2 Samuel 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Afta dis, Absalom make war horse dem for ensef with fifty men wey go escort am.
1 Depois disso Absalão adquiriu para si um carro, cavalos e cinqüenta homens para escoltaram-no.
2 For early morning, e go-go stand for road near di town gate and anytime pesin won kom meet di king make e setol dia kworel, Absalom go koll and ask am where e from kom. And wen di man don tell am di tribe wey e kom from,
2 Colocava-se desde cedo à beira do caminho, junto à grande porta, e interpelava todos os que vinham procurar o rei para um julgamento, dizendo: De que cidade és tu? O outro respondia: Teu servo é de tal tribo de Israel.
3 Absalom go tell am, “Si, una dey rite for wetin una dey do, but e nor get anybody wey won ripresent di king make e for listin to una.”
3 Vê, dizia-lhe Absalão; a tua causa é boa e justa; mas não há ninguém para te ouvir da parte do rei.
4 E go sey, “If to sey dem go make mi judge for dis land, den anybody wey get kworel go kom meet mi and I go make sure sey dem judge en kase well.”
4 E Absalão ajuntava: Oh, quem me dera ser juiz desta terra! Todo o que tivesse um litígio ou uma questão e viesse ter comigo, eu lhe faria justiça.
5 Wen anybody waka go bow for Absalom, e go hold di pesin stand up kon kiss am.
5 E se alguém se aproximava para se prostrar diante dele, estendia a mão, detinha-o e beijava-o.
6 E dey do like dis to evribody for Israel wey dey kom meet di king make e judge dia matter. Like dis, evribody for Israel kon dey respet am.
6 Assim fazia Absalão com todos os israelitas que vinham procurar o rei para qualquer julgamento. E desse modo conquistou os corações dos israelitas.
7 Afta four years, Absalom tell en papa David, “My oga, make I go Hebron go do wetin I promise God.
7 Quatro anos se passaram. Absalão disse ao rei: Deixa-me ir a Hebron para cumprir ali uma promessa que fiz ao Senhor.
8 Wen I dey Geshur for Siria, I promise God sey, if E bring mi kom back to Jerusalem, I go-go Hebron go woship am.”
8 Quando o teu servo estava em Gessur, fez este voto: se Senhor me reconduzir a Jerusalém, irei prestar-lhe culto em Hebron.
9 Di king ansa, “Make peace follow yu.” So Absalom kon go Hebron.
9 Vai em paz, disse-lhe o rei. E ele foi para Hebron.
10 But e send message go give all di pipol wey dey Israel tribe sey, “If una hear trumpet sound, den make una shaut, ‘Absalom don bi Hebron pipol king!’ ”
10 Absalão enviou emissários secretos a todas as tribos de Israel, com esta mensagem: Quando ouvirdes o som da trombeta, dizei: Absalão é rei em Hebron!
11 Na two hundred men from Jerusalem, Absalom karry follow body. Bikos dem nor know wetin Absalom won do, dem kon follow am with klean mind.
11 Ora, tinham partido de Jerusalém com Absalão duzentos homens, convidados por ele, que o seguiam com simplicidade de coração, sem nada suspeitar.
12 As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.
12 Enquanto oferecia os sacrifícios, Absalão mandou chamar também Aquitofel, gilonita, conselheiro de Davi, à sua cidade de Gilo. E assim a conjuração se fortificava e se tornava cada vez mais numerosa em torno de Absalão.
13 One messenja kon go tell David, “All di pipol for Israel dey loyal to Absalom.”
13 Vieram então anunciar a Davi: Os israelitas aderem a Absalão!
14 So David tell all en ofisas wey dey with am for Jerusalem, “Make wi run at wons, so dat Absalom nor go kill us! Make una hurry or e go kom defeat and kill evribody for di town!”
14 Davi disse então a todos os que estavam com ele em Jerusalém: Vamos, fujamos, porque não podemos de outro modo escapar a Absalão! Apressai-vos e parti, não suceda que ele nos surpreenda de repente, e nos inflija a ruína, passando a cidade ao fio da espada.
15 Dem ansa, “Yes o-o, awa king! Wi dey ready to do anytin wey yu tok.”
15 Os servos do rei disseram-lhe: Faça-se como ordenar o rei, meu senhor; somos teus servos.
16 So di king karry all en family pipol with di ofisas kon leave ten of en girl-friend wey go look di palis.
16 O rei partiu a pé com toda a sua família, mas deixou dez concubinas para guardar o palácio.
17 As di king and all en men dey komot for di palis, dem kon stop for di last house.
17 O rei saiu, pois, a pé com todos os seus servos, e se detiveram na última casa.
18 All di ofisas stand near am as di royal bodyguard pass go en front.
18 Todo o seu exército desfilava ao seu lado; os cereteus, os feleteus e todos os geteus, em número de seiscentos homens que o tinham seguido desde Get, todos marchavam diante do rei.
19 den di king tell Ittai wey bi dia leader sey, “Why yu won follow us go?” Go back make yu go stay with di new king. Yu bi strenja wey dem porshu komot en kountry.
19 O rei disse a Etai, o geteu: Por que vens também tu conosco? Volta e fica com o {novo} rei, pois és um estrangeiro, e mesmo um exilado de tua terra.
20 “E neva too tey wey yu kom here, so wetin go make mi allow yu sofa with mi? I nor even know where I dey go. So, make yu go back go meet yor pipol and make God dey kind and trit una well.”
20 Chegaste ontem, e hoje vou fazer que andes errante conosco, não sabendo eu mesmo aonde vou? Volta. Toma os teus contigo, e que o Senhor seja misericordioso e fiel para contigo.
21 But Ittai ansa, “My king, I use God name take swear sey I go follow yu go anywhere wey yu dey go, even if I go die put.”
21 Mas Etai respondeu ao rei: Pela vida do Senhor, e pela vida do rei, meu senhor! Onde estiver o meu senhor e rei, ali estará também o teu servo, tanto para a morte como para a vida.
22 David ansa, “Okay! Make wi dey go!” So Ittai with en men kon follow David.
22 Está bem, disse Davi, passa. E Etai, o geteu, desfilou com todos os seus homens e com toda a sua comitiva.
23 All di pipol for di town bigin kry as David with en men dey go. Di king with en men wey dey follow am kon cross go Kidron Valley as dem waka face di wildaness.
23 E estando o rei junto do Cedron, enquanto desfilava o povo diante dele, tomando o caminho da oliveira do deserto, toda a terra chorava em alta voz.
24 Zadok wey bi di priest with Levi pipol, wey karry di Kovenant Box, dey der too. Dem put am for groun, offa sakrifice and dem nor karry am again until all di pipol komot from di town. Even Priest Abiatar dey der too.
24 Veio também Sadoc com todos os seus levitas, trazendo a arca da aliança de Deus. Depuseram-na, enquanto Abiatar subia, e até que tivesse passado todo o povo que tinha saído da cidade.
25 Den di king tell Zadok, “Make una karry di Kovenant Box go di town back. If God dey happy with mi, E go still let mi kom back kom si am for where e dey.
25 Disse então o rei a Sadoc: Reconduz a arca de Deus à cidade. Se eu achar graça aos olhos do Senhor, ele me reconduzirá e me fará revê-la, bem como o lugar de sua habitação.
26 But if E dey vex for mi, make E do wetin E like with mi.”
26 Mas se disser que não quer mais saber de mim, eis-me aqui; faça de mim o que lhe aprouver.
27 Di king tell Zadok, “Look! Make yu take Ahimaaz yor pikin and Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon go di town back with peace.
27 O rei disse ainda a Sadoc: Vede: tu e Abiatar, voltai em paz para a cidade com Aquimaas, teu filho, e Jônatas, filho de Abiatar.
28 Den I go dey wait for di river where dem for dey cross go di wildaness until I hear news from una.”
28 Eu vou arrastar-me pelas campinas do deserto, esperando que me mandeis notícias.
29 So Zadok and Abiatar karry di Kovenant Box go Jerusalem kon stay der.
29 Sadoc e Abiatar reconduziram, pois, a arca de Deus para Jerusalém e lá ficaram.
30 David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.
30 Davi subiu chorando o monte das Oliveiras, cabeça coberta e descalço. Todo o povo que o acompanhava subia também chorando, com a cabeça coberta.
31 Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!” Absalom dey tok with Ahitofel|alt="Absalom discussing with Ahitophel" src="co01080b.TIF" size="col" loc="2Sam 15:12-30" copy="cook" ref="15:31"
31 Foi anunciado a Davi que Aquitofel estava também entre os conjurados de Absalão. Davi disse: Fazei que se frustrem, ó Senhor, meu Deus, os desígnios de Aquitofel!
32 Wen David rish on-top di hill where e go for fit woship God, en friend, Hushai wey kom from Ark land, wey David trust well-well, kom meet am. E wear tear-tear klot kon pak dirty full en head.
32 Ora, chegando Davi ao cume do monte, no lugar onde se adorava Deus, veio-lhe ao encontro Cusai, o araquita, com a túnica em farrapos e a cabeça coberta de pó.
33 David tell am, “Even if yu follow mi, yu nor go fit help mi do anytin,
33 Davi disse-lhe: Se vieres comigo, ser-me-ás pesado;
34 but yu fit help mi, if yu go di town back go tell Absalom sey yu go dey faithful to serve am just as yu serve en papa. Den make yu do evritin wey yu fit do against all di advise wey Ahitofel go gi-am.
34 mas se voltares à cidade e disseres a Absalão: eu quero ser, ó rei, teu servo, como fui outrora servo de teu pai; doravante servir-te-ei a ti - então desconcertarás a meu favor o desígnio de Aquitofel.
35 Zadok and Abiatar wey bi priest go dey der. So make yu tell dem evritin wey yu hear from di king palis.
35 Terás lá contigo os sacerdotes Sadoc e Abiatar, a quem comunicarás tudo o que souberes no palácio real.
36 Ahimaaz and Jonatan, dia shidren dey der with dem and yu fit send dem with all di informashon wey yu get kom give mi.”
36 Com eles estão os seus dois filhos, Aquimaas, filho de Sadoc, e Jônatas, filho de Abiatar; por eles me transmitireis tudo o que ouvirdes.
37 So Hushai, wey bi David friend kon go di town back as Absalom just dey enter.
37 E Cusai, amigo de Davi, voltou para a cidade, no momento em que Absalão fazia a sua entrada em Jerusalém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.