Apocalipse 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Den I si anoda big sign for heaven wey nobody go fit undastand: seven angels whole di seven last wahala and na dis ones go komplete God vexnashon.
1 E vi outro grande e admirável sinal no céu: sete anjos que tinham as sete últimas pragas, porque nelas é consumada a ira de Deus.
2 I kon si anoda tin wey bi like river wey dem mix with fire and I still si di pipol wey konker di beast, en image and di nomba for en name. Dem stand near di river kon whole harp wey God give dem.
2 E vi um como mar de vidro misturado com fogo e também os que saíram vitoriosos da besta, e da sua imagem, e do seu sinal, e do número do seu nome, que estavam junto ao mar de vidro e tinham as harpas de Deus.
3 Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.
3 E cantavam o cântico de Moisés, servo de Deus, e o cântico do Cordeiro, dizendo: Grandes e maravilhosas são as tuas obras, Senhor, Deus Todo-Poderoso! Justos e verdadeiros são os teus caminhos, ó Rei dos santos!
4 Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”
4 Quem te não temerá, ó Senhor, e não magnificará o teu nome? Porque só tu és santo; por isso, todas as nações virão e se prostrarão diante de ti, porque os teus juízos são manifestos.
5 Afta all dis, I kon si di temple for heaven open and di kovenant tent dey inside.
5 E, depois disto, olhei, e eis que o templo do tabernáculo do testemunho se abriu no céu.
6 Den di seven angels wey whole di seven last wahala kon kom out from di temple and dem wear klean klot wey dey shine well-well, kon tie gold belt for dia chest.
6 E os sete anjos que tinham as sete pragas saíram do templo, vestidos de linho puro e resplandecente e cingidos com cintos de ouro pelo peito.
7 Den one among di for creatures kon give di seven angels seven gold basin wey full with God wey go live forever and ever, vexnashon.
7 E um dos quatro animais deu aos sete anjos sete salvas de ouro, cheias da ira de Deus, que vive para todo o sempre.
8 Den, smoke kon full di temple with God glory and pawa. And nobody fit enter until di seven wahala wey di angels bring, don komplete.
8 E o templo encheu-se com a fumaça da glória de Deus e do seu poder; e ninguém podia entrar no templo, até que se consumassem as sete pragas dos sete anjos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.