2 Samuel 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey,
1 Aconteceu que estava ali um sujeito ordinário, chamado Seba, filho de Bicri, da tribo de Benjamim. Ele tocou a corneta para reunir o povo e gritou: — Abaixo Davi! Não temos nada a ver com ele! Não adianta nada segui-lo! Homens de Israel, vamos voltar para casa!
2 So Israel pipol leave David kon follow Sheba, but Judah men obey and follow David from Jordan River go Jerusalem.
2 Então todos os israelitas abandonaram Davi e foram com Seba. Mas os homens de Judá ficaram fiéis a Davi e o seguiram desde o rio Jordão até a cidade de Jerusalém.
3 Wen David rish en palis for Jerusalem, e take en ten girl-friends wey e leave make dem kare for di place kon sey make dem guide dem. E give dem evritin wey dem wont, but e nor sleep with dem. And still dem die, e keep dem like wimen wey dia husband don die.
3 Davi foi para o seu palácio em Jerusalém e colocou numa casa guardada por soldados as dez concubinas que havia deixado tomando conta do palácio. Ele lhes deu tudo o que precisavam, porém não teve relações com elas. E elas foram obrigadas a ficar dentro de casa o resto da vida vivendo como viúvas.
4 Di king tell Amasa, “Make yu koll all Judah men kom meet mi di day afta tumoro.”
4 O rei disse a Amasa: — Convoque todos os homens de Judá e esteja aqui de volta com eles depois de amanhã.
5 So Amasa go koll dem, but e nor kom back wen di king sey make e kom.
5 Amasa saiu para convocar os homens, porém não voltou no dia que o rei havia marcado.
6 So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”
6 Então Davi disse a Abisai: — Seba vai nos dar mais trabalho do que Absalão. Pegue os meus homens e vá atrás dele; se não, ele poderá tomar algumas cidades cercadas de muralhas e escapar de nós.
7 So Joab men, di king bodyguard and all di oda sojas komot from Jerusalem with Abishai go find Sheba.
7 Então os homens de Joabe, os queretitas e os peletitas e os soldados mais valentes seguiram Abisai. Eles saíram de Jerusalém para perseguir Seba.
8 Wen dem rish di big rock for Gibeon, Amasa kon si dem. Joab wear en war klot kon tie e swod with en belt. As e waka go front small, en swod kon fall.
8 Quando chegaram à pedra grande, na cidade de Gibeão, Amasa encontrou-se com eles. Joabe estava vestido com roupa de guerra e tinha uma espada na bainha, que levava pendurada no cinto. Quando ele avançou, a espada caiu.
9 Joab kon tell. Amasa, “My friend, how yu dey?” E kon hold en hair with en rite hand like sey e won kiss am.
9 Então Joabe disse a Amasa: — Como vai, meu amigo? E pegou na barba de Amasa com a mão direita para beijá-lo.
10 Amasa nor protet ensef against di swod wey Joab hold for en oda hand, so Joab shuk am for belle and en intestine kom out. Amasa just die at wons and Joab nor nid to shuk am again. Den Joab and Abishai, en broda kon go find Sheba.
10 Amasa não reparou que Joabe tinha uma espada na outra mão. Então Joabe enfiou a espada na barriga de Amasa, e os seus intestinos saíram e se esparramaram pelo chão. Ele morreu na mesma hora: Joabe não teve de feri-lo uma segunda vez. Em seguida Joabe e o seu irmão Abisai continuaram a perseguir Seba.
11 One of Joab men stand near Amasa dead body bigin shaut, “All di pipol wey dey Joab and David side, make una follow Joab!”
11 Um dos soldados de Joabe ficou perto do corpo de Amasa e gritou: — Todos os que estão do lado de Joabe e são a favor de Davi, sigam Joabe!
12 Amasa body dey di road centre and en blood spread around am. Wen Joab men si sey evribody dey stop wen dem si di body, dem drag di body enter di bush korna kon kover am with klot.
12 O corpo de Amasa ficou estendido no meio da estrada, coberto de sangue. O ajudante de Joabe viu que todos estavam parando; então arrastou o corpo para fora da estrada e estendeu um cobertor sobre ele porque todos os que o viam paravam.
13 Wen dem don remove di body from di road, evribody kon follow Joab porshu Sheba.
13 Depois que o corpo foi tirado da estrada, todos foram com Joabe perseguir Seba.
14 Sheba run pass all Israel pipol aria go Abel-Bet Maaka town and all di pipol for Bikri village gada follow am enter di town.
14 Seba atravessou as terras de todas as tribos de Israel e foi parar na cidade de Abel-Bete-Maacá. Todas as pessoas do grupo de famílias de Bicri se reuniram e foram com ele para dentro da cidade.
15 Wen Joab men hear sey Sheba dey der, dem kon build tick wall round di town, so Joab men kon bigin dig di wall so dat e go skata fall.
15 Os soldados de Joabe chegaram e cercaram a cidade. Eles construíram rampas de terra encostadas nas muralhas e também começaram a cavar debaixo da muralha para fazê-la cair.
16 E get one woman wey get sense well-well for di town, so e shaut from di wall sey, “Make una listin! Make una listin! Make una tell Joab make e kom here, bikos I won tok to am.”
16 Havia na cidade uma mulher muito esperta. Ela gritou do muro: — Escutem! Escutem! Digam a Joabe para vir aqui, que eu quero falar com ele!
17 Joab go meet am and di woman sey, “Na yu bi Joab?”
17 Joabe foi, e ela perguntou: — Você é Joabe? — Sim, sou! — respondeu ele. — Escute, senhor! — disse ela. — Estou escutando! — respondeu ele.
18 Di woman sey, “Before-before, dem bi dey sey, ‘Go get yor ansa for Abel town’ and dat na di only tin wey dem sabi do.
18 Então ela disse: — Antigamente costumavam dizer: “Vão e peçam conselhos na cidade de Abel”; e era assim que resolviam os problemas.
19 Awa town na big one wey get peace and pipol dey respet us for Israel. Why yu won distroy am? Yu won skata wetin bi God own?”
19 A nossa cidade é grande e uma das mais pacíficas e leais de Israel. Por que você está tentando destruí-la? Você quer arrasar o que pertence a Deus, o Senhor ?
20 Joab ansa, “No o-o! I nor go fit distroy una town!
20 — Nunca! — respondeu Joabe. — Eu nunca destruirei, nem arrasarei a sua cidade!
21 Nor bi awa plan bi dat. One man wey dem dey koll Sheba wey bi Bikri pikin, wey kom from Efraim hill kountry, naim start di fight with King David. If una bring dis man kom out, I go leave una town.”
21 O nosso plano não é esse. Um homem da região montanhosa de Efraim, chamado Seba, filho de Bicri, começou uma revolta contra Davi, o nosso rei. Entreguem só esse homem, e eu irei embora. — Nós jogaremos a cabeça dele por cima da muralha para você! — disse ela.
22 Den e go meet di town pipol with en plan, so dem kut Sheba head kon trow am go give Joab for di oda side for di wall. Joab blow en trumpet take tell en men sey make dem leave di town and dem kon go house go meet di king for Jerusalem.
22 Aí ela foi dar o seu conselho ao povo da cidade. E eles cortaram a cabeça de Seba e a jogaram por cima do muro para Joabe. Ele tocou a corneta, reuniu os homens, e todos deixaram a cidade e voltaram para casa. E Joabe voltou para perto do rei Davi, em Jerusalém.
23 Na Joab dey kommand Israel pipol soja, while Benaya wey bi Jehoiada pikin dey kontrol David bodyguard.
23 Joabe era o comandante do exército de Israel; Benaías, filho de Joiada, era o chefe dos queretitas e dos peletitas .
24 Adoniram dey kontrol doz wey dey work and na Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep di rekord.
24 Adonirão era responsável pelos homens condenados a trabalhos forçados; Josafá, filho de Ailude, era o conselheiro do rei.
25 Na Sheva bi di kourt seketry, while Zadok and Abiatar na priests
25 Seva era o escrivão. Zadoque e Abiatar eram os sacerdotes.
26 and Ira wey kom from Jair town still dey among David priests.
26 Ira, da cidade de Jair, também era um dos sacerdotes de Davi.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.