Ageu 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
1 No segundo ano do rei Dario, no sexto mês, no primeiro dia do mês, veio a palavra do ­SENHOR por meio do profeta Ageu, a Zorobabel, filho de Sealtiel, governador de Judá, e a Josué, filho de Jozadaque, o sumo sacerdote, dizendo:
2 Oga God wey dey lead Heaven Sojas tell Haggai sey, “Dis pipol dey sey dis nor bi di rite time to build di temple again.”
2 Assim fala o ­SENHOR dos Exércitos, dizendo: Este povo diz: O tempo ainda não é chegado, o tempo em que a casa do ­SENHOR deve ser edificada.
3 So God sey make Profet Haggai go give di pipol dis message:
3 Então veio a palavra do ­SENHOR por meio do profeta Ageu, dizendo:
4 “My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”
4 Acaso é tempo para vós habitardes nas vossas casas forradas, e esta casa fica deserta?
5 Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!
5 Agora portanto, assim diz o ­SENHOR dos Exércitos: Considerai os vossos ­caminhos.
6 Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.
6 Tendes semeado muito, e recolhido pouco; vós comeis, mas não tens o suficiente; bebeis, mas não estais cheios de bebidas; vestis-vos, mas ninguém se aquece; e o que recebe salário, recebe-o para colocá-lo em um saco furado.
7 “God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’
7 Assim diz o Senhor dos Exércitos: Considerai os vossos caminhos.
8 So, make una go di mountins go kut wood kon ribuild di temple; den I go dey happy and belle go sweet mi.”
8 Subi ao monte, e trazei madeira, e edificai a casa; e me agradarei nisso, e serei glorificado, diz o ­SENHOR.
9 “Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.
9 Vós esperastes o muito, e eis que veio a ser pouco; e quando o trouxestes para casa, eu dissipei com um sopro. Por quê? Disse o ­SENHOR dos Exércitos. Por causa da minha casa, que está deserta, e cada homem corre à sua própria casa.
10 Na dis tin make rain nor fall for di eart, so anytin wey una plant, nor dey grow.
10 Portanto o céu sobre vós retém o orvalho, e a terra detém os seus frutos.
11 Yes, I don sey rain nor go fall for una land, hills, farm, vineyard, olive trees and for evritin wey di groun dey produce for una and una animals. I go skata evritin wey una dey work hard to get.”
11 E chamei uma seca sobre a terra, e sobre as montanhas, e sobre o trigo, e sobre o vinho novo, e sobre o azeite, e sobre o que a terra produz; e sobre os homens, sobre o gado, e sobre todo o trabalho das mãos.
12 So, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin with Joshua, Jehozadak pikin wey bi di High Priest and evribody wey kom back from Babilon kon obey Oga God message wey E tell dem thru Profet Haggai and dem kon dey follow and obey God word, well-well.
12 Então Zorobabel, filho de Sealtiel, e Josué, filho de Jozadaque, sumo sacerdote, e todo o restante do povo obedeceram à voz do ­SENHOR seu Deus, e às palavras do profeta Ageu, assim como o ­SENHOR seu Deus o enviara; e o povo temeu diante do ­SENHOR.
13 Den Haggai tell di pipol, “God sey: ‘I promise sey I go dey with una.’ ”
13 Então falou Ageu, o mensageiro do ­SENHOR, a mensagem do ­SENHOR ao povo, dizendo: Eu sou convosco, diz o ­SENHOR.
14 So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work
14 E o ­SENHOR suscitou o espírito de Zorobabel, filho de Sealtiel, governador de Judá, e o espírito de Josué, filho de Jozadaque, sumo sacerdote, e o espírito de todo o restante do povo, e eles vieram, e fizeram a obra na casa do ­SENHOR dos Exércitos, seu Deus,
15 for di twenty fourt day for di sixt mont for di sekond year wey Darius bi king for Persia.
15 No vigésimo quarto dia do sexto mês, no segundo ano do rei Dario.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ageu 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.