Apocalipse 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Afta dis tins, I hear wetin bi like many pipol vois for heaven dey sey:
1 Depois disso ouvi no céu algo semelhante à voz de uma grande multidão, que exclamava: "Aleluia! A salvação, a glória e o poder pertencem ao nosso Deus,
2 bikos en judgement dey true and korrect.
2 pois verdadeiros e justos são os seus juízos. Ele condenou a grande prostituta que corrompia a terra com a sua prostituição. Ele cobrou dela o sangue dos seus servos".
3 Den di pipol shaut again, “Halleluya! Di smoke from di fire wey burn am go dey go up forever and ever!”
3 E mais uma vez a multidão exclamou: "Aleluia! A fumaça que dela vem, sobe para todo o sempre".
4 Di twenty-four eldas and di for creatures kon bow and woship God wey sidan for di throne sey, “Amen! Halleluya!”
4 Os vinte e quatro anciãos e os quatro seres viventes prostraram-se e adoraram a Deus, que estava assentado no trono, e exclamaram: "Amém, Aleluia! "
5 Den one vois tok from di throne sey: “Wi wey bi God savant, make wi praiz am! All of una wey dey fear am, both small and big, make una praiz am too!”
5 Então veio do trono uma voz, conclamando: "Louvem o nosso Deus, todos vocês, seus servos, vocês que o temem, tanto pequenos como grandes! "
6 Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!
6 Então ouvi algo semelhante ao som de uma grande multidão, como o estrondo de muitas águas e fortes trovões, que bradava: "Aleluia! pois reina o Senhor, o nosso Deus, o Todo-poderoso.
7 Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.”
7 Regozijemo-nos! Vamos nos alegrar e dar-lhe glória! Pois chegou a hora do casamento do Cordeiro, e a sua noiva já se aprontou.
8 Dem allow am wear klean linen wey dey shine, (Dis linen mean di good tins wey God pipol do).
8 Foi-lhe dado para vestir-se linho fino, brilhante e puro". O linho fino são os atos justos dos santos.
9 Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”
9 E o anjo me disse: "Escreva: Felizes os convidados para o banquete do casamento do Cordeiro! " E acrescentou: "Estas são as palavras verdadeiras de Deus".
10 So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”
10 Então caí aos seus pés para adorá-lo, mas ele me disse: "Não faça isso! Sou servo como você e como os seus irmãos que se mantêm fiéis ao testemunho de Jesus. Adore a Deus! O testemunho de Jesus é o espírito de profecia".
11 Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.
11 Vi o céu aberto e diante de mim um cavalo branco, cujo cavaleiro se chama Fiel e Verdadeiro. Ele julga e guerreia com justiça.
12 En eyes bi like fire wey dey burn well-well and many crowns dey en head. Di name wey dem rite for en head, nobody know am, escept en ensef.
12 Seus olhos são como chamas de fogo, e em sua cabeça há muitas coroas e um nome que só ele conhece, e ninguém mais.
13 E wear klot wey dem soak inside blood and di name wey dem dey koll am, na God Word.
13 Está vestido com um manto tingido de sangue, e o seu nome é Palavra de Deus.
14 Di sojas wey dey heaven, wear white linen kon enter white horse dey follow am.
14 Os exércitos do céu o seguiam, vestidos de linho fino, branco e puro, e montados em cavalos brancos.
15 One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
15 De sua boca sai uma espada afiada, com a qual ferirá as nações. "Ele as governará com cetro de ferro". Ele pisa o lagar do vinho do furor da ira do Deus todo-poderoso.
16 For en klot and lap, wetin dem rite put na: “King and Oga God wey big pass.”
16 Em seu manto e em sua coxa está escrito este nome: REI DOS REIS E SENHOR DOS SENHORES.
17 Den I si one angel stand for di sun and e shaut give all di bird for sky sey: “Make una kom, make una gada round kom chop for God party.
17 Vi um anjo que estava de pé no sol e que clamava em alta voz a todas as aves que voavam pelo meio do céu: "Venham, reúnam-se para o grande banquete de Deus,
18 Make una kom chop kings, ofisas, sojas, dia horse, di drivers and human being flesh: weda dem dey free or dem bi slave, big or small pipol, make una kom chop beleful!”
18 para comerem carne de reis, generais e poderosos, carne de cavalos e seus cavaleiros, carne de todos: livres e escravos, pequenos e grandes".
19 Den I si di beast, di kings wey dey di world, dia sojas, as all of dem gada to fight di Pesin wey dey ride di horse and en sojas.
19 Então vi a besta, os reis da terra e os seus exércitos reunidos para guerrearem contra aquele que está montado no cavalo e contra o seu exército.
20 So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.
20 Mas a besta foi presa, e com ela o falso profeta que havia realizado os sinais miraculosos em nome dela, com os quais ele havia enganado os que receberam a marca da besta e adoraram a imagem dela. Os dois foram lançados vivos no lago de fogo que arde com enxofre.
21 Dem take di swod wey dey kom out from di Pesin wey dey ride di horse mout, kon kill di odas, den all di birds chop dia body till di beleful.
21 Os demais foram mortos com a espada que saía da boca daquele que está montado no cavalo. E todas as aves se fartaram com a carne deles.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.