Apocalipse 12

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 Den one big sign kon appear for heaven: I si one woman wey take sun tie en body like klot, di moon dey under en leg and one crown with twelf stars, dey for en head.
1 Então foi visto no céu um grande sinal: uma mulher vestida do sol, com a lua sob os pés e uma coroa de doze estrelas na cabeça.
2 Di woman get belle and e dey kry well-well, bikos e won born naw.
2 Estava grávida e gritava por causa das dores de parto e da agonia de dar à luz.
3 Den I si anoda sign for heaven: I si one big red dragon with seven heads and ten horns and seven crowns, dey di heads.
3 Outro sinal foi visto no céu: um enorme dragão vermelho com sete cabeças e dez chifres, e sete coroas nas cabeças.
4 If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born.
4 Com a cauda, arrastou um terço das estrelas do céu e as lançou na terra. E, quando a mulher estava para dar à luz, o dragão parou diante dela, pronto para devorar a criança tão logo ela nascesse.
5 Di woman born boy wey go rule di world with strong hand. But dem take di pikin kon go gi-am to God for en throne.
5 A mulher deu à luz um filho, que governará todas as nações com cetro de ferro, e ele foi arrebatado para junto de Deus e de seu trono.
6 So di woman run enter di wildaness, di place where God don prepare to kare for am for 1,260 days.
6 A mulher fugiu para o deserto, onde Deus havia preparado um lugar para cuidar dela durante 1.260 dias.
7 Den big fight kon happen for heaven. Mikael and en angels kon fight against di dragon and en angels.
7 Houve guerra no céu. Miguel e seus anjos lutaram contra o dragão e seus anjos.
8 Mikael and en angels win di fight, so dem kon porshu di dragon and en angels komot from heaven by force.
8 O dragão perdeu a batalha, e ele e seus anjos foram expulsos do céu.
9 Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.
9 Esse enorme dragão, a antiga serpente chamada diabo ou Satanás, que engana o mundo todo, foi lançado na terra com seus anjos.
10 Den I hear one loud vois for heaven dey sey, “Salvashon; pawa; authority wey Christ get and God kingdom, don kom at last. Bikos di pesin wey dey akuiz awa brodas and sistas evriday, God don trow am kom down.
10 Então ouvi uma forte voz que bradava pelos céus: “Finalmente chegaram a salvação, o poder, o reino de nosso Deus e a autoridade de seu Cristo. Porque foi lançado para a terra o acusador de nossos irmãos, aquele que dia e noite os acusa diante de nosso Deus.
11 God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.
11 Eles o derrotaram pelo sangue do Cordeiro e pelo testemunho deles. Não amaram a própria vida nem mesmo diante da morte.
12 So, heavens make yu happy! But wahala go happen for di eart and sea, bikos di devil don kom meet una with strong vexnashon and en time too short.”
12 Portanto, alegrem-se, ó céus, e vocês que habitam nos céus! Sobre a terra e o mar, porém, virá terror, pois o diabo desceu até vocês com grande fúria, sabendo que lhe resta pouco tempo”.
13 Wen di dragon know sey dem don trow am go di eart, e porshu di woman wey born di boy.
13 Quando o dragão percebeu que havia sido lançado na terra, perseguiu a mulher que tinha dado à luz o menino.
14 But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.
14 Ela, porém, recebeu duas asas como as de uma grande águia, para que voasse ao lugar preparado para ela no deserto. Ali, será sustentada e protegida da serpente durante um tempo, tempos e metade de um tempo.
15 Den di dragon try to kill di woman with plenty wota wey e spit kom out from en mout.
15 Então a serpente, com uma torrente de água que fez sair de sua boca, tentou afogar a mulher.
16 But di eart help di woman bikos e swallow di wota wey kom out from di dragon mout.
16 Mas a terra ajudou a mulher, abrindo a boca e engolindo o rio que havia jorrado da boca do dragão.
17 Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ.
17 O dragão se enfureceu com a mulher e passou a lutar contra o restante de seus filhos, todos os que obedecem aos mandamentos de Deus e se mantêm fiéis no testemunho de Jesus.
18 Den di dragon stand near di sea.
18 Então o dragão se colocou em pé na praia, junto ao mar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Apocalipse 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.