2 Samuel 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.
1 Prolongou-se por muito tempo a guerra entre a casa de Saul e a de Davi. Mas, à medida que o poder de Davi ia-se fortificando, a casa de Saul ia-se enfraquecendo cada vez mais.
2 Di shidren wey dem born for David for Hebron na:
2 Nasceram filhos a Davi em Hebron. Seu primogênito foi Amnon, de Aquinoã de Jezrael;
3 Kileab wey en mama na Abigail wey bi Nabal wife before and e kom from Karmel;
3 Queleab, o segundo, de Abigail, viúva de Nabal, o carmelita; Absalão, o terceiro, filho de Maaca, filha de Tolmai, rei de Gessur;
4 Adonijah, wey en mama name na Haggit;
4 o quarto, Adonias, filho de Hagit; Safatia, o quinto, filho de Abital,
5 Itream, wey en mama name na Eglah.
5 e o sexto Jetraão, filho de Egla, mulher de Davi. Estes foram os filhos que nasceram a Davi em Hebron.
6 As David men and Saul men kontinue to dey fight, Abner kon popula and get pawa well-well for Saul pipol side.
6 Enquanto durou a guerra entre a casa de Saul e a de Davi, Abner teve autoridade na casa de Saul.
7 One day, Ish-Boshet wey bi Saul pikin kon sey Abner dey sleep with Rizpah wey bi Aiaya pikin wey bi Saul girl-friend.
7 Ora, Saul tinha uma concubina chamada Resfa, filha de Aia. Isboset disse a Abner: Por que te aproximaste da concubina de meu pai?
8 Di tin make Abner vex well-well and e kon sey, “Yu tink sey I go betray Saul? Yu tink sey na Judah I dey serve? I always dey respet Saul wey bi yor papa, en broda and en friend and I make sure sey David nor win una. But today, yu sey I dey sleep with yor papa girl-friend!
8 Abner indignou-se com estas palavras de Isboset e disse: Sou porventura uma cabeça de cão a serviço de Judá? Enquanto neste momento trabalho pela casa de Saul, teu pai, pelos seus irmãos e seus amigos, não os deixando cair nas mãos de Davi, vens tu acusar-me de pecado com esta mulher?
9 Make God ponish mi Abner, If I nor help David get wetin Oga God don promise am.
9 Deus me trate com o maior rigor, se eu não procurar para Davi tudo o que o Senhor lhe prometeu,
10 God go take di kingdom from Saul and en shidren-shidren kon make David king ova Judah and Israel pipol go rish Dan and Beersheba.
10 a saber, tirar a realeza da casa de Saul e firmar o trono de Davi sobre Israel e sobre Judá, desde Dã até Bersabéia!
11 Ish-Boshet kon dey fear Abner sotey, e nor fit tok one word.”
11 Isboset não soube o que responder a Abner, porque o temia.
12 Abner kon send messenjas go meet David wey dey Hebron dat time sey, “Who go rule dis land? Make yu make agriment with mi and I go bring Israel pipol kom yor side.”
12 Abner enviou então mensageiros a Davi, para dizer-lhe: De quem é a terra? Faze aliança comigo e eu te darei mão forte para reunir em torno de ti todo o Israel.
13 David ansa, “Okay! I go make agriment with yu for one kondishon; yu must bring Mikal wey bi Saul dota, anytime wen yu dey kom meet mi.”
13 Davi respondeu: Está bem; farei aliança contigo, mas com uma condição: não te apresentarás diante de mim sem trazer contigo Micol, a filha de Saul, quando vieres ver-me.
14 David still send messenjas go meet Ish-Boshet sey, “Make yu give mi my wife Mikal back, bikos I pay one hundred Filistia pipol skin to take marry am.”
14 Davi enviou mensageiros a Isboset, filho de Saul, para dizer-lhe: Devolve a minha mulher Micol, que desposei ao preço de cem prepúcios de filisteus.
15 So Ish-Boshet kollect am from Paltiel wey bi Laish pikin.
15 Isboset ordenou que a tirassem de seu marido, Faltiel, filho de Lais,
16 Paltiel kry follow am go rish Bahurim town. But Abner sey, “Make yu dey go yor house.” So e kon go.
16 que a acompanhou chorando até Bahurim. Ali, Abner disse-lhe: Volta para a tua casa. E ele voltou.
17 Abner go meet di leaders for Israel kon tell dem, “E don tey wen una wont make David bi una king.
17 Abner pôs-se em contato com os anciãos de Israel e disse-lhes: Já faz tempo que desejais ter Davi por rei.
18 Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”
18 Fazei-o, pois, agora, porque o Senhor disse de Davi: por meio de Davi, meu servo, livrarei o meu povo de Israel da mão dos filisteus e de todos os seus inimigos.
19 Abner still tok to Benjamin tribe kon go Hebron go tell David wetin Benjamin and Israel pipol agri to do.
19 Abner, que havia dito a mesma coisa aos benjaminitas, foi a Hebron para informar Davi de tudo o que fora aceito por Israel e por toda a casa de Benjamim.
20 Wen Abner with twenty men kom meet David for Hebron, David do party for dem.
20 E apresentou-se a Davi, em Hebron, acompanhado de vinte homens. Davi deu um banquete a Abner e seus companheiros.
21 Abner tell David, “My king, I go-go win Israel pipol kom give yu. Dem go take yu as king, den yu go get wetin yu dey find and yu go rule di whole land.” David kon make Abner know sey e dey save and e tell am make e dey go.
21 Disse então Abner a Davi: Irei para reunir ao redor de meu senhor, o rei, todos os israelitas; farão aliança contigo e reinarás sobre toda a terra que quiseres. Davi despediu Abner, que partiu tranqüilamente.
22 Naw Joab and David ofisas dey kom back from fight with many tins wey dem karry. Abner nor dey Hebron with David again, bikos David don tell am make e dey go, sey e dey save.
22 Entretanto, os homens de Davi voltavam com Joab de uma expedição, trazendo uma grande presa. {Abner não estava mais com Davi em Hebron, porque Davi o tinha despedido e ele partira em paz.}
23 Wen Joab and en men kom, dem tell am sey Abner kom meet David and e tell am make e dey go sey e dey save.
23 E, voltando Joab com toda a sua tropa, disseram-lhe que Abner, filho de Ner, viera ter com o rei, e este o deixara ir em paz.
24 So Joab go meet di king kon tell am, “Wetin yu do so? Abner kom meet yu, why yu let am go like dat?”
24 Joab foi ter com o rei e disse-lhe: Que fizeste? Abner, filho de Ner, veio a ti; por que o deixaste partir?
25 “Yu know sey, e kom here kon deceive yu and to know evritin wey yu dey do and anywhere wey yu dey go?”
25 Tu o conheces; {bem sabes que} é para enganar-te, para espiar tuas idas e vindas e sondar tudo o que fazes.
26 Wen Joab leave David, e send messenja go koll Abner and dem bring am back from Sirah well, but David nor know anytin about am.
26 Deixando Davi, Joab mandou emissários atrás de Abner, que o fizeram voltar do poço de Sira, sem que Davi o soubesse.
27 Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
27 Quando Abner chegou a Hebron, Joab, tomou-o à parte, para dentro da porta, como para falar-lhe em particular, e feriu-o ali mortalmente no ventre, vingando o sangue de seu irmão Asael.
28 Wen David hear wetin happen, e sey, “God know sey mi and my men hand nor dey Abner deat.
28 Quando Davi soube do acontecido, exclamou: Sou inocente, eu e o meu reino, diante do Senhor, do sangue de Abner, filho de Ner!
29 But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”
29 Que ele caia sobre a cabeça de Joab e de toda a sua família! Não faltem jamais em sua casa homens atacados de sarna ou lepra, que trabalhem no fuso, caiam pela espada, definhem de fome!
30 Na so Joab and Abishai wey bi en broda take kill Abner, bikos e kill Asahel dia broda for war for Gibeon.
30 Joab e seu irmão Abisaí tinham assassinado Abner por ter este matado seu irmão Asael depois da batalha de Gabaon.
31 Den, David orda Joab and en men sey make dem tear dia klot kon wear sak klot take mourn for Abner. King David follow Abner koffin for back wen dem dey go beri am.
31 Davi disse a Joab e a toda a sua tropa: Rasgai vossas vestes, cobri-vos de sacos e pranteai Abner! E o rei seguiu atrás do féretro.
32 Na for Hebron dem beri Abner and di king with all di pipol kon dey kry for en grave.
32 Sepultaram Abner em Hebron. O rei pôs-se a chorar em alta voz sobre seu túmulo, e todo o povo chorou.
33 David sing dis song for Abner:
33 E Davi cantou a seguinte lamentação, chorando Abner: Devia Abner morrer como morrem os insensatos?!
34 Dem nor tie en hands and legs,
34 Tuas mãos não estavam algemadas, nem acorrentados os teus pés. Caíste como se cai diante de celerados.
35 For morning go rish evening for dat day, di pipol try taya make David for chop sometin, but David don promise sey, “Make God ponish mi, if I chop anytin today!”
35 E o povo chorou sobre ele. Depois, como todo mundo viesse a Davi insistindo em que ele tomasse algum alimento antes de acabar o dia, ele fez este juramento: Que o Senhor me trate com todo o seu rigor, se eu comer pão ou qualquer outra coisa, antes do pôr-do-sol.
36 Dem si wetin David do and all of dem happy well-well. Di pipol like evritin wey David do.
36 Todo o povo o soube e o aprovou, como aliás lhe parecia sempre bom tudo o que o rei fazia.
37 All di pipol for Israel and David pipol kon undastand sey, en hand nor dey for Abner deat.
37 Todo o exército e todo o Israel reconheceu naquele dia que o rei não tivera parte alguma no assassínio de Abner, filho de Ner.
38 Di king tell en ofisas, “Una nor si sey one big leader die komot for Israel today?
38 O rei disse aos seus servos: Não sabeis que um chefe, um grande chefe caiu hoje em Israel?
39 Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”
39 Quanto a mim, sou ainda fraco, embora tenha recebido a unção real. Esses homens, filhos de Sarvia, são mais fortes do que eu. Que o Senhor retribua àqueles que fizeram o mal segundo os seus próprios atos!
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.