2 Timóteo 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 I dey tell yu wetin to do for God and Jesus Christ present. Wen Christ go appear to make en kingdom stand, e go judge pipol wey dey alive and doz wey don die.
1 Conjuro-te diante de Deus e de Cristo Jesus, que há de julgar os vivos e os mortos, pela sua vinda e pelo seu reino;
2 Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.
2 prega a palavra, insta a tempo e fora de tempo, admoesta, repreende, exorta, com toda longanimidade e ensino.
3 Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.
3 Porque virá tempo em que não suportarão a sã doutrina; mas, tendo grande desejo de ouvir coisas agradáveis, ajuntarão para si mestres segundo os seus próprios desejos,
4 Dem go rijet di trut and love lie-lie story.
4 e não só desviarão os ouvidos da verdade, mas se voltarão às fábulas.
5 But make yu kontrol yorsef for evritin. Nor fear to sofa for Christ. Dey do God work and dey tell odas about di Good News.
5 Tu, porém, sê sóbrio em tudo, sofre as aflições, faze a obra de um evangelista, cumpre o teu ministério.
6 For mi, I don already use my life as ofrin for God work, bikos di time wey I go die, don near.
6 Quanto a mim, já estou sendo derramado como libação, e o tempo da minha partida está próximo.
7 I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.
7 Combati o bom combate, acabei a carreira, guardei a fé.
8 Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.
8 Desde agora, a coroa da justiça me está guardada, a qual o Senhor, justo juiz, me dará naquele dia; e não somente a mim, mas também a todos os que amarem a sua vinda.
9 Make yu try yor best to kom si mi soon.
9 Procura vir ter comigo breve;
10 Bikos Demas love dis world tins, e kon run leave mi go Tesalonika. Crescens don go Galatia and Titus go Dalmatia.
10 pois Demas me abandonou, tendo amado o mundo presente, e foi para Tessalônica, Crescente para a Galácia, Tito para a Dalmácia;
11 Na only Luke dey with mi. Make yu karry Mark follow body wen yu dey kom, bikos e go fit help mi for di ministry work.
11 só Lucas está comigo. Toma a Marcos e traze-o contigo, porque me é muito útil para o ministério.
12 I send Tikikus go Efesus.
12 Quanto a Tíquico, enviei-o a Éfeso.
13 Wen yu dey kom, bring di klot wey I leave with Karpus for Troas. Make yu bring my book, especially my papers.
13 Quando vieres traze a capa que deixei em Trôade, em casa de Carpo, e os livros, especialmente os pergaminhos.
14 Alexanda wey dey do iron work, wiked mi well-well, but Christ go judge am for wetin e do.
14 Alexandre, o latoeiro, me fez muito mal; o Senhor lhe retribuirá segundo as suas obras.
15 Make yu dey kareful with am, bikos e fight against evritin wey wi tok.
15 Tu também guarda-te dele; porque resistiu muito às nossas palavras.
16 Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!
16 Na minha primeira defesa ninguém me assistiu, antes todos me desampararam. Que isto não lhes seja imputado.
17 But God dey for my side and E give mi pawa, so dat thru mi, Gentile pipol go hear di Good News and Christ don save mi from lion mout!
17 Mas o Senhor esteve ao meu lado e me fortaleceu, para que por mim fosse cumprida a pregação, e a ouvissem todos os gentios; e fiquei livre da boca do leão,
18 And Christ go still save mi from evry evil plan until e take mi enter en kingdom. Make glory bi en own forever and ever. Amen!
18 E o Senhor me livrará de toda má obra, e me levará salvo para o seu reino celestial; a quem seja glória para todo o sempre. Amém.
19 Make yu help mi greet Priscilla, Akwila and Onesiforus family.
19 Saúda a Prisca e a Áquila e à casa de Onesíforo.
20 Erastus dey for Korint and bikos Trofimus nor well, I kon leave am for Miletus.
20 Erasto ficou em Corinto; a Trófimo deixei doente em Mileto.
21 Make yu try kom before kold sizin go rish. Eubulus, Pudens, Linus, Klaudia and all di brodas and sistas dey greet yu.
21 Apressa-te a vir antes do inverno. Saúdam-te Êubulo, Pudente, Lino, Cláudia, e todos os irmãos.
22 Make Christ dey with yor spirit. Make God grace and favor dey with yu.
22 O Senhor seja com o teu espírito. A graça seja convosco. ^Z
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Timóteo 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.