Apocalipse 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 Den I si di Lamb stand on-top Mount Zion with 144,000 pipol. Dem rite en name with en Papa name for dia fore head.
1 Então vi o Cordeiro em pé no monte Sião, e com ele estavam os 144 mil que tinham o nome dele e o nome de seu Pai escritos na testa.
2 And I hear one loud vois from heaven like wave for sea or tonda for sky. I hear anoda sound like harp wey dem dey play.
2 E ouvi um som que vinha do céu, como o som de fortes ondas do mar, como o som de um poderoso trovão. Era como o som de muitos harpistas tocando juntos.
3 Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.
3 Esse grande coral cantava um cântico novo diante do trono de Deus e diante dos quatro seres vivos e dos 24 anciãos. Ninguém podia aprender o cântico, a não ser os 144 mil que haviam sido comprados da terra.
4 Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.
4 Eles se conservaram puros, sem manter relações com mulheres, e seguem o Cordeiro por onde quer que ele vá. Foram comprados dentre os habitantes da terra como oferta especial a Deus e ao Cordeiro.
5 Lie-lie nor dey dia mout and dem nor get any fault.
5 Não mentem; são irrepreensíveis.
6 Den I si anoda angel dey fly for sky and e karry di Good News wey go dey forever dey kom prish give di pipol for dis eart, kountries, tribes, language and groups.
6 Vi outro anjo que voava no ponto mais alto do céu, levando as boas-novas eternas para anunciá-las aos habitantes da terra, a toda nação, tribo, língua e povo.
7 Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”
7 “Temam a Deus!”, dizia em alta voz. “Deem glória a ele, pois chegou o tempo em que ele julgará a humanidade. Adorem aquele que fez os céus, a terra, o mar e todas as fontes de água.”
8 Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”
8 Então outro anjo o seguiu, dizendo em alta voz: “Caiu a Babilônia! Caiu a grande cidade que fez todas as nações beberem do vinho da fúria de sua imoralidade!”.
9 Di third angel kon follow di first two, dey shaut: “If anybody woship di beast and en image kon kollect di mark for en fore head or hand,
9 Um terceiro anjo os seguiu, dizendo em alta voz: “Aqueles que adorarem a besta e sua estátua, ou aceitarem sua marca na testa ou na mão,
10 e go drink from God vexnashon wey dey inside en ponishment cup. God go ponish am with fire and sulfur for en holy angels and Lamb front.
10 beberão do vinho da fúria de Deus, que foi derramado, sem mistura, na taça da ira de Deus. E serão atormentados com fogo e enxofre na presença dos santos anjos e do Cordeiro.
11 Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.”
11 A fumaça de seu tormento subirá para todo o sempre, e não terão alívio de dia nem de noite, pois adoraram a besta e sua estátua e aceitaram a marca de seu nome”.
12 Dis mean sey, God pipol go bear well-well, bikos dem dey obey en kommandment and get faith for Christ.
12 Isso significa que o povo santo deve ser perseverante, obedecendo aos mandamentos de Deus e permanecendo fiel a Jesus.
13 Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins:
13 E ouvi uma voz que vinha do céu, dizendo: “Escreva isto: Felizes os que, de agora em diante, morrem no Senhor. Sim, diz o Espírito, eles são verdadeiramente felizes, pois descansarão de seu trabalho árduo; porque suas boas obras os acompanharão”.
14 Den I look kon si one white kloud and di pesin wey sidan on-top, bi like Man Pikin! E wear gold crown for head kon whole sharp knife for hand.
14 Em seguida, vi uma nuvem branca e, sentado na nuvem, alguém semelhante ao Filho do Homem. Tinha uma coroa de ouro na cabeça e uma foice afiada na mão.
15 Den anoda angel kom out from di temple kon tell di one wey sidan on-top di kloud, “Make yu start to harvest with yor knife, bikos na di korrect time bi dis and di fruits for eart don ripe!”
15 Então outro anjo veio do templo e gritou bem forte para aquele que estava sentado na nuvem: “Use a foice e comece a ceifar, pois chegou a hora da colheita; a safra da terra está madura!”.
16 So di pesin wey sidan on-top di kloud, take en knife klear di eart kon harvest evritin wey dey inside.
16 Assim, aquele que estava sentado na nuvem passou a foice sobre a terra, e toda a terra foi ceifada.
17 Den anoda angel kom out from di temple for heaven with sharp knife for en hand.
17 Depois disso, outro anjo saiu do templo no céu, e ele também tinha uma foice afiada.
18 Anoda angel still kom out from di altar and e get pawa to kontrol di fire. Di angel koll di one wey hold di sharp knife kon tell am, “Make yu use yor sharp knife gada di grapes for di vine for eart, bikos dem don ripe rish to plok.”
18 Então ainda outro anjo, que tinha poder para destruir com fogo, veio do altar e gritou bem forte para o anjo que segurava a foice afiada: “Agora use sua foice para ajuntar os cachos de uvas da videira da terra, pois estão maduras!”.
19 So di angel klear di eart with en knife, gada di grapes from di vine kon trow dem put for where dem go press dem and dis na God sirious vexnashon.
19 O anjo passou a foice sobre a terra e encheu de uvas o grande tanque de prensar da fúria de Deus.
20 Den, dem press di grapes for outside di town and blood rush kom out from di place where dem dey press dem. Di blood high rish five fit and e nearly rush rish two hundred mile.
20 As uvas foram pisadas no tanque, fora da cidade, e dele correu sangue como um rio de quase trezentos quilômetros de comprimento, com altura que chegava aos freios de um cavalo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.