Atos 11
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Di apostles and di brodas wey dey Judea kon hear sey Gentile pipol too don receive God word.
1 Os apóstolos e os irmãos de toda a Judéia ouviram falar que os gentios também haviam recebido a palavra de Deus.
2 So wen Pita rish Jerusalem, di bilivers wey bi Jew kon bigin argue with am sey,
2 Assim, quando Pedro subiu a Jerusalém, os que eram do partido dos circuncisos o criticavam, dizendo:
3 “Yu go chop with pipol wey dem nor sekonsaiz.”
3 "Você entrou na casa de homens incircuncisos e comeu com eles".
4 But Pita tell dem evritin wey happen. E kon sey,
4 Pedro, então, começou a explicar-lhes exatamente como tudo havia acontecido:
5 “As I dey pray for Joppa I kon si vishon. For inside di vishon, I si sometin wey bi like tray dey kom down small-small from heaven, dem hold am for four korna and e kon stop for my front.
5 "Eu estava na cidade de Jope orando; caindo em êxtase, tive uma visão. Vi algo parecido com um grande lençol sendo baixado do céu, preso pelas quatro pontas, e que vinha até o lugar onde eu estava.
6 As I look inside, I kon si animals wey get four legs, bush meat, di ones wey dey creep and difren-difren birds.
6 Olhei para dentro dele e notei que havia ali quadrúpedes da terra, animais selvagens, répteis e aves do céu.
7 I still hear one vois wey tell mi sey, ‘Get up Pita, kill some, make yu chop.’
7 Então ouvi uma voz que me dizia: ‘Levante-se, Pedro; mate e coma’.
8 But I ansa, ‘Oga God, I nor fit, bikos since dem born mi, I neva chop anytin wey nor dey klean.’
8 "Eu respondi: De modo nenhum, Senhor! Nunca entrou em minha boca algo impuro ou imundo.
9 But di vois from heaven kon tell mi again, ‘Wetin God don make klean, make yu nor forbid am!’
9 "A voz falou do céu segunda vez: ‘Não chame impuro ao que Deus purificou’.
10 Dis tin happen three times, den di tray kon go heaven back.
10 Isso aconteceu três vezes, e então tudo foi recolhido ao céu.
11 Na dat same time three men wey dem send kom meet mi from Caesaria kon rish di house where wi dey stay.
11 "Na mesma hora chegaram à casa em que eu estava hospedado três homens que me haviam sido enviados de Cesaréia.
12 Di Holy Spirit kon tell mi sey make I follow dem go. Six brodas for Joppa follow mi go too and wi kon enter di man house.
12 O Espírito me disse que não hesitasse em ir com eles. Estes seis irmãos também foram comigo, e entramos na casa de um certo homem.
13 Di man tell us how e si angel wey stand for en house kon tell am, ‘Send pipol go Joppa go koll Simon wey dem dey koll Pita.
13 Ele nos contou como um anjo lhe tinha aparecido em sua casa e dissera: ‘Mande buscar, em Jope, a Simão, chamado Pedro.
14 Wen e kom, e go give yu di message wey God go use take save yu and yor family.’
14 Ele lhe trará uma mensagem por meio da qual serão salvos você e todos os da sua casa’.
15 And wen I start to tok, di Holy Spirit kon enter dem, just as e enter us for di first time.
15 "Quando comecei a falar, o Espírito Santo desceu sobre eles como sobre nós no princípio.
16 So I kon remember wetin di Oga God don use en own mout tell us before sey, ‘John use wota baptize pipol, but God go baptize una with di Holy Spirit.’
16 Então me lembrei do que o Senhor tinha dito: ‘João batizou com água, mas vocês serão batizados com o Espírito Santo’.
17 So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?”
17 Se, pois, Deus lhes deu o mesmo dom que nos dera quando cremos no Senhor Jesus Cristo, quem era eu para pensar em opor-me a Deus? "
18 Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”
18 Ouvindo isso, não apresentaram mais objeções e louvaram a Deus, dizendo: "Então, Deus concedeu arrependimento para a vida até mesmo aos gentios! "
19 All di pipol wey skata komot from Jerusalem for di time wey dem kill Stefen kon travel go far place like Foenicia, Cyprus and Antiok, dey prish give only Jew pipol.
19 Os que tinham sido dispersos por causa da perseguição desencadeada com a morte de Estêvão chegaram até à Fenícia, Chipre e Antioquia, anunciando a mensagem apenas aos judeus.
20 But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ.
20 Alguns deles, todavia, cipriotas e cireneus, foram a Antioquia e começaram a falar também aos gregos, contando-lhes as boas novas a respeito do Senhor Jesus.
21 God pawa dey with dem and many pipol wey bilive kon bigin dey follow Jesus Christ.
21 A mão do Senhor estava com eles, e muitos creram e se converteram ao Senhor.
22 Wen di pipol for di church wey dey Jerusalem hear di news, dem kon send Banabas go Antiok.
22 Notícias desse fato chegaram aos ouvidos da igreja em Jerusalém, e eles enviaram Barnabé a Antioquia.
23 Wen e rish der kon si how God don bless di pipol, e happy well-well kon enkourage dem sey make dem kontinue to woship God with all dia heart.
23 Este, ali chegando e vendo a graça de Deus, ficou alegre e os animou a permanecerem fiéis ao Senhor, de todo o coração.
24 Banabas na betta pesin, di Holy Spirit dey inside am and e get faith well-well, so many pipol kon bigin follow Jesus Christ.
24 Ele era um homem bom, cheio do Espírito Santo e de fé; e muitas pessoas foram acrescentadas ao Senhor.
25 Banabas komot from der go find Saul for Tarsus
25 Então Barnabé foi a Tarso procurar Saulo
26 and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”
26 e, quando o encontrou, levou-o para Antioquia. Assim, durante um ano inteiro Barnabé e Saulo se reuniram com a igreja e ensinaram a muitos. Em Antioquia, os discípulos foram pela primeira vez chamados cristãos.
27 For di same time, some profets kon go Jerusalem from Antiok.
27 Naqueles dias alguns profetas desceram de Jerusalém para Antioquia.
28 One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.
28 Um deles, Ágabo, levantou-se e pelo Espírito predisse que uma grande fome sobreviria a todo o mundo romano, o que aconteceu durante o reinado de Cláudio.
29 So di disciples, evribody akordin to how e fit do rish, kon sey dem go send money go give di brodas wey dey Judea.
29 Os discípulos, cada um segundo as suas possibilidades, decidiram providenciar ajuda para os irmãos que viviam na Judéia.
30 Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.
30 E o fizeram, enviando suas ofertas aos presbíteros pelas mãos de Barnabé e Saulo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.