Apocalipse 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 As I dey look, di Lamb kon open one for di seven keys and I hear one for di for creatures dey shaut like tonda sey, “Make yu kom!”
1 Enquanto eu observava, o Cordeiro abriu o primeiro dos sete selos do livro. Então ouvi um dos quatro seres vivos dizer com voz de trovão: “Venha!”.
2 So I look kon si one white horse dey kom! Di pesin wey dey ride am whole bow and e wear crown for en head. E go fight and win many war and na champion e bi.
2 Quando olhei, vi um cavalo branco. Seu cavaleiro carregava um arco, e sobre sua cabeça foi colocada uma coroa. Ele saiu batalhando para conquistar vitórias.
3 Wen di Lamb open di sekond key, I kon hear di sekond creature dey sey, “Make yu kom!”
3 Quando o Cordeiro abriu o segundo selo, ouvi o segundo ser vivo dizer: “Venha!”.
4 Den anoda red horse kom out. Dem give di pesin wey dey ride am, big swod and pawa to take remove peace from dis eart. So pipol kon dey fight and kill each oda for evriwhere.
4 Então surgiu um cavalo vermelho. Seu cavaleiro recebeu uma grande espada e autoridade para tirar a paz da terra. E houve guerra e matança em toda parte.
5 Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand.
5 Quando o Cordeiro abriu o terceiro selo, ouvi o terceiro ser vivo dizer: “Venha!”. Quando olhei, vi um cavalo preto. Seu cavaleiro tinha na mão uma balança.
6 Den I hear one vois among di for creatures dey sey, “Dem dey sell six pound for barley and one bread for only one penny and make yu nor spoil di olive oil and wine.”
6 E ouvi uma voz dentre os quatro seres vivos dizer: “Uma medida de trigo ou três medidas de cevada custarão o salário de um dia, mas não desperdice o azeite nem o vinho”.
7 Wen di Lamb open di fourt key, I hear di fourt creature dey sey, “Make yu kom!”
7 Quando o Cordeiro abriu o quarto selo, ouvi o quarto ser vivo dizer: “Venha!”.
8 So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.
8 Quando olhei, vi um cavalo amarelo. Seu cavaleiro se chamava Morte, e o mundo dos mortos o seguia. Eles receberam autoridade sobre um quarto da terra para matar pela espada, pela fome e pela doença e por meio de animais selvagens.
9 Wen di Lamb open di fift key, pipol wey dem don kill bikos of God word and wetin dem dey tok about Christ, I si dia soul for under di altar.
9 Quando o Cordeiro abriu o quinto selo, vi sob o altar as almas de todos que haviam sido mortos por causa da palavra de Deus e por seu testemunho fiel.
10 Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”
10 Clamavam ao Senhor em alta voz e diziam: “Ó Soberano Senhor, santo e verdadeiro, quanto tempo passará até que julgues os habitantes da terra e vingues nosso sangue?”.
11 Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.
11 Então a cada um deles foi dada uma veste branca, e lhes foi dito que descansassem mais um pouco até que se completasse o número de seus irmãos, seus companheiros no serviço, que se juntariam a eles depois de serem mortos.
12 Den di Lamb open di sixt key and big eartkweke kon happen. Di sun kon dark like black klot and di moon kon dey red like blood.
12 Enquanto eu observava, o Cordeiro abriu o sexto selo, e houve um grande terremoto. O sol ficou escuro como pano negro, e a lua inteira se tornou vermelha como sangue.
13 Di stars for sky fall kom groun like di way fig tree fruit wey ripe, dey fall wen strong breeze dey blow.
13 Então as estrelas caíram do céu como figos verdes de uma figueira sacudida por um forte vento.
14 Di sky kon dey fold like paper and evry mountin and island move komot from where dem dey before.
14 O céu foi enrolado como pergaminho, e todas as montanhas e ilhas foram movidas de seu lugar.
15 Den evribody, both di kings for di eart; di rulers; ofisas; doz wey get money; doz wey get pawa and evry slave and free pesin kon hide demsef for holes and among di mountins.
15 Então os reis da terra, os governantes, os generais, os ricos, os poderosos, os escravos e os livres, todos se esconderam em cavernas e entre as rochas das montanhas.
16 Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.”
16 E gritavam às montanhas e às rochas: “Caiam sobre nós e escondam-nos da face daquele que está sentado no trono e da ira do Cordeiro!
17 Bikos di day to ponish dem, don kom and nobody go survive am.
17 Pois chegou o grande dia de sua ira, e quem poderá sobreviver?”.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.