Ageu 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 For di twenty first day for di sevent mont for dat same year, God kon tok to Profet Haggai again.
1 No dia vinte e um do sétimo mês, veio a palavra do Senhor por meio do profeta Ageu:
2 E tell am make e go tell Zerubabel wey bi Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah, Joshua wey bi di High Priest and all di pipol sey,
2 "Pergunte ao governador de Judá, Zorobabel, filho de Sealtiel, ao sumo sacerdote Josué, filho de Jeozadaque, e ao restante do povo, o seguinte:
3 “E get anybody among una wey fit remember di way di temple fine rish before? But how una si am naw? Una fit kompare dis temple with di first one?
3 ‘Quem de vocês viu este templo em seu primeiro esplendor? Comparado com ele, não é como nada o que vocês vêem agora?
4 But naw, Oga God sey: Zerubabel make yor heart strong, Joshua, Jehozadak pikin wey bi High Priest, make yu don fear too. All di pipol wey dey di land, make una mind strong. Make una bigin work, bikos I dey with una.
4 "Coragem, Zorobabel", declara o Senhor. "Coragem, sumo sacerdote Josué, filho de Jeozadaque. Coragem! Ao trabalho, ó povo da terra! ", declara o Senhor. "Porque eu estou com vocês", declara o Senhor dos Exércitos.
5 My Spirit still dey with una, just as I promise wen una dey kom out from Egypt, so make una nor fear.
5 Esta é a aliança que fiz com vocês quando vocês saíram do Egito: "Meu espírito está entre vocês. Não tenham medo".
6 Dis na wetin Oga God for heaven dey tok: E nor go tey again before I go shake di heavens and di eart, di sea and di dry land.
6 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Dentro de pouco tempo farei tremer o céu, a terra, o mar e o continente.
7 I go shake all di nashons and dem go bring all dia propaty kom dis temple. I go kover dis place with my glory.”
7 Farei tremer todas as nações, que trarão para cá os seus tesouros, e encherei este templo de glória", diz o Senhor dos Exércitos.
8 God sey, “Na mi get all di silva and gold wey dey di world.
8 "Tanto a prata quanto o ouro me pertencem", declara o Senhor dos Exércitos.
9 Di glory for dis new temple go big pass di old one and na for der I go for give my pipol peace and make dem prosper.”
9 "A glória deste novo templo será maior do que a do antigo", diz o Senhor dos Exércitos. "E neste lugar estabelecerei a paz", declara o Senhor dos Exércitos.
10 For di twenty fourt day for di ninet mont for di sekond year wey Darius bi king, Oga God tok to Profet Haggai again.
10 No dia vinte e quatro do nono mês, no segundo ano do reinado de Dario, a palavra do Senhor veio ao profeta Ageu:
11 E sey, “Make yu go ask di priest wetin di law tok about dis tin:
11 "Assim diz o Senhor dos Exércitos: ‘Pergunte aos sacerdotes sobre a seguinte questão da Lei:
12 ‘Like for ezample sey pesin take holy meat wey dem don sakrifice kon hide am for en klot, den e allow dat klot tosh bread or food wey dem kook or wine or olive oil or any kind food, dat one go make di food dey holy?’ ” So wen Haggai ask dem di kweshon. Di priests ansa, “No!”
12 Se alguém levar carne consagrada na borda de suas vestes, e com ela tocar num pão, ou em algo cozido, ou em vinho, ou em azeite ou em qualquer comida, isso ficará consagrado? ’ " Os sacerdotes responderam: "Não".
13 Den Haggai ask again, “Wot of pesin wey dirty bikos e tosh dead body; if e tosh any of dis food, dat mean sey di food dem don dirty too?” Di priests ansa, “Yes!”
13 Em seguida perguntou Ageu: "Se alguém ficar impuro por tocar num cadáver e depois tocar em alguma dessas coisas, ela ficará impura? "Sim", responderam os sacerdotes, "ficará impura".
14 Den Haggai sey, “God sey na di same tin go happen to di pipol for dis nashon and evritin wey dem plant. So evritin wey dem offa for di altar, don dirty.”
14 Então disse Ageu: "É o que acontece com este povo e com esta nação", declara o Senhor. "Tudo o que fazem e tudo o que me oferecem é impuro".
15 So God sey, “Make una tink about wetin bin dey happen to una before una start to ribuild di temple. But from naw go, evritin wey una dey do, go dey okay.
15 "Agora prestem atenção: de hoje em diante reconsiderem. Como eram as coisas antes que se colocasse pedra sobre pedra no templo do Senhor?
16 Dat time, una go where dem pak korn full, dey tink sey una go si twenty sak, but na only ten una si. Una go draw fifty gallon for wine, but na only twenty una get.
16 Quando alguém chegava a um monte de trigo procurando vinte medidas, havia apenas dez. Quando alguém ia ao depósito de vinho para tirar cinqüenta medidas, só encontrava vinte.
17 Even wen I send hot breeze and big-big stones kom skata evritin wey una plant, una nor still gri turn from sin kom meet mi.
17 Eu destruí todo o trabalho das mãos de vocês, com mofo, ferrugem e granizo, mas vocês não se voltaram para mim", declara o Senhor.
18 But from today wey bi di twenty fourt day for di ninet mont, make una tink about how e bi before and naw wen una don build di temple again. Make una always dey tink of am.
18 "A partir de hoje, dia vinte e quatro do nono mês, atentem para o dia em que os fundamentos do templo do Senhor foram lançados. Reconsiderem:
19 Una korn, grapevines, fig trees, pomegranates and olive tree nor dey produce food since, but from naw go, I go bless una.”
19 Ainda há alguma semente no celeiro? Até hoje a videira, a figueira, a romeira e a oliveira não têm dado fruto. Mas, de hoje em diante, abençoarei vocês".
20 For dat same day wey bi di twenty fourt day for di mont, God give Haggai anoda message
20 A palavra do Senhor veio a Ageu pela segunda vez, no dia vinte e quatro do nono mês:
21 make e go tell Zerubabel wey bi govnor for Judah: “I go soon shake heaven and eart
21 "Diga a Zorobabel, governador de Judá, que eu farei tremer o céu e a terra.
22 kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.
22 Derrubarei tronos e destruirei o poder dos reinos estrangeiros. Virarei os carros e os seus condutores; os cavalos e os seus cavaleiros cairão, cada um pela espada do seu companheiro".
23 For dat day, I go take yu, Zerubabel, Shealtiel pikin wey bi my savant kon make yu rule with my name, bikos na mi choose yu.”
23 "Naquele dia", declara o Senhor dos Exércitos, "eu o tomarei, meu servo Zorobabel, filho de Sealtiel", declara o Senhor, "e farei de você um anel de selar, porque o tenho escolhido", declara o Senhor dos Exércitos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ageu 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.