Atos 15

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”
1 Então alguns que tinham descido da Judéia ensinavam aos irmãos: Se não vos circuncidardes, segundo o rito de Moisés, não podeis ser salvos.
2 Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter.
2 Tendo Paulo e Barnabé contenda e não pequena discussão com eles, os irmãos resolveram que Paulo e Barnabé e mais alguns dentre eles subissem a Jerusalém, aos apóstolos e aos anciãos, por causa desta questão.
3 So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.
3 Eles, pois, sendo acompanhados pela igreja por um trecho do caminho, passavam pela Fenícia e por Samária, contando a conversão dos gentios; e davam grande alegria a todos os irmãos.
4 Wen dem rish Jerusalem, di whole church with di apostles and di eldas kon welkom dem, den dem tell dem evritin wey God don use dem do.
4 E, quando chegaram a Jerusalém, foram recebidos pela igreja e pelos apóstolos e anciãos, e relataram tudo quanto Deus fizera por meio deles.
5 But some Farisee wey don bilive Christ stand up kon sey, “E good make wi tell Gentile pipol make dem sekonsaiz and do evritin wey Moses Law tok.”
5 Mas alguns da seita dos fariseus, que tinham crido, levantaram-se dizendo que era necessário circuncidá-los e mandar-lhes observar a lei de Moisés.
6 Di apostles and di eldas kon whole meetin to tok about di matter.
6 Congregaram-se pois os apóstolos e os anciãos para considerar este assunto.
7 Afta dem don argue well-well about di matter, Pita kon stand up sey, “My brodas, una know sey before-before, na mi God choose make e go prish give Gentile pipol make dem hear and bilive en word.
7 E, havendo grande discussão, levantou-se Pedro e disse-lhes: Irmãos, bem sabeis que já há muito tempo Deus me elegeu dentre vós, para que os gentios ouvissem da minha boca a palavra do evangelho e cressem.
8 And God, wey know wetin dey inside pipol mind, don show ensef to dem wen E give dem di Holy Spirit, just as E give us
8 E Deus, que conhece os corações, testemunhou a favor deles, dando-lhes o Espírito Santo, assim como a nós;
9 and E nor do wayo between wi and dem bikos, E make dia heart klean by faith.
9 e não fez distinção alguma entre eles e nós, purificando os seus corações pela fé.
10 So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?
10 Agora, pois, por que tentais a Deus, pondo sobre a cerviz dos discípulos um jugo que nem nossos pais nem nós pudemos suportar?
11 Wi bilive sey God save us thru grace wey kom from Jesus Christ, just as E do for dis Gentile pipol too.”
11 Mas cremos que somos salvos pela graça do Senhor Jesus, do mesmo modo que eles também.
12 Evribody wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Paul dey tok and dem tell dem about di mirakles and wonders wey God use dem do among Gentile pipol.
12 Então toda a multidão se calou e escutava a Barnabé e a Paulo, que contavam quantos sinais e prodígios Deus havia feito por meio deles entre os gentios.
13 Afta dem don tok finish, James ansa, “Awa brodas, make una hear wetin I won tok.
13 Depois que se calaram, Tiago, tomando a palavra, disse: Irmãos, ouvi-me:
14 Pita don tell us how God first choose some pipol from Gentile wey go dey tok about am.
14 Simão relatou como primeiramente Deus visitou os gentios para tomar dentre eles um povo para o seu Nome.
15 Dis tins gri with wetin di profets tok before sey:
15 E com isto concordam as palavras dos profetas; como está escrito:
16 “ ‘Afta all dis tins, I go kom back
16 Depois disto voltarei, e reedificarei o tabernáculo de Davi, que está caído; reedificarei as suas ruínas, e tornarei a levantá-lo;
17 so evribody go kom meet God,
17 para que o resto dos homens busque ao Senhor, sim, todos os gentios, sobre os quais é invocado o meu nome,
18 and E know sey na so e go bi.
18 diz o Senhor que faz estas coisas, que são conhecidas desde a antiguidade.
19 “So, I go sey make wi nor make tins hard for Gentile pipol wey just start to serve God,
19 Por isso, julgo que não se deve perturbar aqueles, dentre os gentios, que se convertem a Deus,
20 but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
20 mas escrever-lhes que se abstenham das contaminações dos ídolos, da prostituição, do que é sufocado e do sangue.
21 Bikos na since awa grand-grand papa dem time dem don dey prish Moses Law for di sinagog for evry Sabat Day.”
21 Porque Moisés, desde tempos antigos, tem em cada cidade homens que o preguem, e cada sábado é lido nas sinagogas.
22 So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas.
22 Então pareceu bem aos apóstolos e aos anciãos com toda a igreja escolher homens dentre eles e enviá-los a Antioquia com Paulo e Barnabé, a saber: Judas, chamado Barsabás, e Silas, homens influentes entre os irmãos.
23 Na wetin dem rite for di leta, bi dis,
23 E por intermédio deles escreveram o seguinte: Os apóstolos e os anciãos, irmãos, aos irmãos dentre os gentios em Antioquia, na Síria e na Cicília, saúde.
24 Wi hear sey some pipol kom meet una sey dem kom from us, even doh wi nor send dem. Dem dey konfuse and tell una wetin go disturb una mind.
24 Portanto ouvimos que alguns dentre nós, aos quais nada mandamos, vos têm perturbado com palavras, confundindo as vossas almas,
25 So all of us kon gri sey make wi choose pipol wey go follow Banabas and Paul, wey bi awa friend, kom meet una.
25 pareceu-nos bem, tendo chegado a um acordo, escolher alguns homens e enviá-los com os nossos amados Barnabé e Paulo,
26 Dis men dey risk dia life, bikos of awa Oga God Jesus Christ name.
26 homens que têm exposto as suas vidas pelo nome de nosso Senhor Jesus Cristo.
27 So wi send Judas and Silas wey go tell una all dis tins by demsef.
27 Enviamos portanto Judas e Silas, os quais também por palavra vos anunciarão as mesmas coisas.
28 Bikos wi and di Holy Spirit nor won put heavy load for una head, so na dis small advise wi dey give una:
28 Porque pareceu bem ao Espírito Santo e a nós não vos impor maior encargo além destas coisas necessárias:
29 ‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”
29 Que vos abstenhais das coisas sacrificadas aos ídolos, e do sangue, e da carne sufocada, e da prostituição; e destas coisas fareis bem de vos guardar. Bem vos vá.
30 So wen dem don send dem go, dem kon go Antiok and afta dem gada evribody, dem kon give dem di leta.
30 Então eles, tendo-se despedido, desceram a Antioquia e, havendo reunido a assembléia, entregaram a carta.
31 Bikos of wetin dem rite put for di leta, all di pipol happy wen dem read am out.
31 E, quando a leram, alegraram-se pela consolação.
32 But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong.
32 Depois Judas e Silas, que também eram profetas, exortaram os irmãos com muitas palavras e os fortaleceram.
33 Afta dem don stay der tey small, di brodas kon send dem back with peace to di pipol wey send dem kom.
33 E, tendo-se demorado ali por algum tempo, foram pelos irmãos despedidos em paz, de volta aos que os haviam mandado.
34 But Silas sey e go still stay der for sometaim.
34 {Mas pareceu bem a Silas ficar ali.}
35 Paul, Banabas and odas kon still stay for Antiok dey tish and prish God word.
35 Mas Paulo e Barnabé demoraram-se em Antioquia, ensinando e pregando com muitos outros a palavra do Senhor.
36 Afta some days, Paul kon tell Banabas, “Make wi go back go visit di brodas for all di town wey wi for prish God word, so dat wi go know how dem dey.”
36 Decorridos alguns dias, disse Paulo a Barnabé: Tornemos a visitar os irmãos por todas as cidades em que temos anunciado a palavra do Senhor, para ver como vão.
37 Banabas won kon karry John Mark follow body,
37 Ora, Barnabé queria que levassem também a João, chamado Marcos.
38 but Paul sey make dem nor karry am, bikos na so e take leave dem for Pamfilia before and e nor follow dem do di work.
38 Mas a Paulo não parecia razoável que tomassem consigo aquele que desde a Panfília se tinha apartado deles e não os tinha acompanhado no trabalho.
39 Dis matter kon kause sirious kworel, sotey dem kon separate. Banabas take Mark follow body and dem kon enter ship go Cyprus,
39 E houve entre eles tal desavença que se separaram um do outro, e Barnabé, levando consigo a Marcos, navegou para Chipre.
40 but Paul choose Silas and dem go meet di brodas and sistas kon pray make God bless dem.
40 Mas Paulo, tendo escolhido a Silas, partiu encomendado pelos irmãos à graça do Senhor.
41 Paul pass thru Siria and Silisia dey enkourage di pipol wey dey di church dem for der.Paul Sekond Journey|alt="Paul's Sekond Journey" src="PCM_GPS_Paul2_B&WFlat.indd" size="span" loc="ACT 15:36–18:22" copy="SIL" ref="15:36–18:22"
41 E passou pela Síria e Cilícia, fortalecendo as igrejas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.