Atos 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.
1 Havia então na Igreja de Antioquia profetas e doutores, entre eles Barnabé, Simão, apelidado o Negro, Lúcio de Cirene, Manaém, companheiro de infância do tetrarca Herodes, e Saulo.
2 As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.”
2 Enquanto celebravam o culto do Senhor, depois de terem jejuado, disse-lhes o Espírito Santo: Separai-me Barnabé e Saulo para a obra a que os tenho destinado.
3 Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Saul kon send dem go.
3 Então, jejuando e orando, impuseram-lhes as mãos e os despediram.
4 So Banabas and Saul wey di Holy Spirit send kon go Seleucia and from der, dem enter ship go Cyprus.
4 Enviados assim pelo Espírito Santo, foram a Selêucia e dali navegaram para a ilha de Chipre.
5 Wen dem rish Salamis, dem kon dey prish God word for di Jew sinagog, (John dey der dey help dem.)
5 Chegados a Salamina, pregavam a palavra de Deus nas sinagogas dos judeus. Tinham com eles João para auxiliá-los.
6 Wen dem don cross di whole Island go rish Pafos, dem kon si one magician wey bi Jew and na wayo profet. En name na Bar-Jesus,
6 Percorreram toda a ilha até Pafos e acharam um judeu chamado Barjesus, mago e falso profeta,
7 e dey with Sergius Paulus, one Roman offisa wey know book well-well. Di offisa invite Banabas and Saul kom en house, bikos e won hear God word.
7 que vivia na companhia do procônsul Sérgio Paulo, homem sensato. Este chamou Barnabé e Saulo, e exprimiu-lhes o desejo de ouvir a palavra de Deus.
8 But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish.
8 Mas Élimas, o Mago - pois assim é interpretado o seu nome -, se lhes opunha, procurando desviar da fé o procônsul.
9 But Saul (wey dem dey koll Paul) wey get di Holy Spirit, look Elymas for face
9 Então Saulo, chamado também Paulo, cheio do Espírito Santo, cravou nele os olhos e disse-lhe:
10 kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?
10 Filho do demônio, cheio de todo engano e de toda astúcia, inimigo de toda justiça, não cessas de perverter os caminhos retos do Senhor!
11 Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
11 Eis que agora está sobre ti a mão do Senhor e ficarás cego. Não verás o sol até nova ordem! Caíram logo sobre ele a escuridão e as trevas, e, andando à roda, buscava quem lhe desse a mão.
12 So wen di Roman offisa si wetin happen, e kon bilive, bikos e sopraiz well-well for wetin dem tish about Jesus Christ.Paul First Journey|alt="Paul's First Journey" src="PCM_GPS_Paul1_B&WFlat.indd" size="span" loc="ACT 13:4–14:28" copy="SIL" ref="13:4–14:28"
12 À vista deste prodígio, o procônsul abraçou a fé, admirando vivamente a doutrina do Senhor.
13 Paul and di pipol wey follow am kon travel from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, but John Mark leave dem kon go back to Jerusalem.
13 Paulo e os seus companheiros navegaram de Pafos e chegaram a Perge, na Panfília, de onde João, apartando-se deles, voltou para Jerusalém.
14 Wen dem komot for Perga, dem rish Antiok for Pisidia for Sabat Day kon enter di sinagog go sidan.
14 Mas eles, deixando Perge, foram para Antioquia da Pisídia. Ali entraram em dia de sábado na sinagoga, e sentaram-se.
15 Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”
15 Depois da leitura da lei e dos profetas, mandaram-lhes dizer os chefes da sinagoga: Irmãos, se tendes alguma palavra de exortação ao povo, falai-a.
16 So, Paul stand up raiz en hand kon sey:
16 Paulo levantou-se, fez um sinal com a mão e falou: Homens de Israel e vós que temeis a Deus, ouvi.
17 Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.
17 O Deus do povo de Israel escolheu nossos pais e exaltou este povo no tempo em que habitava na terra do Egito, de onde os tirou com o poder de seu braço.
18 For forty years, E stay with dem for inside wildaness.
18 Por espaço de quarenta anos alimentou-os no deserto.
19 Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land.
19 Destruiu sete nações na terra de Canaã e distribuiu-lhes por sorte aquela terra durante quase quatrocentos e cinqüenta anos.
20 All dis tins happen for four hundred and fifty years. Afta dis, E kon give dem profet wey go judge dem, until Profet Samuel time rish.
20 Em seguida, lhes deu juízes até o profeta Samuel.
21 Di pipol kon ask for king and God give dem Saul, wey bi Kish pikin, wey kom from Benjamin tribe and e rule dem for forty years.
21 Pediram então um rei, e Deus lhes deu, por quarenta anos, Saul, filho de Cis, da tribo de Benjamim.
22 Afta God remove am, E kon make David dia king. Na dis man God tok about sey, ‘I don si David, Jesse pikin, di man wey I like well-well and e go do evritin wey I wont.’
22 Depois, Deus o rejeitou e mandou-lhes Davi como rei, de quem deu este testemunho: Achei Davi, filho de Jessé, homem segundo o meu coração, que fará todas as minhas vontades.
23 Na from dis man family God give Israel, Jesus Christ, di Savior wey E promise dem before.
23 De sua descendência, conforme a promessa, Deus fez sair para Israel o Salvador Jesus.
24 Before Jesus kom, John di Baptist don prish to all Israel pipol sey make dem turn from sin kom meet God and make e baptize dem.
24 João tinha pregado, desde antes da sua vinda, o batismo do arrependimento a todo o povo de Israel.
25 But as John dey finish en work, e kon tok many times sey, ‘Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Make una si, somebody dey kom afta mi. I nor rish to remove shoe from en leg!’
25 Terminando a sua carreira, dizia: Eu não sou aquele que vós pensais, mas após mim virá aquele de quem não sou digno de desatar o calçado.
26 So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
26 Irmãos, filhos de Abraão, e os que entre vós temem a Deus: a nós é que foi dirigida a mensagem de salvação.
27 Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulers nor know am, so dem kon use wetin dem dey read for Sabat Day, wey di profets tok, take kill-am.
27 Com efeito, os habitantes de Jerusalém e os seus magistrados não conheceram Jesus, e, sentenciando-o, cumpriram os oráculos dos profetas, que cada sábado são lidos.
28 Even doh dem nor si anytin wey go make dem kondemn am, dem still tell Pilate make e kill-am.
28 Embora não achassem nele culpa alguma de morte, pediram a Pilatos que lhe tirasse a vida.
29 Wen dem don do evritin wey Bible tok about am, dem bring am down from di cross kon put am for grave.
29 Depois de realizarem todas as coisas que dele estavam escritas, tirando-o do madeiro, puseram-no num sepulcro.
30 But God raiz am from deat
30 Mas Deus o ressuscitou dentre os mortos.
31 and for many days, e appear to di pipol wey dey follow am from Galilee go rish Jerusalem. Na dis pipol kon dey bear witness sey, dis tins na true.
31 Durante muitos dias apareceu àqueles que com ele subiram da Galiléia a Jerusalém, os quais até agora são testemunhas dele junto ao povo.
32 And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem.
32 Nós vos anunciamos: a promessa feita a nossos pais,
33 E don do wetin E promise us and dia shidren, wen E raiz Jesus Christ, as dem rite am for Psalms sey, ‘Yu bi my Pikin and today, I don bi yor Papa.’
33 Deus a tem cumprido diante de nós, seus filhos, suscitando Jesus, como também está escrito no Salmo segundo: Tu és meu Filho, eu hoje te gerei {Sl 2,7}.
34 But bikos E don raiz Jesus Christ from deat make e nor for rotin, God kon sey: ‘I go give yu di holy promise wey una fit trust, wey I promise David.’
34 Que Deus o ressuscitou dentre os mortos, para nunca mais tornar à corrupção, ele o declarou desta maneira: Eu vos darei as coisas sagradas prometidas a Davi {Is 55,3}.
35 E still tok for anoda Psalms sey, ‘Yu nor go allow yor Pikin wey dey holy, make e rotin.’
35 E diz também noutra passagem: Não permitirás que teu Santo experimente a corrupção {Sl 15,10}.
36 Bikos David, afta e don do wetin God send am kon do among en pipol, e kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem and e rotin,
36 Ora, Davi, depois de ter servido em vida aos desígnios de Deus, morreu. Foi reunido a seus pais e experimentou a corrupção.
37 but di pesin wey God raiz-up, nor rotin.
37 Mas aquele a quem Deus ressuscitou não experimentou a corrupção.
38 So my pipol, make una know sey, na thru dis Pesin wi dey prish sey, ‘God go forgive una.’
38 Sabei, pois, irmãos, que por ele se vos anuncia a remissão dos pecados.
39 True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from.
39 Todo aquele que crê é justificado por ele de tudo aquilo que não pôde ser pela Lei de Moisés.
40 So make una make sure sey wetin di profets tok for groun, nor happen to una:
40 Cuidai, pois, que não venha sobre vós o que foi dito pelos profetas:
41 “ ‘Una wey dey laf;
41 Vede, ó desprezadores, pasmai e morrei de espanto. Pois eu vou realizar uma obra em vossos dias, obra a que não creríeis, se alguém vo-la contasse {Hab 1,5}.
42 As Paul and Banabas dey komot, di pipol kon dey beg dem make dem still kon tok about all dis tins for di next Sabat Day.
42 Ao saírem, rogavam que lhes repetissem essas palavras no sábado seguinte.
43 Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.
43 Depois que a assembléia terminou, muitos judeus e prosélitos devotos seguiram Paulo e Barnabé, os quais com muitas palavras os exortavam a perseverar na graça de Deus.
44 Di next Sabat Day, nearly evribody for di town gada make dem for hear God word.
44 No sábado seguinte, afluiu quase toda a cidade para ouvir a palavra de Deus.
45 But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.
45 Os judeus, vendo a multidão, encheram-se de inveja e puseram-se a protestar com injúrias contra o que Paulo falava.
46 Paul and Banabas kon use boldness take ansa dem, “E good sey na una wi first prish God word give. But since una rijet am and una nor ready to get life wey nor dey end, wi go-go prish give Gentile pipol.
46 Então Paulo e Barnabé disseram-lhes resolutamente: Era a vós que em primeiro lugar se devia anunciar a palavra de Deus. Mas, porque a rejeitais e vos julgais indignos da vida eterna, eis que nos voltamos para os pagãos.
47 Bikos dis na wetin God don already kommand us sey: ‘I don choose una to bi lite for Gentile pipol, make una bring salvashon kom dis world.’ ”
47 Porque o Senhor assim no-lo mandou: Eu te estabeleci para seres luz das nações, e levares a salvação até os confins da terra {Is 49,6}.
48 Wen di Gentile pipol hear wetin e tok, dem start to happy kon dey tank God for en word and evribody wey God don choose to get life wey nor dey end, kon bilive.
48 Estas palavras encheram de alegria os pagãos que glorificavam a palavra do Senhor. Todos os que estavam predispostos para a vida eterna fizeram ato de fé.
49 So God word kon dey spread round di whole kountry.
49 Divulgava-se, assim, a palavra do Senhor por toda a região.
50 But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.
50 Mas os judeus instigaram certas mulheres religiosas da aristocracia e os principais da cidade, que excitaram uma perseguição contra Paulo e Barnabé e os expulsaram do seu território.
51 So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium.
51 Estes sacudiram contra eles o pó dos seus pés, e foram a Icônio.
52 So di disciples kon dey happy and di Holy Spirit full dia life.
52 Os discípulos, por sua vez, estavam cheios de alegria e do Espírito Santo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.