Atos 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Afta dem pass Amfipolis and Apollonia, dem kon rish Tesalonika where one Jew sinagog dey.
1 E passando por Anfípolis e Apolônia, chegaram a Tessalônica, onde havia uma sinagoga de judeus.
2 Paul go meet di Jew pipol for di sinagog as e dey do before and for three Sabat Day, e kon dey tish dem God word,
2 E Paulo, como tinha por costume, foi ter com eles; e por três sábados disputou com eles sobre as Escrituras,
3 dey show dem how God word sey Christ must sofa and e go raiz from grave. E tell dem, “Dis Jesus wey I dey tell una about so, naim bi di Christ.”
3 Expondo e demonstrando que convinha que o Cristo padecesse e ressuscitasse dentre os mortos. E este Jesus, que vos anuncio, dizia ele, é o Cristo.
4 Some among dem wey bilive kon join Paul and Silas and many Greek pipol wey dey fear God and some big-big wimen, join dem too.
4 E alguns deles creram, e ajuntaram-se com Paulo e Silas; e também uma grande multidão de gregos religiosos, e não poucas mulheres principais.
5 But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.
5 Mas os judeus desobedientes, movidos de inveja, tomaram consigo alguns homens perversos, dentre os vadios e, ajuntando o povo, alvoroçaram a cidade, e assaltando a casa de Jasom, procuravam trazê-los para junto do povo.
6 Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and some for en brodas go meet di town oga, dey shaut, “All dis pipol wey don start wahala for di world, don rish here too
6 E, não os achando, trouxeram Jasom e alguns irmãos à presença dos magistrados da cidade, clamando: Estes que têm alvoroçado o mundo, chegaram também aqui;
7 and Jason put dem for en house like visitor! Dem dey do wetin dey against Caesar law, dey tok sey anoda king dey wey en name bi Jesus Christ!”
7 Os quais Jasom recolheu; e todos estes procedem contra os decretos de César, dizendo que há outro rei, Jesus.
8 Dem kause konfushon among di pipol wey gada and di town oga dem wey hear all dis tins.
8 E alvoroçaram a multidão e os principais da cidade, que ouviram estas coisas.
9 Afta di oga dem don kollect money from Jason and di brodas, dem kon allow dem go.
9 Tendo, porém, recebido satisfação de Jasom e dos demais, os soltaram.
10 At wons, di brodas send Paul and Silas go Berea for nite. Wen dem don rish der, dem kon go di Jew sinagog.
10 E logo os irmãos enviaram de noite Paulo e Silas a Beréia; e eles, chegando lá, foram à sinagoga dos judeus.
11 Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.
11 Ora, estes foram mais nobres do que os que estavam em Tessalônica, porque de bom grado receberam a palavra, examinando cada dia nas Escrituras se estas coisas eram assim.
12 Na so many of dem take bilive, even with some big-big men and wimen wey bi Greek.
12 De sorte que creram muitos deles, e também mulheres gregas da classe nobre, e não poucos homens.
13 But wen di Jew pipol wey dey for Tesalonika hear sey Paul don rish Berea dey prish God word, dem kon go der go kause wahala and spoil di pipol mind.
13 Mas, logo que os judeus de Tessalônica souberam que a palavra de Deus também era anunciada por Paulo em Beréia, foram lá, e excitaram as multidões.
14 Naim di brodas send Paul go di wotaside, but Silas and Timoti still stay for Berea.
14 No mesmo instante os irmãos mandaram a Paulo que fosse até ao mar, mas Silas e Timóteo ficaram ali.
15 Di pipol wey follow Paul, escort am go rish Atens and afta, e orda dem sey make Silas and Timoti kom meet am kwik-kwik for der, so dem kon go back.
15 E os que acompanhavam Paulo o levaram até Atenas, e, recebendo ordem para que Silas e Timóteo fossem ter com ele o mais depressa possível, partiram.
16 As Paul dey Atens dey wait for dem, e kon dey vex for en spirit, bikos e si sey na so-so juju full di town.
16 E, enquanto Paulo os esperava em Atenas, o seu espírito se comovia em si mesmo, vendo a cidade tão entregue à idolatria.
17 So e tok to di Jew and Gentile pipol wey dey fear God wey dey inside di sinagog and e still tok to evribody wey dey di market.
17 De sorte que disputava na sinagoga com os judeus e religiosos, e todos os dias na praça com os que se apresentavam.
18 So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.)
18 E alguns dos filósofos epicureus e estóicos contendiam com ele; e uns diziam: Que quer dizer este paroleiro? E outros: Parece que é pregador de deuses estranhos; porque lhes anunciava a Jesus e a ressurreição.
19 So dem take Paul go Areopagus kon tell am, “Wi beg, make yu tell us about dis new tin wey yu dey tish so?
19 E tomando-o, o levaram ao Areópago, dizendo: Poderemos nós saber que nova doutrina é essa de que falas?
20 Bikos di tins wey yu dey tok, wi neva hear am before and wi like to know wetin dem mean.”
20 Pois coisas estranhas nos trazes aos ouvidos; queremos pois saber o que vem a ser isto
21 (Atens pipol and odas wey dey der, nor get any oda work pass make dem sidan dey tok story about any new tin wey dey happen.)
21 (Pois todos os atenienses e estrangeiros residentes, de nenhuma outra coisa se ocupavam, senão de dizer e ouvir alguma novidade).
22 So Paul stand for Areopagus front kon sey, “My pipol wey dey for Atens, I si sey una like God matter well-well.
22 E, estando Paulo no meio do Areópago, disse: Homens atenienses, em tudo vos vejo um tanto supersticiosos;
23 Bikos as I waka round dey look all di tins wey una dey woship, I even si one shrine wey dem rite put sey: ‘To di god wey pipol nor know.’ So wetin una dey woship wey una nor know, naim I kon tell una about today.
23 Porque, passando eu e vendo os vossos santuários, achei também um altar em que estava escrito: AO DEUS DESCONHECIDO. Esse, pois, que vós honrais, não o conhecendo, é o que eu vos anuncio.
24 God wey make di world and evritin wey dey inside, wey bi di Oga God for heaven and eart, nor dey stay inside house wey human being build
24 O Deus que fez o mundo e tudo que nele há, sendo Senhor do céu e da terra, não habita em templos feitos por mãos de homens;
25 and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath.
25 Nem tampouco é servido por mãos de homens, como que necessitando de alguma coisa; pois ele mesmo é quem dá a todos a vida, e a respiração, e todas as coisas;
26 Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,
26 E de um só sangue fez toda a geração dos homens, para habitar sobre toda a face da terra, determinando os tempos já dantes ordenados, e os limites da sua habitação;
27 so dat as dem dey look for God, dem go si am, even doh E nor dey far from all of us.
27 Para que buscassem ao Senhor, se porventura, tateando, o pudessem achar; ainda que não está longe de cada um de nós;
28 Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’
28 Porque nele vivemos, e nos movemos, e existimos; como também alguns dos vossos poetas disseram: Pois somos também sua geração.
29 So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make.
29 Sendo nós, pois, geração de Deus, não havemos de cuidar que a divindade seja semelhante ao ouro, ou à prata, ou à pedra esculpida por artifício e imaginação dos homens.
30 God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am,
30 Mas Deus, não tendo em conta os tempos da ignorância, anuncia agora a todos os homens, e em todo o lugar, que se arrependam;
31 bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”
31 Porquanto tem determinado um dia em que com justiça há de julgar o mundo, por meio do homem que destinou; e disso deu certeza a todos, ressuscitando-o dentre os mortos.
32 Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, some kon dey laf, but odas sey, “Yu go tell us dis matter again.”
32 E, como ouviram falar da ressurreição dos mortos, uns escarneciam, e outros diziam: Acerca disso te ouviremos outra vez.
33 So Paul kon komot from Areopagus.
33 E assim Paulo saiu do meio deles.
34 But some pipol wey bilive Christ kon join am. Inside dis pipol wey bilive so, na Dionysius wey bi memba for Areopagus and one woman wey dem dey koll Damaris, with oda pipol wey join dem.
34 Todavia, chegando alguns homens a ele, creram; entre os quais foi Dionísio, areopagita, uma mulher por nome Dâmaris, e com eles outros.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.