Apocalipse 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Wen di Lamb open di sevent key, evriwhere for heaven kon kwayet for like thirty minutes.
1 E, havendo aberto o sétimo selo, fez-se silêncio no céu quase por meia hora.
2 Den I si seven angels wey stand for God present and E give dem seven trumpets.
2 E vi os sete anjos, que estavam diante de Deus, e foram-lhes dadas sete trombetas.
3 Den anoda angel whole gold plate for hand kon stand near di altar. And God sey make e mix many incense join God pipol prayers and e go bi ofrin before di gold altar.
3 E veio outro anjo, e pôs-se junto ao altar, tendo um incensário de ouro; e foi-lhe dado muito incenso, para o pôr com as orações de todos os santos sobre o altar de ouro, que está diante do trono.
4 Di smoke from di incense, plus God pipol prayers kon dey go up go meet God from di angel hand.
4 E a fumaça do incenso subiu com as orações dos santos desde a mão do anjo até diante de Deus.
5 Di angel take di basin wey dem dey burn incense put kon pak fire full am from di altar, den e trow am kom di eart and tonda with strong lite and heavy eartkweke kon happen.
5 E o anjo tomou o incensário, e o encheu do fogo do altar, e o lançou sobre a terra; e houve depois vozes, e trovões, e relâmpagos e terremotos.
6 Di seven angels wey whole di seven trumpets dey ready to blow dem.
6 E os sete anjos, que tinham as sete trombetas, prepararam-se para tocá-las.
7 Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.
7 E o primeiro anjo tocou a sua trombeta, e houve saraiva e fogo misturado com sangue, e foram lançados na terra, que foi queimada na sua terça parte; queimou-se a terça parte das árvores, e toda a erva verde foi queimada.
8 Den di sekond angel blow en trumpet and dem trow mountins wey fire dey, enter di sea. If dem divide di sea into three, one part kon turn to blood.
8 E o segundo anjo tocou a trombeta; e foi lançada no mar uma coisa como um grande monte ardendo em fogo, e tornou-se em sangue a terça parte do mar.
9 And wen dem divide evritin wey get life for di sea into three, one part die finish. Den wen dem divide all di ship for di world into three, one part burn finish too.
9 E morreu a terça parte das criaturas que tinham vida no mar; e perdeu-se a terça parte das naus.
10 Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part.
10 E o terceiro anjo tocou a sua trombeta, e caiu do céu uma grande estrela ardendo como uma tocha, e caiu sobre a terça parte dos rios, e sobre as fontes das águas.
11 Di star name na “Bitterness.” So if dem divide di wota into three, one part betta and di wota kon kill pipol wey drink from am.
11 E o nome da estrela era Absinto, e a terça parte das águas tornou-se em absinto, e muitos homens morreram das águas, porque se tornaram amargas.
12 Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.
12 E o quarto anjo tocou a sua trombeta, e foi ferida a terça parte do sol, e a terça parte da lua, e a terça parte das estrelas; para que a terça parte deles se escurecesse, e a terça parte do dia não brilhasse, e semelhantemente a noite.
13 Den I look and I hear one eagle dey shaut as e dey fly for sky, “E go bad well-well! E go bad well-well! E go bad well-well for pipol wey dey dis eart, bikos of wetin go happen wen di last three angels go blow dia trumpets.”
13 E olhei, e ouvi um anjo voar pelo meio do céu, dizendo com grande voz: Ai! ai! ai! dos que habitam sobre a terra! por causa das outras vozes das trombetas dos três anjos que hão de ainda tocar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.