2 Samuel 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Dem kon tell Joab sey David dey kry and mourn for Absalom.
1 E foram dizer a Joab: Eis que o rei chora e se lamenta por causa de Absalão.
2 So, instead make di sojas dey happy sey dem win, all of dem kon dey mourn, bikos dem hear sey di king dey kry for en pikin.
2 E a vitória se transformou em luto naquele dia para todo o exército, porque o povo ouvira dizer que o rei estava acabrunhado de dor por causa de seu filho.
3 Dem kwayet enter di town with shame like sojas wey dem win for war.
3 Por isso, o exército entrou na cidade em silêncio, como faria um exército coberto de vergonha por ter fugido ao combate.
4 Di king kover en face bigin kry dey sey, “O-o my pikin! O-o my pikin Absalom! Absalom my pikin!”
4 Entretanto o rei, cobrindo a cabeça, dizia em alta voz: Meu filho Absalão! Absalão, meu filho, meu filho!
5 Joab go di king house kon tell am, “Today, yu don disgrace yor men, di men wey save yu, yor shidren, wifes and yor girl-friends.
5 Veio então Joab à casa do rei, e disse-lhe: Tu cobres hoje de confusão a face de todos os teus servos que salvaram a tua vida, a vida de teus filhos e filhas, de tuas mulheres e concubinas.
6 Yu dey oppoz doz wey love yu kon support doz wey hate yu! Yu don make am klear sey yor ofisas and men know mean anytin to yu. I si sey yu go dey happy if to sey na wi die and Absalom dey life.
6 Tu amas os que te odeiam e odeias os que te amam, e mostras que os teus chefes e teus servos nada valem para ti. Estou vendo que te darias por satisfeito, se Absalão vivesse e nós fôssemos todos mortos!
7 Naw, make yu go make yor men heart strong. I use God name take swear sey if yu know go meet dem, nobody go stay here with yu dis nite. Na dat go bi di worse wahala wey yu go ever si for yor life.”
7 Vamos: sai e dirige aos teus servos palavras de reconforto, pois juro-te por Deus que, se não o fizeres, não ficará contigo esta noite homem algum. E isso seria para ti uma desgraça maior do que todas que vieram sobre ti desde a tua juventude!
8 Den di king get up go sidan for di gate. Wen dem tell all di pipol sey di king sidan for di gate, all of dem kon go meet am. But all di men for Israel don go back to dia house.
8 Então levantou-se o rei e foi sentar-se à porta. Foi avisado a todo o exército: Eis que o rei está sentado à porta. E todo o exército veio apresentar-se a ele. Os israelitas tinham fugido cada qual para a sua casa.
9 All di pipol for Israel kon dey kworel among demsef sey, “King David save us from awa enemies. E save us from Filistia pipol, but naw, e don run komot from di kountry bikos of Absalom.
9 Em todas as tribos se discutia, dizendo: O rei que nos salvara das mãos de nossos inimigos e da mão dos filisteus, agora teve de fugir da terra diante de Absalão.
10 Wi anoint Absalom make e bi awa king, but dem don kill-am for war. So why wi nor go-go bring David back?”
10 Ora, Absalão, a quem tínhamos sagrado rei sobre nós, morreu no combate. Por que tardais em fazer voltar o rei?
11 David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?
11 O rei Davi mandou aos sacerdotes Sadoc e Abiatar a seguinte mensagem: Eis o que direis aos anciãos de Judá: Por que seríeis vós os últimos a reconduzir o rei para a sua casa? E chegou aos ouvidos do rei o que se dizia em todo o Israel.
12 Na una bi my relashon, my flesh and blood, why una go bi di last tribe wey go bring mi kom back?”
12 Vós sois meus irmãos, meus ossos e minha carne. Por que seríeis vós os últimos a reconduzir o rei?
13 David still tell dem make dem tell Amasa, “Una bi my own relashon, from today go, I dey put yu for Joab place make yu rule my sojas. Make God ponish mi if I nor do wetin I tok!”
13 Direis em seguida a Amasa: Tu és meu osso e minha carne. Que Deus me trate com todo o rigor, se eu não te tornar para sempre o meu general em lugar de Joab.
14 So wetin David tok, enter Judah men heart and dem obey am kon send message go meet en and all en ofisas make dem kom back.
14 Todos os homens de Judá sentiram unanimemente o seu coração voltar-se para o rei, e mandaram-lhe dizer: Volta com todos os teus!
15 Wen David dey go back, e kon si Judah men for Jordan River and dem kom Gilgal kon escort am cross di river.
15 O rei voltou. Chegando ao Jordão, eis que todo o Judá tinha acorrido a Gálgala para ir-lhe ao encontro e fazê-lo passar o Jordão.
16 For dat time, Shimei from Benjamin tribe wey bi Gera pikin wey dey stay Bahurim kon run go Jordan River go meet David.
16 Semei, filho de Gera, o benjaminita de Baurim, com seus quinze filhos e os vinte servos, apressou-se a vir ao encontro do rei Davi.
17 E take 1,000 men from Benjamin tribe, Ziba wey bi savant for Saul family, en fifteen sons and twenty savants go meet di king for Jordan River.
17 Levava consigo mil homens de Benjamim, assim como Siba, servo da família de Saul, com seus quinze filhos e vinte servos. E correram rumo ao Jordão antes do rei,
18 Dem escort di king and en pipol cross di river and dem do evritin wey di king wont. As di king won cross, Shimei fall for di king front
18 e dispuseram tudo para fazer passar a família do rei e prestar-lhe todos os serviços que desejassem. Semei, filho de Gera, atirou-se aos pés do rei no momento em que ele ia passar o Jordão
19 kon sey, “My king, abeg, make yu forget all di bad tins wey I do dat day wey yu komot from Jerusalem, nor kount am against mi or tink am at-all.
19 e disse-lhe: Que o meu senhor não me impute culpa, nem guarde em seu coração a lembrança do crime que cometeu o teu servo no dia em que o rei, meu senhor, deixou Jerusalém.
20 My oga, I know sey I don sin and na dis make mi bi di first pesin from Josef tribe wey kom meet yu, my king.”
20 Teu servo reconhece o seu pecado, e por isso vim hoje, o primeiro de toda a casa de José, ao encontro do rei, meu senhor!
21 Abishai wey bi Zeruaya pikin kon sey, “Make dem kill Shimei, bikos e curse di pesin wey God choose to bi king.”
21 Abisai, filho de Sarvia, tomou a palavra: Não se deverá antes matar Semei, por ter amaldiçoado o ungido do Senhor?
22 But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”
22 Que eu tenho convosco, ó filhos de Sarvia, respondeu Davi; para que vos comporteis no dia de hoje como meus inimigos? Porventura um só israelita há de ser morto num dia como o de hoje? Ignoro acaso que sou agora rei de Israel?
23 Den e tell Shimei, “I promise yu sey nobody go kill yu.”
23 E disse a Semei: Não morrerás! E prometeu-lho com juramento.
24 Den Mefiboshet wey bi Saul grand-pikin, kom meet di king. E neva wosh en leg; kut en hair or wosh en klot since di time wey di king komot from Jerusalem till naw wey e dey kom back with viktory.
24 Mifiboset, filho de Saul, desceu também ao encontro do rei. Não tinha lavado os pés nem as mãos, nem feito a barba, nem lavado as suas vestes, desde o dia em que o rei partira até o dia em que ele voltou em paz.
25 Wen Mefiboshet meet di king from Jerusalem, di king tell am, “Mefiboshet, why yu nor follow mi go?”
25 Quando, pois, chegou de Jerusalém vindo ao encontro do rei, Davi disse-lhe: Por que não partiste comigo, Mifiboset?
26 E ansa, “My king, yu know sey I nor fit waka. I tell my savant make e karry mi for donkey follow yu, but e run leave mi.
26 Meu senhor e rei, respondeu ele, o meu criado enganou-me. Pois eu, teu servo, dissera-lhe que me selasse a jumenta para que eu a montasse e partisse com o rei, porque o teu servo é paralítico.
27 E tell di king lie about mi, but yu bi like God angel, so make yu do wetin dey good for mi.
27 Ele, porém, caluniou-me junto do rei, meu senhor. Mas o rei, meu senhor, é como um anjo de Deus; faze o que te parecer bom.
28 E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”
28 Toda a família de meu pai merecia a morte, diante do meu senhor e rei e, no entanto, admitiste o teu servo entre os que comem à tua mesa. Com que direito posso eu ainda suplicar ao rei?
29 Di king ansa, “Make yu nor tok again. I don tok before sey, yu and Ziba go divide Saul propaty.”
29 Para que tantas palavras?, respondeu o rei. Eu declaro que tu e Siba repartireis os bens.
30 Mefiboshet ansa, “Make Ziba take evritin! My king, as yu kom house save, dat one don do for mi.”
30 Ele pode até mesmo ficar com tudo, replicou Mifiboset, uma vez que o rei, meu senhor, voltou em paz para a sua casa.
31 Barzillai wey kom from Gilead still kom from Rogelim make e for escort di king cross Jordan River.
31 Berzelai, o galaadita, desceu de Rogelim e acompanhou o rei, escoltando-o até o Jordão.
32 Dat time, Barzillai na eighty years; e get money well-well and e feed di king wen e dey for Mahanaim.
32 Era já muito velho, com oitenta anos. Sendo muito rico, abastecera o rei durante todo o tempo que esteve em Maanaim.
33 So di king tell am, “Make yu follow mi go Jerusalem and I go kare for yu.”
33 O rei disse-lhe: Vem comigo, e te sustentarei junto de mim em Jerusalém!
34 But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?
34 Mas Berzelai disse ao rei: Quantos anos viverei ainda, para que suba com o rei a Jerusalém?
35 I don old rish eighty years and nor-tin dey make mi happy again, I nor dey taste or enjoy wetin I dey chop or drink and I nor dey hear pipol wen dem dey sing again. So if I follow yu go, na wahala I go just bi to yu.
35 Tenho agora oitenta anos, e já não distingo entre o bom e o que não o é. Já não posso saborear o que como e o que bebo, e não ouço mais a voz dos cantores e cantoras. Por que iria o teu servo servir de peso ao rei, meu senhor?
36 Dat kind big reward nor fit mi. So I go follow yu pass Jordan River small.
36 Teu servo só andou um pedaço de caminho com o rei, e por que lhe haveria o rei de dar semelhante recompensa?
37 Make yu let mi go house go die near my papa and mama grave. Si Kimham my pikin, make e serve yu. My king, make e follow yu, den do wetin yu know sey dey good for am.”
37 Deixa que teu servo volte, para morrer em minha cidade, junto ao túmulo de meu pai e de minha mãe. Eis, porém, o teu servo Camaão; ele irá com o rei, meu senhor: faze dele o que te parecer melhor.
38 Di king ansa, “I go take am follow body kon do wetin yu wont for am. I go do anytin wey yu ask.”
38 Que ele venha comigo, respondeu o rei; far-lhe-ei tudo o que te agradar; e a ti também, conceder-te-ei tudo o que desejares de mim.
39 Den David and all en men cross Jordan River. E kiss and bless Barzillai and Barzillai kon go back to en house.
39 Todos passaram o Jordão diante do rei que permaneceu de pé. Davi beijou Berzelai, abençoou-o, e Berzelai voltou para a sua casa.
40 Wen all di men for Judah and half of di men for Israel don escort di king cross, David kon go Gilgal. Kimham wey bi Barzillai pikin, follow am go.
40 O rei chegou a Gálgala, e Camaão passou com ele. Todo o povo de Judá e a metade do povo de Israel acompanharam o rei.
41 Den Israel pipol go meet di king kon sey, “Awa king, wetin make awa brodas for Judah hide escort yu, yor family and yor men cross Jordan River?”
41 E eis que todos os homens de Israel vieram ter com o rei, dizendo-lhe: Por que te tomaram os nossos irmãos, os filhos de Judá, fazendo-te passar o Jordão com toda a tua família, quando são todos os homens de Davi que formam o teu povo?
42 Judah men ansa, “Wi do am, bikos di king na one of us. So, wetin make una dey vex? Nor bi sey e don pay for awa food or give us anytin.”
42 Então responderam os filhos de Judá aos israelitas: É que o rei nos é mais próximo. Por que vos irritais com isso? Acaso temos comido algo do rei, ou tirado para. nós algum proveito?
43 Israel pipol ansa, “Even doh David bi one of una, wi get am ten times, pass as una get am. Why una dey look us like sey wi bi small pikin or sey wi nor mean anytin? Make una nor forget sey, Na wi first sey make dem bring di king kom back!”
43 Mas os homens de Israel responderam aos de Judá: Temos dez partes no rei, além disso somos vossos irmãos mais velhos. Por que nos desprezastes? Não fomos nós os primeiros a tomar a palavra e a mandar chamar o nosso rei? Os homens de Judá falaram mais duramente ainda que os de Israel.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.