2 Samuel 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Afta sometaim, Ahitofel tell Absalom, “Make I choose 12,000 men wey go-go find David dis nite.
1 Disse mais Aitofel a Absalão: Deixa-me escolher doze mil homens, e me levantarei, e perseguirei a Davi esta noite.
2 I go attack am wen e don taya and dey konfuse. E go fear and all en men go run, den I go kill only di king.
2 Irei sobre ele, enquanto está cansado, e fraco de mãos, e o espantarei: então fugirá todo o povo que está com ele. Ferirei tão-somente o rei;
3 I go bring all en men kon give yu like new wife wey dey go meet en husband. Na only one man yu won kill and all di rest pipol go dey save.”
3 e farei tornar a ti todo o povo, como uma noiva à casa do seu esposo; pois é a vida dum só homem que tu buscas; assim todo o povo estará em paz.
4 Absalom and all Israel leaders like di advise.
4 E este conselho agradou a Absalão, e a todos os anciãos de Israel.
5 So Absalom sey, “Make una koll Hushai make wi hear wetin e won tok.”
5 Disse, porém, Absalão: Chamai agora a Husai, o arquita, e ouçamos também o que ele diz.
6 Wen Hushai kom, Absalom tell am, “Si di advise wey Ahitofel give us, make wi follow am? If yu nor gri, tell us wetin wi go do.”
6 Quando Husai chegou a Absalão, este lhe disse: Desta maneira falou Aitofel; faremos conforme a sua palavra? Se não, fala tu.
7 Hushai ansa, “Di advise wey Ahitofel give yu dis time nor good.
7 Então disse Husai a Absalão: O conselho que Aitofel deu esta vez não é bom.
8 Yu know sey, David yor papa and en men strong well-well for fight, like bear for bush wey dey find en pikin. Yor papa na soja wey get sense and e nor dey stay with en men for nite.
8 Acrescentou Husai: Tu bem sabes que teu pai e os seus homens são valentes, e que estão com o espírito amargurado, como a ursa no campo, roubada dos seus cachorros; além disso teu pai é homem de guerra, e não passará a noite com o povo.
9 E fit hide for kage and oda place dis time. If David attack and win yor men, anybody wey go hear am go sey, dem don win una.
9 Eis que agora está ele escondido nalguma cova, ou em qualquer outro lugar; e será que, caindo alguns no primeiro ataque, todo o que o ouvir dirá: Houve morticínio entre o povo que segue a Absalão.
10 Den all di men wey dey strong like lion go dey fear, bikos evribody for Israel know sey yor papa na great soja and en men dey fight well-well.
10 Então até o homem valente, cujo coração é como coração de leão, sem dúvida desmaiará; porque todo o Israel sabe que teu pai é valoroso, e que são valentes os que estão com ele.
11 “I dey advise yu sey make yu bring all Israel pipol togeda, even doh dem many like san for wotaside kon skata for evriwhere for di kountry. Make yu yorsef lead dem go di war.
11 Eu, porém, aconselho que com toda a pressa se ajunte a ti todo o Israel, desde Dã até Berseba, em multidão como a areia do mar; e que tu em pessoa vás à peleja.
12 Wi go find and attack David for anywhere wey e dey, before e go know wetin dey happen. Nobody among en and en men go survive.
12 Então iremos a ele, em qualquer lugar em que se achar, e desceremos sobre ele, como o orvalho cai sobre a terra; e não ficará dele e de todos os homens que estão com ele nem sequer um só.
13 If e enter any town, awa pipol go use rope pul di town fall for di valley. No stone go remain for di hill top.”
13 se ele, porém, se retirar para alguma cidade, todo o Israel trará cordas àquela cidade, e arrastá-la-emos até o ribeiro, até que não se ache ali nem uma só pedrinha
14 Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.
14 Então Absalão e todos os homens e Israel disseram: Melhor é o conselho de Husai, o arquita, do que o conselho de Aitofel: Porque assim o Senhor o ordenara, para aniquilar o bom conselho de Aitofel, a fim de trazer o mal sobre Absalão.
15 Den Hushai tell Zadok and Abiatar wey bi priest about di advise wey e give Israel leaders and di advise wey Ahitofel give dem.
15 Também disse Husai a Zadoque e a Abiatar, sacerdotes: Assim e assim aconselhou Aitofel a Absalão e aos anciãos de Israel; porém eu aconselhei assim e assim.
16 Hushai still sey, “Make una kwik dey go naw kon tell David make e nor stay for where e dey dis nite for di desert, but make e cross Jordan River, so dat dem nor go kill en and en men.”
16 Agora, pois, mandai apressadamente avisar a Davi, dizendo: Não passes esta noite nos vaus do deserto; mas passa sem falta à outra banda, para que não seja devorado o rei, e todo o povo que com ele está.
17 Abiatar pikin, Jonatan and Zadok pikin, Ahimaaz bin dey wait for En-Rogel wotaside wey dey for Jerusalem ending, bikos dem nor fit enter di town. One girl wey bi savant dey go tell dem wetin dey happen all di time and dem go-go tell David.
17 Ora, Jônatas e Aimaaz estavam esperando junto a En-Rogel; e foi uma criada, e lhes avisou, para que eles fossem e o dissessem ao rei Davi; pois não deviam ser vistos entrando na cidade.
18 But one day, one boy si dem kon go tell Absalom, so dem kon go hide for one man house for Bahurim. Dem hide inside di well wey dey en kompond.
18 Viu-os todavia um moço, e avisou a Absalão. Ambos, porém, partiram apressadamente, e entraram em casa de um homem, em Baurim, o qual tinha no pátio de sua casa um poço, para o qual eles desceram.
19 Di man wife kon use sometin kover di well, den spread rice put, so dat nobody go know wetin dey der.
19 E a mulher, tomando a tampa, colocou-a sobre a boca do poço, e espalhou grão triturado sobre ela; assim nada se soube.
20 Absalom ofisas kom di house kon ask di woman, “Where Ahimaaz and Jonatan?”
20 Chegando, pois, os servos de Absalão àquela casa, perguntaram à mulher: Onde estão Aimaaz e Jônatas? Respondeu-lhes a mulher: Já passaram a corrente das águas. E, havendo-os procurado sem os encontrarem, voltaram para Jerusalém.
21 Afta dem don komot, Jonatan and Ahimaaz kom out from di well go tell David wetin dey happen. Dem tell am wetin Ahitofel plan against am kon sey, “Oga, make wi kwik-kwik cross di river.”
21 Depois que eles partiram, Aimaaz e Jônatas, saindo do poço, foram e avisaram a Davi; e disseram-lhe: Levantai-vos, e passai depressa as águas, porque assim e assim aconselhou contra vós Aitofel.
22 So David and all en men bigin cross Jordan River before day break.
22 Então se levantou Davi e todo o povo que com ele estava, e passaram o Jordão; e ao raiar da manhã não faltava nem um só que não o tivesse passado.
23 Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.
23 Vendo, pois, Aitofel que não se havia seguido o seu conselho, albardou o jumento e, partindo, foi para casa, para a sua cidade; e, tendo posto em ordem a sua casa, se enforcou e morreu; e foi sepultado na sepultura de seu pai.
24 For di time wey Absalom and Israel pipol cross Jordan River, David don already rish Mahanaim town.
24 Então Davi veio a Maanaim; e Absalão passou o Jordão, ele e todos os homens de Israel com ele.
25 Absalom sey make Amasa take Joab place as di sojas oga. Amasa na Itra pikin wey kom from Ishmael tribe and en mama name na Abigail, Nahash pikin. Zeruaya wey born Joab, na en sista bi Nahash.
25 E Absalão colocou Amasa em lugar de Joabe sobre o exército. Ora, Amasa era filho de um homem que se chamava Itra, o jizreelita, o qual entrara a Abigail, filha de Naás e irmã de Zeruia, mãe de Joabe.
26 Absalom and en men kamp for Gilead town.
26 Israel e Absalão se acamparam na terra de Gileade.
27 Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.
27 Tendo Davi chegado a Maanaim, Sobi, filho de Naás, de Rabá dos filhos de Amom, e Maquir, filho de Amiel, de Lo-Debar, e Barzilai, o gileadita, de Rogelim,
28 Dem bring basin, pots and bed shit kom gi-am. Dem still bring food: wheat, barley, grain wey dem roast, beans, peas, honey, cheese, cream and some sheep kom give David and en men.
28 tomaram camas, bacias e vasilhas de barro; trigo, cevada, farinha, grão tostado, favas, lentilhas e torradas;
29 Dem know sey David and en men go dey hongry and wota don dey hongry dem since for di wildaness.
29 mel, manteiga, ovelhas e queijos de vaca, e os trouxeram a Davi e ao povo que com ele estava, para comerem; pois diziam: O povo está faminto, cansado e sedento, no deserto.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.