Apocalipse 21

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Den I si new heaven and new eart. Di first heaven and eart nor dey again and di sea vanish.
1 E vi um novo céu e uma nova terra. Porque já o primeiro céu e a primeira terra passaram, e o mar já não existe.
2 And I si di holy town, di new Jerusalem, dey kom down from heaven from God and dem dress am like woman wey won go meet en husband.
2 E eu, João, vi a Santa Cidade, a nova Jerusalém, que de Deus descia do céu, adereçada como uma esposa ataviada para o seu marido.
3 And I hear one loud vois from di throne dey sey: “Make yu look! God house don dey with human being naw. E go stay with dem and dem go bi en pipol. God ensef go dey with dem.
3 E ouvi uma grande voz do céu, que dizia: Eis aqui o tabernáculo de Deus com os homens, pois com eles habitará, e eles serão o seu povo, e o mesmo Deus estará com eles e será o seu Deus.
4 E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”
4 E Deus limpará de seus olhos toda lágrima, e não haverá mais morte, nem pranto, nem clamor, nem dor, porque já as primeiras coisas são passadas.
5 And di Pesin wey sidan for di throne kon sey: “Make yu look! I dey make evritin new!” Den E kon tell mi, “Make yu rite all dis tins, bikos dis word na word wey pipol fit trust and na true.”
5 E o que estava assentado sobre o trono disse: Eis que faço novas todas as coisas. E disse-me: Escreve, porque estas palavras são verdadeiras e fiéis.
6 E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.
6 E disse-me mais: Está cumprido; Eu sou o Alfa e o Ômega, o Princípio e o Fim. A quem quer que tiver sede, de graça lhe darei da fonte da água da vida.
7 Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin.
7 Quem vencer herdará todas as coisas, e eu serei seu Deus, e ele será meu filho.
8 But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”
8 Mas, quanto aos tímidos, e aos incrédulos, e aos abomináveis, e aos homicidas, e aos fornicadores, e aos feiticeiros, e aos idólatras e a todos os mentirosos, a sua parte será no lago que arde com fogo e enxofre, o que é a segunda morte.
9 Den one for di seven angel wey bin whole di seven basin wey di seven last ponishment full, waka kon tell mi sey, “Make yu kom, so dat I go show yu di woman wey won marry; di Lamb wife!”
9 E veio um dos sete anjos que tinham as sete taças cheias das últimas sete pragas e falou comigo, dizendo: Vem, mostrar-te-ei a esposa, a mulher do Cordeiro.
10 So for di vishon, di angel karry mi go one big fine mountin and e show mi di holy town, di new Jerusalem as e dey kom out from heaven from God.
10 E levou-me em espírito a um grande e alto monte e mostrou-me a grande cidade, a santa Jerusalém, que de Deus descia do céu.
11 Di town get God glory and di way e dey shine, bi like stone wey dear; like jasper stone wey dey shine.
11 E tinha a glória de Deus. A sua luz era semelhante a uma pedra preciosíssima, como a pedra de jaspe, como o cristal resplandecente.
12 E get big wall wey high with twelf gate and dem rite di twelf tribes for Israel put.
12 E tinha um grande e alto muro com doze portas, e, nas portas, doze anjos, e nomes escritos sobre elas, que são os nomes das doze tribos de Israel.
13 Three gate dey for di east side, three dey for di nort, three dey for di sout and three dey for di west side.
13 Da banda do levante, tinha três portas; da banda do norte, três portas; da banda do sul, três portas; da banda do poente, três portas.
14 Di town wall get twelf foundashon and dem rite di Lamb twelf apostle name put for di twelf foundashon.
14 E o muro da cidade tinha doze fundamentos e, neles, os nomes dos doze apóstolos do Cordeiro.
15 Di angel wey tok to mi, whole ruler for hand wey e go take measure di town, en foundashon stone and di wall.
15 E aquele que falava comigo tinha uma cana de ouro para medir a cidade, e as suas portas, e o seu muro.
16 Dem build di town like skware and as e long rish, na so e still wide rish too. E measure di town with di ruler and na 1,000 for hundred mile e bi (as e long rish, na so e still wide and high rish, all of dem dey ekwol).
16 E a cidade estava situada em quadrado; e o seu comprimento era tanto como a sua largura. E mediu a cidade com a cana até doze mil estádios; e o seu comprimento, largura e altura eram iguais.
17 E still measure di wall and na one hundred and forty-four cubit e bi and na as human being dey measure, naim di angel take measure.
17 E mediu o seu muro, de cento e quarenta e quatro côvados, conforme a medida de homem, que é a de um anjo.
18 Na jasper dem take make di town wall and na pure gold wey klear like glass, dem take make di town ensef.
18 E a fábrica do seu muro era de jaspe, e a cidade, de ouro puro, semelhante a vidro puro.
19 Dem take difren stone wey dear take design di wall. Di first foundashon stone wey dem use na jasper, den safaya, agate, emerald,
19 E os fundamentos do muro da cidade estavam adornados de toda pedra preciosa. O primeiro fundamento era jaspe; o segundo, safira; o terceiro, calcedônia; o quarto, esmeralda;
20 onyx, karnelian, chrysolite, beryl, topaz, krisoprase, jacint and ametist.
20 o quinto, sardônica; o sexto, sárdio; o sétimo, crisólito; o oitavo, berilo; o nono, topázio; o décimo, crisópraso; o undécimo, jacinto; o duodécimo, ametista.
21 Di twelf gate for di town na twelf stones wey dear. Dem make each gate with one stone! Na pure gold wey klear like glass dem take make di town main road.
21 E as doze portas eram doze pérolas: cada uma das portas era uma pérola; e a praça da cidade, de ouro puro, como vidro transparente.
22 I nor si any temple for di town, bikos Oga God, di one wey get all pawa and di Lamb, na dem bi di temple.
22 E nela não vi templo, porque o seu templo é o Senhor, Deus Todo-Poderoso, e o Cordeiro.
23 Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite.
23 E a cidade não necessita de sol nem de lua, para que nela resplandeçam, porque a glória de Deus a tem alumiado, e o Cordeiro é a sua lâmpada.
24 Na di town lite go show pipol road and di kings wey dey for di world go bring evritin wey dem get kom inside.
24 E as nações andarão à sua luz, e os reis da terra trarão para ela a sua glória e honra.
25 Dem nor go ever klose di gate for day (and nite nor go dey der).
25 E as suas portas não se fecharão de dia, porque ali não haverá noite.
26 Dem go take evritin wey di nashons get enter di town.
26 E a ela trarão a glória e honra das nações.
27 But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.
27 E não entrará nela coisa alguma que contamine e cometa abominação e mentira, mas só os que estão inscritos no livro da vida do Cordeiro.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.