensinando-lhes a palavra de Deus.
12 Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat.
12 Sendo Gálio procônsul da Acaia, os judeus fizeram em conjunto um levante contra Paulo e o levaram ao tribunal, fazendo a seguinte acusação:
13 Dem sey, “Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!”
13 "Este homem está persuadindo o povo a adorar a Deus de maneira contrária à lei".
14 But just as Paul won start to tok, Gallio kon tell di Jew pipol sey, “If na bikos of one offence or sirious wayo, I for listin to una komplain,
14 Quando Paulo ia começar a falar, Gálio disse aos judeus: "Se vocês, judeus, estivessem apresentando queixa de algum delito ou crime grave, seria razoável que eu os ouvisse.
15 but since na matter about word, name and una own law, make una go setol am by unasef. I nor go judge all doz kind tins!”
15 Mas, visto que se trata de uma questão de palavras e nomes de sua própria lei, resolvam o problema vocês mesmos. Não serei juiz dessas coisas".
16 So e drive dem komot from di judgement seat.
16 E mandou expulsá-los do tribunal.
17 Dem kon seize Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di judgement seat front. But Gallio do like sey all dis tins nor koncern am.
17 Então todos se voltaram contra Sóstenes, o chefe da sinagoga, e o espancaram diante do tribunal. Mas Gálio não demonstrava nenhuma preocupação com isso.
18 Afta Paul don stay many days for Korint, e kon tell all di brodas bye-bye, den e enter ship go Siria, but Priscilla and Akwila follow am go. For Cenchrea, e kon kut en hair bikos e make vow.
18 Paulo permaneceu em Corinto por algum tempo. Depois despediu-se dos irmãos e navegou para a Síria, acompanhado de Priscila e Áqüila. Antes de embarcar, rapou a cabeça em Cencréia, devido a um voto que havia feito.
19 Wen dem rish Efesus, Paul leave Priscilla and Akwila for der, but en ensef enter di sinagog go follow di Jew pipol tok.
19 Chegaram a Éfeso, onde Paulo deixou Priscila e Áqüila. Ele, porém, entrando na sinagoga, começou a debater com os judeus.
20 Wen dem sey make e stay with dem small, e nor gri,
20 Pedindo eles que ficasse mais tempo, não cedeu.
21 but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus
21 Mas, ao partir, prometeu: "Voltarei, se for da vontade de Deus". Então, embarcando, partiu de Éfeso.
22 and wen e rish, Caesaria pass go Jerusalem go salot di pipol for di church wey dey der, before e go Antiok.
22 Ao chegar a Cesaréia, subiu até a igreja para saudá-la, e depois desceu para Antioquia.
23 Afta e don stay small for der, Paul komot kon travel pass all di aria wey dey Galatian and Frigia, dey enkourage all di disciples.
23 Depois de passar algum tempo em Antioquia, Paulo partiu dali e viajou por toda a região da Galácia e da Frígia, fortalecendo todos os discípulos.
24 E get one Jew man, en name na Apollos and e from Alexandria go Efesus. Apollos sabi tok and e know di Bible well-well.
24 Enquanto isso, um judeu chamado Apolo, natural de Alexandria, chegou a Éfeso. Ele era homem culto e tinha grande conhecimento das Escrituras.
25 Dem don tish am about Jesus and na with high spirit e take dey tok and tish about Jesus Christ, but na only John baptizim e know rish.
25 Fora instruído no caminho do Senhor e com grande fervor falava e ensinava com exatidão acerca de Jesus, embora conhecesse apenas o batismo de João.
26 E kon dey tok with boldness for di sinagog, but wen Priscilla and Akwila hear am dey tok, dem koll am go korna kon esplain God word gi-am well-well.
26 Logo começou a falar corajosamente na sinagoga. Quando Priscila e Áqüila o ouviram, convidaram-no para ir à sua casa e lhe explicaram com mais exatidão o caminho de Deus.
27 Wen Apollos one cross go Akaia, di brodas enkourage am kon gi-am leta make e give di disciples, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivers,
27 Querendo ele ir para a Acaia, os irmãos o encorajaram e escreveram aos discípulos que o recebessem. Ao chegar, ele auxiliou muito os que pela graça haviam crido,
28 bikos e nor gri with wetin di Jew pipol dey tok for publik and e show dem from di Bible sey na Jesus Christ, bi di Mezaya. Paul Third Journey|alt="Paul's Third Journey" src="PCM_GPS_Paul3_B&WFlat.indd" size="span" loc="ACT 18:23–21:16" copy="SIL" ref="18:23–21:16"
28 pois refutava vigorosamente os judeus em debate público, provando pelas Escrituras que Jesus é o Cristo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.