Atos 16

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Paul kon still go Derbe and Lystra. One disciple wey dem dey koll Timoti dey der. En mama na Jew wey bilive Christ, but en papa, na Greek.
1 Chegou também a Derbe e Listra. E eis que estava ali certo discípulo por nome Timóteo, filho de uma judia crente, mas de pai grego;
2 Di brodas wey dey Lystra and Ikonium dey tok good about am.
2 do qual davam bom testemunho os irmãos em Listra e Icônio.
3 Paul wont make Timoti follow am, so e sekonsaiz am, bikos di Jew pipol wey dey for di aria, know sey en papa na Greek.
3 Paulo quis que este fosse com ele e, tomando-o, o circuncidou por causa dos judeus que estavam naqueles lugares; porque todos sabiam que seu pai era grego.
4 As dem dey go from town to town, dem kon dey pass di message wey di apostles and eldas for Jerusalem send to all di Gentile pipol wey bilive Christ sey, make dem obey.
4 Quando iam passando pelas cidades, entregavam aos irmãos, para serem observadas, as decisões que haviam sido tomadas pelos apóstolos e anciãos em Jerusalém.
5 So di pipol for di church dey strong more-more for faith and dem kon dey plenty evriday.
5 Assim as igrejas eram confirmadas na fé, e dia a dia cresciam em número.
6 Dem pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia.
6 Atravessaram a região frígio-gálata, tendo sido impedidos pelo Espírito Santo de anunciar a palavra na Ásia;
7 Wen dem rish Mysia, dem kon try to enter inside Bitynia, but Jesus Christ Spirit nor allow dem enter,
7 e tendo chegado diante da Mísia, tentavam ir para Bitínia, mas o Espírito de Jesus não lho permitiu.
8 naim dem pass thru Mysia kon face Troas.
8 Então, passando pela Mísia, desceram a Trôade.
9 Paul si dis vishon for nite: One man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, “Make yu kom help us for Masidonia!”
9 De noite apareceu a Paulo esta visão: estava ali em pé um homem da Macedônia, que lhe rogava: Passa à Macedônia e ajuda-nos.
10 Wen Paul si dis vishon finish, wi kon try to go Masidonia. Wi kon bilive sey God don koll us make wi go prish di Good News to di pipol wey dey der.
10 E quando ele teve esta visão, procurávamos logo partir para a Macedônia, concluindo que Deus nos havia chamado para lhes anunciarmos o evangelho.
11 Wi travel for wota from Troas and awa ship kon from der go Samotrace and di next day, wi go Neapolis
11 Navegando, pois, de Trôade, fomos em direitura a Samotrácia, e no dia seguinte a Neápolis;
12 and from der, to Filippi wey bi nomba one town for Masidonia, wey Rome dey rule. Wi stay for dis town for some days.
12 e dali para Filipos, que é a primeira cidade desse distrito da Macedônia, e colônia romana; e estivemos alguns dias nessa cidade.
13 Wen Sabat Day rish, wi komot from di town go di wotaside, where wi tink sey wi go si where dem for dey pray, naim wi sidan kon start to dey tok to di wimen wey gada for der.
13 No sábado saímos portas afora para a beira do rio, onde julgávamos haver um lugar de oração e, sentados, falávamos às mulheres ali reunidas.
14 E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.
14 E certa mulher chamada Lídia, vendedora de púrpura, da cidade de Tiatira, e que temia a Deus, nos escutava e o Senhor lhe abriu o coração para atender às coisas que Paulo dizia.
15 Afta en and en family don baptize, e kon beg us sey, “If una don asept mi as pesin wey bilive Christ, make una kon stay for my house.” So e beg us until wi gri.
15 Depois que foi batizada, ela e a sua casa, rogou-nos, dizendo: Se haveis julgado que eu sou fiel ao Senhor, entrai em minha casa, e ficai ali. E nos constrangeu a isso.
16 One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.
16 Ora, aconteceu que quando íamos ao lugar de oração, nos veio ao encontro uma jovem que tinha um espírito adivinhador, e que, adivinhando, dava grande lucro a seus senhores.
17 Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey, “Dis pipol na God savants o-o, dem dey prish to una about how una go take save.”
17 Ela, seguindo a Paulo e a nós, clamava, dizendo: São servos do Deus Altíssimo estes homens que vos anunciam um caminho de salvação.
18 E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.
18 E fazia isto por muitos dias. Mas Paulo, perturbado, voltou-se e disse ao espírito: Eu te ordeno em nome de Jesus Cristo que saias dela. E na mesma hora saiu.
19 But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.
19 Ora, vendo seus senhores que a esperança do seu lucro havia desaparecido, prenderam a Paulo e Silas, e os arrastaram para uma praça à presença dos magistrados.
20 Den dem drag dem go meet di judge dem kon sey, “All dis men dey kause wahala for dis town. Dem bi Jew
20 E, apresentando-os aos magistrados, disseram: Estes homens, sendo judeus, estão perturbando muito a nossa cidade,
21 and dem dey tish law wey nor bi awa own, since wi bi Rome pipol.”
21 e pregam costumes que não nos é lícito receber nem praticar, sendo nós romanos.
22 All di pipol wey gada for der kon join put mout against dem and di judge dem kon give orda sey, make dem remove Paul and Silas klot komot for dia body and flog dem with heavy stik.
22 A multidão levantou-se à uma contra eles, e os magistrados, rasgando-lhes os vestidos, mandaram açoitá-los com varas.
23 Afta dem don flog dem well-well, dem put dem for prison kon tell di warda make e guide dem well-well.
23 E, havendo-lhes dado muitos açoites, os lançaram na prisão, mandando ao carcereiro que os guardasse com segurança.
24 Bikos of dis strong orda, di warda put dem for inside-inside di prison kon hook dia leg with big-big shains.
24 Ele, tendo recebido tal ordem, os lançou na prisão interior e lhes segurou os pés no tronco.
25 Wen mid-nite rish, Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem.
25 Pela meia-noite Paulo e Silas oravam e cantavam hinos a Deus, enquanto os presos os escutavam.
26 At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too. Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison, kon luz.
26 De repente houve um tão grande terremoto que foram abalados os alicerces do cárcere, e logo se abriram todas as portas e foram soltos os grilhões de todos.
27 Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run.
27 Ora, o carcereiro, tendo acordado e vendo abertas as portas da prisão, tirou a espada e ia suicidar-se, supondo que os presos tivessem fugido.
28 But Paul shaut, “Make yu nor kill yorsef, all of us still dey for here!”
28 Mas Paulo bradou em alta voz, dizendo: Não te faças nenhum mal, porque todos aqui estamos.
29 Naim di warda sey make dem bring lite and e rush enter inside di prison kon fall for Paul and Silas front dey shake.
29 Tendo ele pedido luz, saltou dentro e, todo trêmulo, se prostrou ante Paulo e Silas
30 E bring dem kom outside kon ask, “My oga dem, wetin I go do to dey save?”
30 e, tirando-os para fora, disse: Senhores, que me é necessário fazer para me salvar?
31 Dem ansa am, “Bilive Jesus Christ and yu go save, both yu and all yor family.”
31 Responderam eles: Crê no Senhor Jesus e serás salvo, tu e tua casa.
32 Den, dem prish God word give en and all di pipol wey dey en house.
32 Então lhe pregaram a palavra de Deus, e a todos os que estavam em sua casa.
33 Dat nite, di warda kon wosh all dia sore; den en and en family kon baptize.
33 Tomando-os ele consigo naquela mesma hora da noite, lavou-lhes as feridas; e logo foi batizado, ele e todos os seus.
34 Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God.
34 Então os fez subir para sua casa, pôs-lhes a mesa e alegrou-se muito com toda a sua casa, por ter crido em Deus.
35 Wen day break, di judge dem kon send sojas sey, “Make una go release doz men.”
35 Quando amanheceu, os magistrados mandaram quadrilheiros a dizer: Soltai aqueles homens.
36 Di warda tell Paul, “Di judge dem don give orda sey make wi free una. So make una kon dey go.”
36 E o carcereiro transmitiu a Paulo estas palavras, dizendo: Os magistrados mandaram que fosseis soltos; agora, pois, saí e ide em paz.
37 But Paul tell di sojas, “Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase, even doh sey wi bi Rome pipol, dem still trow us for prison. Naw, dem won free us from back make pipol nor for know? Wi nor gri! Make dem kom here by demsef kon release us!”
37 Mas Paulo respondeu-lhes: Açoitaram-nos publicamente sem sermos condenados, sendo cidadãos romanos, e nos lançaram na prisão, e agora encobertamente nos lançam fora? De modo nenhum será assim; mas venham eles mesmos e nos tirem.
38 Di sojas kon ripot wetin Paul tok give di judge dem. Fear katch dem wen dem hear sey Paul and Silas na Rome pipol,
38 E os quadrilheiros foram dizer aos magistrados estas palavras, e estes temeram quando ouviram que eles eram romanos;
39 so dem kon beg dem sey make dem nor vex. Afta dem bring dem kom out, dem kon beg dem well-well sey make dem leave di town.
39 vieram, pediram-lhes desculpas e, tirando-os para fora, rogavam que se retirassem da cidade.
40 Wen dem don komot for prison, dem enter Lydia house and wen dem si di brodas, dem enkourage dem before dem leave di town.Paul and Silas dey sing for prison|alt="Paul and Silas in jail" src="lb00337c.tif" size="col" copy="LB" ref="16:40"
40 Então eles saíram da prisão, entraram em casa de Lídia, e, vendo os irmãos, os confortaram, e partiram.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.