Apocalipse 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Efesus:
1 Escreve ao anjo da igreja de Éfeso: Isto diz aquele que tem na sua destra as sete estrelas, que anda no meio dos sete castiçais de ouro:
2 I know yor work. I don si evritin wey yu do and even as yu dey wait with patient. I know sey yu nor like wiked pipol. Yu don test pipol wey sey dem bi apostles, but dem nor bi, bikos yu si sey, dem dey lie.
2 Conheço as tuas obras, e o teu trabalho, e a tua paciência, e que não podes sofrer os maus; e puseste à prova os que dizem ser apóstolos, e o não são, e tu os achaste mentirosos.
3 I still know sey yu don bear many tins bikos of my name and still, yu neva taya.
3 E sofreste, e tens paciência; e trabalhaste pelo meu nome, e não te cansaste.
4 But dis na wetin I get against yu: di way yu love mi naw, nor strong rish as e bi before!
4 Tenho, porém, contra ti que deixaste o teu primeiro amor.
5 So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.
5 Lembra-te, pois, de onde caíste, e arrepende-te, e pratica as primeiras obras; quando não, brevemente a ti virei, e tirarei do seu lugar o teu castiçal, se não te arrependeres.
6 But all dis tins dey happen make e for betta for yu, bikos yu hate di tins wey Nikolaitan pipol dey do and I hate doz tins too.
6 Tens, porém, isto: que odeias as obras dos nicolaítas, as quais eu também odeio.
7 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”
7 Quem tem ouvidos, ouça o que o Espírito diz às igrejas: Ao que vencer, dar-lhe-ei a comer da árvore da vida, que está no meio do paraíso de Deus.
8 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Smyrna:
8 E ao anjo da igreja em Esmirna, escreve: Isto diz o primeiro e o último, que foi morto, e reviveu:
9 I know di sofa wey yu sofa and how yu nor get money, but yu get enough money. I still know di bad tins wey dem tok about yu. Dem sey dem bi Jew pipol, but dem nor bi Jew, bikos dia sinagog, na Satan own.
9 Conheço as tuas obras, e tribulação, e pobreza (mas tu és rico), e a blasfêmia dos que se dizem judeus, e não o são, mas são a sinagoga de Satanás.
10 Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.
10 Nada temas das coisas que hás de padecer. Eis que o diabo lançará alguns de vós na prisão, para que sejais tentados; e tereis uma tribulação de dez dias. Sê fiel até à morte, e dar-te-ei a coroa da vida.
11 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, di sekond deat nor go kill-am.’ ”
11 Quem tem ouvidos, ouça o que o Espírito diz às igrejas: O que vencer não receberá o dano da segunda morte.
12 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Pergamum:
12 E ao anjo da igreja que está em Pérgamo escreve: Isto diz aquele que tem a espada aguda de dois fios:
13 I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.
13 Conheço as tuas obras, e onde habitas, que é onde está o trono de Satanás; e reténs o meu nome, e não negaste a minha fé, ainda nos dias de Antipas, minha fiel testemunha, o qual foi morto entre vós, onde Satanás habita.
14 But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.
14 Mas algumas poucas coisas tenho contra ti, porque tens lá os que seguem a doutrina de Balaão, o qual ensinava Balaque a lançar tropeços diante dos filhos de Israel, para que comessem dos sacrifícios da idolatria, e fornicassem.
15 Like dis too, some pipol among una dey follow wetin Nikolaitan pipol dey tish.
15 Assim tens também os que seguem a doutrina dos nicolaítas, o que eu odeio.
16 So, make yu turn from sin kom meet God! If not, I go kwik-kwik kom fight yu with di swod wey dey my mout.
16 Arrepende-te, pois, quando não em breve virei a ti, e contra eles batalharei com a espada da minha boca.
17 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”
17 Quem tem ouvidos, ouça o que o Espírito diz às igrejas: Ao que vencer darei eu a comer do maná escondido, e dar-lhe-ei uma pedra branca, e na pedra um novo nome escrito, o qual ninguém conhece senão aquele que o recebe.
18 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Tiatira:
18 E ao anjo da igreja de Tiatira escreve: Isto diz o Filho de Deus, que tem seus olhos como chama de fogo, e os pés semelhantes ao latão reluzente:
19 I know all di tins wey yu dey do. I don si yor love, yor faith, yor work and as yu dey wait with patient. And I si as yu dey do well for all dis tins.
19 Eu conheço as tuas obras, e o teu amor, e o teu serviço, e a tua fé, e a tua paciência, e que as tuas últimas obras são mais do que as primeiras.
20 But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.
20 Mas algumas poucas coisas tenho contra ti que deixas Jezabel, mulher que se diz profetisa, ensinar e enganar os meus servos, para que forniquem e comam dos sacrifícios da idolatria.
21 I don gi-am time make e turn from sin kom meet God, but e nor gri stop to sleep with doz wey nor bi en husband.
21 E dei-lhe tempo para que se arrependesse da sua fornicação; e não se arrependeu.
22 Si! I go trow am put for bed where e go sofa and doz wey dey sin with am, go sofa well-well, unless dem turn from sin kom meet God.
22 Eis que a porei numa cama, e sobre os que adulteram com ela virá grande tribulação, se não se arrependerem das suas obras.
23 I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.
23 E ferirei de morte a seus filhos, e todas as igrejas saberão que eu sou aquele que sonda os rins e os corações. E darei a cada um de vós segundo as vossas obras.
24 But una wey dey Tiatira, wey nor dey follow wetin Jezebel dey tish (wey neva learn di tins wey dem dey koll “Satan deep sekret”), I dey tell una dis tins naw, but I nor go ask una for anytin again.
24 Mas eu vos digo a vós, e aos restantes que estão em Tiatira, a todos quantos não têm esta doutrina, e não conheceram, como dizem, as profundezas de Satanás, que outra carga vos não porei.
25 Make una whole wetin una get until I kom.
25 Mas o que tendes, retende-o até que eu venha.
26 Anybody wey fit bear and obey mi rish di end, I go gi-am authority ova all di nashons.
26 E ao que vencer, e guardar até ao fim as minhas obras, eu lhe darei poder sobre as nações,
27 E go rule di nashons with iron rod
27 E com vara de ferro as regerá; e serão quebradas como vasos de oleiro; como também recebi de meu Pai.
28 E go get di same authority wey I get from my papa and I go still gi-am di star wey dey shine for morning.
28 E dar-lhe-ei a estrela da manhã.
29 Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
29 Quem tem ouvidos, ouça o que o Espírito diz às igrejas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.