2 Samuel 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Joab know sey David won si Absalom,
1 Joabe, filho de Zeruia, percebeu que o rei agora desejava ver Absalão.
2 so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since.
2 Por isso, mandou trazer de Tecoa uma mulher conhecida por sua sabedoria. Disse-lhe: “Finja que está de luto; vista roupas de luto e não se perfume. Aja como uma mulher que está lamentando a morte de alguém há muito tempo.
3 Den go meet di king kon tell am wetin I tell yu,” So, Joab tell am wetin e go tok.
3 Depois, vá até o rei e apresente a história que vou lhe contar”. Então Joabe disse o que ela deveria falar.
4 Di woman wey kom from Tekoa town, go meet di king, bow kon sey, “My king! Make yu help mi!”
4 Quando a mulher de Tecoa se aproximou do rei, curvou-se com o rosto no chão e disse: “Ó rei! Ajude-me!”.
5 Di king ask am, “Wetin yu wont?”
5 “Qual é o problema?”, perguntou o rei. “Pobre de mim, sou viúva!”, respondeu ela. “Meu marido morreu.
6 I born two boys and dem kon dey kworel for farm and bikos nobody dey to hold dem, won kon kill di oda one.
6 Meus dois filhos brigaram no campo. Como não havia ninguém por perto para separá-los, um deles acabou matando o outro.
7 And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”
7 Agora, o resto da família está exigindo de sua serva: ‘Entregue-nos seu filho. Vamos executá-lo por ter matado o irmão. Ele não merece herdar a propriedade da família’. Querem apagar a última brasa que me restou; se o fizerem, o nome e a família de meu marido desaparecerão da face da terra.”
8 So di king ansa, “Make yu dey go yor house and I go take kare of dis matter.”
8 “Eu cuidarei disso”, disse o rei. “Vá para casa.”
9 Di woman wey kom from Tekoa kon sey, “My king! Anytin wey happen, make dem blame mi, bikos yu and yor royal family dey innocent.”
9 A mulher de Tecoa respondeu: “Ó meu senhor, o rei, que a culpa caia sobre mim e sobre a família de meu pai, e que o rei e seu trono sejam inocentes!”.
10 Di king ansa, “If anybody make yu fear, make yu bring am kom meet mi and e nor go disturb yu again.”
10 “Se alguém criar problemas, traga-o a mim”, disse o rei. “Eu lhe garanto que ele nunca mais a incomodará.”
11 Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.”
11 Então ela disse: “Por favor, prometa pelo S enhor , seu Deus, que não deixará o vingador da vítima matar meu filho. Não quero mais derramamento de sangue”. Ele respondeu: “Tão certo como vive o S
12 Di woman still sey, “I beg yu, my king! Make I tok anoda tin,” David ansa, “Okay.”
12 “Permita-me pedir mais uma coisa ao meu senhor, o rei”, disse a mulher. “Fale”, respondeu ele.
13 Di woman tell am, “Why yu do dat kind tin to God pipol? Yu neva let yor own pikin kom back from where e hide put since, so yu don kondemn yorsef with wetin yu just tok so.
13 Então ela disse: “Por que o senhor não faz pelo povo de Deus o mesmo que prometeu fazer por mim? Ao tomar essa decisão, o senhor condenou a si mesmo, pois se recusou a trazer para casa seu filho banido.
14 One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
14 Um dia, todos nós morreremos. Nossa vida é como água que, depois de derramada na terra, não pode mais ser recolhida. Mas Deus não apaga a vida; ao contrário, ele cria meios de trazer de volta aqueles que foram banidos de sua presença.
15 “Naw! My king, di tin wey make mi kom tok to yu bi sey di pipol dey treaten mi, so I tell mysef sey I go tok to yu and yu go do wetin I ask.
15 “Vim suplicar ao meu senhor, o rei, porque outros me ameaçaram. Pensei: ‘Talvez o rei me escute
16 I know sey yu go listin to mi kon save mi from di pesin wey dey try to kill mi and my pikin, so dat dem go remove us from di land wey God give en pipol.
16 e nos livre daqueles que desejam nos eliminar da herança que Deus nos deu.
17 “Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
17 Sim, o meu senhor, o rei, restaurará nossa paz de espírito’. Sei que o senhor é como um anjo de Deus, capaz de discernir entre o bem e o mal. Que o S enhor , seu Deus, esteja com o rei”.
18 Di king ansa, “I won ask yu one kweshon and yu must tell mi di whole trut.”
18 “Preciso saber uma coisa”, disse o rei. “Diga-me a verdade.” “Sim, ó meu senhor, o rei”, disse a mulher.
19 Di king ask, “Nor bi Joab send yu kom?
19 “Foi Joabe quem a mandou aqui?”, perguntou o rei. A mulher respondeu: “Ó meu senhor, o rei, como posso negar? Ninguém é capaz de esconder coisa alguma do senhor. Sim, foi Joabe, servo do rei, que me enviou e me disse o que falar.
20 But e do am to take solve dis problem. My king get sense like angel and e know evritin wey dey happen.”
20 Agiu desse modo para que o senhor pudesse ver a questão com outros olhos. Mas o senhor é sábio como um anjo de Deus e entende tudo que acontece em nosso meio!”.
21 So di king koll and tell Joab, “I don gri to do wetin yu wont. So make yu go look for Absalom kon bring am kom back.”
21 Então o rei mandou chamar Joabe e lhe disse: “Muito bem, vá e traga de volta o jovem Absalão”.
22 Joab bow for David kon sey, “My king, make God bless yu! Naw, I know sey yu dey happy with mi, bikos yu gri with wetin I tok.”
22 Joabe se curvou com o rosto no chão e disse: “Finalmente sei que obtive o favor do meu senhor, o rei, pois atendeu a meu pedido!”.
23 Den e go Geshur go bring Absalom kom Jerusalem.
23 Joabe foi a Gesur e trouxe Absalão de volta a Jerusalém.
24 But di king give orda sey make Absalom nor stay for di palis. Di king sey, “I nor won si am.” So Absalom go stay for en own house and e nor kom where di king dey.
24 O rei, porém, deu a seguinte ordem: “Absalão pode ir para casa, mas não deve vir à minha presença”. Portanto, Absalão não viu o rei.
25 E nor get pesin wey fine rish Absalom for Israel. From en head go rish leg, evriwhere dey okay.
25 Não havia nenhum homem em todo o Israel tão elogiado por sua beleza como Absalão; era perfeito da cabeça aos pés.
26 En hair tick and heavy well-well sotey na wons e dey kut am a year wen e don too long. En hair heavy rish five pounds if dem use palis standard take measure am.
26 Cortava o cabelo uma vez por ano por causa de seu peso: 2,4 quilos, segundo o peso real.
27 Absalom born three boys and one girl wey dem dey koll Tamar and e fine well-well.
27 Tinha três filhos e uma filha. Sua filha se chamava Tamar e era muito bonita.
28 Absalom stay two years for Jerusalem and e nor si di king.
28 Absalão morou dois anos em Jerusalém sem ver o rei.
29 Den Absalom send message go koll Joab make e go meet di king for am, but Joab nor gri kom. Absalom send for am again and e nor gri kom.
29 Então mandou chamar Joabe para pedir que intercedesse por ele, mas Joabe não quis vir. Mandou chamá-lo de novo e, mais uma vez, ele se recusou a vir.
30 So Absalom tell en savant, “Si, Joab farm near my own and e plant barley put. Make una go burn am.” So dem kon go burn di field.
30 Então Absalão disse a seus servos: “Vão e ponham fogo no campo de cevada de Joabe que fica junto de minha propriedade”. Os servos foram e puseram fogo no campo, como Absalão havia ordenado.
31 Joab go Absalom house kon tell am, “Wetin make yor savants burn my farm?”
31 Então Joabe foi à casa de Absalão e lhe perguntou: “Por que seus servos puseram fogo em meu campo?”.
32 Absalom ansa, “Bikos yu nor gri kom wen I sey make yu kom. I wont make yu go meet di king kon ask am: ‘Wetin make mi komot from Geshur kom stay here? E for betta for mi pass dis place wey I dey so.’ ” Absalom still sey, “I wont make yu arrange for mi make I si di king and if I dey guilty, make dem kill mi.”
32 Absalão respondeu: “Eu quero que você pergunte ao rei por que ele me trouxe de Gesur se não pretendia me receber. Teria sido melhor eu ficar onde estava. Quero ver o rei; se ele me considera culpado de algo, então que mande me matar”.
33 So, Joab go meet David kon tell am wetin Absalom tok. Di king send message go koll Absalom kom and wen e kom, e bow for di king front, den di king welkom am with kiss.
33 Joabe contou ao rei o que Absalão tinha dito. Por fim, Davi mandou chamar Absalão. Ele veio, curvou-se com o rosto no chão diante do rei, e o rei o beijou.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Samuel 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.