2 Samuel 24
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”
1 Mais uma vez, irou-se o Senhor contra Israel. E incitou Davi contra o povo, levando-o a fazer um censo de Israel e de Judá.
2 So David orda Joab wey bi di sojas oga, “Make yu go round Israel tribe with yor ofisas; from one end to anoda for di kountry kon kount di pipol. I won know how dem plenty rish.”
2 Então o rei disse a Joabe e aos outros comandantes do exército: "Vão por todas as tribos de Israel, de Dã a Berseba, e contem o povo, para que eu saiba quantos são".
3 But Joab ansa di king, “My king, make di Oga wey bi yor God make dem plenty hundred times pass as dem bi naw and yu go leave long kon si wen E go do am, but wetin make di king won kount di pipol?”
3 Joabe, porém, respondeu ao rei: "Que o Senhor teu Deus multiplique o povo por cem, e que os olhos do rei, meu senhor, o vejam! Mas, por que o rei, meu senhor, deseja fazer isso? "
4 But di king make Joab and en ofisas obey en kommand, den dem komot go kount Israel pipol.
4 Mas a palavra do rei prevaleceu sobre a de Joabe e dos comandantes do exército; então eles saíram da presença do rei para contar o povo de Israel.
5 Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and
5 E atravessando o Jordão, começaram em Aroer, ao sul da cidade, no vale; depois foram para Gade e de lá para Jazar,
6 from der, dem kon go Gilead and Kadesh for Het aria. Den dem go Dan and from Dan, dem kon go west for Sidon side.
6 Gileade e Cades dos hititas, chegaram a Dã-Jaã e às proximidades de Sidom.
7 Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.
7 Dali seguiram na direção da fortaleza de Tiro e de todas as cidades dos heveus e dos cananeus. Por último foram até Berseba, no Neguebe de Judá.
8 So wen dem don waka for nine monts and twenty days, dem kon kom back to Jerusalem, bikos dem don travel round di kountry.
8 Percorreram todo o país, e voltaram a Jerusalém ao fim de nove meses e vinte dias.
9 Dem tell di king about all di men wey fit do soja work and dem bi 800,000 from Israel and 500,000 from Judah.
9 Então Joabe apresentou ao rei o relatório do recenseamento do povo; havia em Israel oitocentos mil homens habilitados para o serviço militar, e em Judá, quinhentos mil.
10 But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
10 Depois de contar o povo, Davi sentiu remorso e disse ao Senhor: "Pequei gravemente com o que fiz! Agora, Senhor, eu imploro que perdoes o pecado do teu servo, porque cometi uma grande loucura! "
11 Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem
11 Levantando-se Davi pela manhã, o Senhor já tinha falado a Gade, o vidente dele:
12 and I go do anytin wey e choose.”
12 "Vá dizer a Davi: ‘Assim diz o Senhor: Estou lhe dando três opções de punição; escolha uma delas, e eu a executarei contra você’ ".
13 Gad go meet and tell am wetin God tok, so e kon ask, “Wish one yu wont make God do? Three years wey honga go dey di land; three monts wey una go take run from una enemies or three days wey bad sickness go dey yor land? Naw, make yu tink am kon tell mi di ansa wey I go-go give God.”
13 Então Gade foi a Davi e lhe perguntou: "O que você prefere: três anos de fome em sua terra; três meses fugindo de seus adversários, que o perseguirão; ou três dias de praga em sua terra? Pense bem e diga-me o que deverei responder àquele que me enviou".
14 David ansa, “I dey for bad kondishon, but I nor wont make men ponish mi, instead make only God ponish us, bikos E get mesi.”
14 Davi respondeu: "É grande a minha angústia! Prefiro cair nas mãos do Senhor, pois grande é a sua misericórdia, e não nas mãos dos homens".
15 So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel.
15 Então o Senhor enviou uma praga sobre Israel, desde aquela manhã até a hora que tinha determinado. E morreram setenta mil homens do povo, de Dã a Berseba.
16 Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.
16 Quando o anjo estendeu a mão para destruir Jerusalém, o Senhor arrependeu-se de trazer essa catástrofe, e ele disse ao anjo destruidor: "Pare! Já basta! " Naquele momento o anjo do Senhor estava perto da eira de Araúna, o jebuseu.
17 David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
17 Ao ver o anjo que estava matando o povo, disse Davi ao Senhor: "Fui eu que pequei e cometi iniqüidade. Estes não passam de ovelhas. O que eles fizeram? Que o teu castigo caia sobre mim e sobre a minha família! "
18 Dat day, Profet Gad go meet David kon tell am, “Make yu go Araunah farm kon build altar for der for di Oga yor God.”
18 Naquele mesmo dia Gade foi dizer a Davi: "Vá e edifique um altar na eira de Araúna, o jebuseu".
19 David obey and e do evritin wey Profet Gad tell am.
19 Davi foi para lá, em obediência à ordem que Gade tinha dado em nome do Senhor.
20 Wen Araunah look kon si di king and en ofisas dey kom meet am, e liedan for groun for David front
20 Quando Araúna viu o rei e seus soldados vindo ao encontro dele, saiu e prostrou-se perante o rei, rosto em terra,
21 kon ask, “My king, why yu kom here?”
21 e disse: "Por que o meu senhor e rei veio ao seu servo? " Respondeu Davi: "Para comprar sua eira, e edificar nela um altar ao Senhor, para que cesse a praga no meio do povo".
22 But Araunah ansa, “My king, make yu take am! Make yu use am do anytin wey yu like kon burn dis melu give God for di altar. Make yu use dia yoke and dis firewood for di ofrin.”
22 Araúna disse a Davi: "O meu senhor e rei pode ficar com o que quiser e ofereça-o em sacrifício. Aqui estão os bois para o holocausto, e o debulhador e o jugo dos bois para a lenha.
23 Araunah give di king evritin kon sey, “Make di Oga wey bi yor God asept yor ofrin.”
23 Ó rei, eu dou tudo isso a ti". E acrescentou: "Que o Senhor teu Deus aceite a tua oferta".
24 But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.”
24 Mas o rei respondeu a Araúna: "Não! Faço questão de pagar o preço justo. Não oferecerei ao Senhor meu Deus holocaustos que não me custem nada". Davi comprou, pois, a eira e os bois por cinqüenta peças de prata.
25 Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.
25 E Davi edificou ali um altar ao Senhor e ofereceu holocaustos e sacrifícios de comunhão. Então o Senhor aceitou as súplicas em favor da terra, e a praga parou de destruir Israel.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.