Atos 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 For dat time, King Herod katch some pipol wey dey go church kon sey e go kill dem.
1 Por aquele mesmo tempo, o rei Herodes estendeu as mãos sobre alguns da igreja para os maltratar;
2 E kill James, wey bi John broda, with swod.
2 e matou à espada Tiago, irmão de João.
3 Wen e si sey di Jew pipol happy with wetin e do, e kon arrest Pita too. (Dis tin happen for di time wey dem dey do di bread wey nor get yist feast.)
3 E, vendo que isso agradara aos judeus, continuou, mandando prender também a Pedro. E eram os dias dos asmos.
4 Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.
4 E, havendo-o prendido, o encerrou na prisão, entregando- o a quatro quaternos de soldados, para que o guardassem, querendo apresentá-lo ao povo depois da Páscoa.
5 So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite.
5 Pedro, pois, era guardado na prisão; mas a igreja fazia contínua oração por ele a Deus.
6 But for di nite before dem go judge am, dem tie Pita with two shains and e sleep for two sojas centre. Oda sojas still dey di prison front, dey guide am.
6 E, quando Herodes estava para o fazer comparecer, nessa mesma noite, estava Pedro dormindo entre dois soldados, ligado com duas cadeias, e os guardas diante da porta guardavam a prisão.
7 God angel appear and lite kon shine for di prison. Di angel wake Pita kon tell am, “Get up kwik-kwik!” At wons, di shains fall komot from Pita hand.
7 E eis que sobreveio o anjo do Senhor, e resplandeceu uma luz na prisão; e, tocando a Pedro no lado, o despertou, dizendo: Levanta-te depressa! E caíram-lhe das mãos as cadeias.
8 Di angel sey, “Wear yor klot and yor sandal.” So Pita do wetin di angel tell am. Den di angel sey, “Wear yor koat make yu follow mi.”
8 E disse-lhe o anjo: Cinge-te e ata as tuas sandálias. E ele o fez assim. Disse-lhe mais: Lança às costas a tua capa e segue-me.
9 Pita follow am go outside. Even doh e bilive sey wetin dey happen so na true, e tink sey na dream e dey dream.
9 E, saindo, o seguia. E não sabia que era real o que estava sendo feito pelo anjo, mas cuidava que via alguma visão.
10 Afta, en and di angel kon pass di first and di sekond sojas group, den dem kon rish di iron gate wey go di town. Di gate open by ensef and dem go outside kon waka pass one small street, den di angel leave am for der.
10 E, quando passaram a primeira e a segunda guarda, chegaram à porta de ferro que dá para a cidade, a qual se lhes abriu por si mesma; e, tendo saído, percorreram uma rua, e logo o anjo se apartou dele.
11 Wen Pita si sey all dis tins wey dey happen nor bi dream, e kon sey, “Naw I know sey, True-true, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Jew pipol tink sey go happen.”
11 E Pedro, tornando a si, disse: Agora, sei, verdadeiramente, que o Senhor enviou o seu anjo e me livrou da mão de Herodes e de tudo o que o povo dos judeus esperava.
12 Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary house wey bi John Mark mama, where many pipol gada dey pray for am.
12 E, considerando ele nisso, foi à casa de Maria, mãe de João, que tinha por sobrenome Marcos, onde muitos estavam reunidos e oravam.
13 Wen e nok di door, Rhoda, one savant girl, kon ansa.
13 E, batendo Pedro à porta do pátio, uma menina chamada Rode saiu a escutar.
14 Wen di girl hear Pita vois, e kon dey happy sotey e nor remember to open di door, but e run go tell dem sey Pita dey for outside.
14 E, conhecendo a voz de Pedro, de alegria não abriu a porta, mas, correndo para dentro, anunciou que Pedro estava à porta.
15 Dem ansa di girl, “Yu nor know wetin yu dey tok!” But di girl still dey sey na Pita, so dem kon sey, “E go bi en spirit!”
15 E disseram-lhe: Estás fora de ti. Mas ela afirmava que assim era. E diziam: É o seu anjo.
16 But Pita still dey nok and wen dem open di door si am, dem kon sopraiz.
16 Mas Pedro perseverava em bater, e, quando abriram, viram-no e se espantaram.
17 E use en hand take tell dem make dem kwayet and e kon tell dem how God take free am from prison. E tell dem, “Make una tell James and all di brodas dis story,” den e leave dem kon go anoda place.
17 E, acenando-lhes ele com a mão para que se calassem, contou-lhes como o Senhor o tirara da prisão e disse: Anunciai isto a Tiago e aos irmãos. E, saindo, partiu para outro lugar.
18 Wen day break, di sojas wey dey guide Pita sopraiz well-well and fear katch dem wen dem nor si am again.
18 E, sendo já dia, houve não pouco alvoroço entre os soldados sobre o que seria feito de Pedro.
19 Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
19 E, quando Herodes o procurou e o não achou, feita inquirição aos guardas, mandou-os justiçar. E, partindo da Judeia para Cesareia, ficou ali.
20 Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.
20 E ele estava irritado com os de Tiro e de Sidom; mas estes, vindo de comum acordo ter com ele e obtendo a amizade de Blasto, que era o camarista do rei, pediam paz, porquanto o seu país se abastecia do país do rei.
21 Wen di day wey dem gri to meet am don rish, Herod kon wear en king dress and e kon sidan for en throne dey follow dem tok.
21 E, num dia designado, vestindo Herodes as vestes reais, estava assentado no tribunal e lhes dirigiu a palavra.
22 But as e dey tok, di pipol wey gada kon dey shaut, “Na god dey tok so-o, nor bi man!”
22 E o povo exclamava: Voz de Deus, e não de homem!
23 At wons God angel kon nak Herod fall for groun, bikos e nor give God glory and plenty worm kon chop en body till e die.
23 No mesmo instante, feriu-o o anjo do Senhor, porque não deu glória a Deus; e, comido de bichos, expirou.
24 But God word kontinue to dey spread.
24 E a palavra de Deus crescia e se multiplicava.
25 Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.
25 E Barnabé e Saulo, havendo terminado aquele serviço, voltaram de Jerusalém, levando também consigo a João, que tinha por sobrenome Marcos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.