2 Reis 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Naw, Elisha koll one among di profet sons kon sey, “Wear yor klot, den take dis olive oil kontaina go Ramot for Gilead.
1 Então, o profeta Eliseu chamou um dos discípulos dos profetas e lhe disse: Cinge os lombos, leva contigo este vaso de azeite e vai-te a Ramote-Gileade;
2 Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room.
2 em lá chegando, vê onde está Jeú, filho de Josafá, filho de Ninsi; entra, e faze-o levantar-se do meio de seus irmãos, e leva-o à câmara interior.
3 Take di olive oil, pour am for en head kon sey, ‘Dis na wetin God tok, “I don choose yu as Israel king.” ’ Den make yu kwik-kwik komot from der!”
3 Toma o vaso de azeite, derrama-lho sobre a cabeça e dize: Assim diz o Senhor : Ungi-te rei sobre Israel. Então, abre a porta, foge e não te detenhas.
4 So di profet pikin kon go Ramot for Gilead.
4 Foi, pois, o moço, o jovem profeta, a Ramote-Gileade.
5 Wen e rish der, Jehu wey bi di sojas oga, sidan for der. So e sey, “Offisa, abeg, I get message for yu.”
5 Entrando ele, eis que os capitães do exército estavam assentados; ele disse: Capitão, tenho mensagem que te dizer. Perguntou-lhe Jeú: A qual de todos nós? Respondeu-lhe ele: A ti, capitão!
6 So Jehu stand up, follow am go inside. Den di profet pour di olive oil for en head kon sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I don choose yu as Israel king.
6 Então, se levantou Jeú e entrou na casa; o jovem derramou-lhe o azeite sobre a cabeça e lhe disse: Assim diz o Senhor , Deus de Israel: Ungi-te rei sobre o povo do Senhor , sobre Israel.
7 Yu go distroy yor oga, Ahab family. I go revensh Jezebel bikos of my savants, di profets wey e kill.
7 Ferirás a casa de Acabe, teu senhor, para que eu vingue da mão de Jezabel o sangue de meus servos, os profetas, e o sangue de todos os servos do Senhor .
8 Evribody for Ahab family go die finish. Evry son wey dey Ahab family for Israel, I go kill all of dem, both di ones wey dey free and di ones wey bi slave.
8 Toda a casa de Acabe perecerá; exterminarei de Acabe todos do sexo masculino, quer escravo, quer livre, em Israel.
9 As I do Jeroboam, Nebat pikin and Baasha, Ahijah pikin with dia shidren-shidren, na so too I go distroy Ahab shidren-shidren.
9 Porque farei à casa de Acabe como à casa de Jeroboão, filho de Nebate, e como à casa de Baasa, filho de Aías.
10 Dogs go chop Jezebel for Jezrel land and nobody go beri am.’ ” Den di yong profet kon kwik-kwik komot der.
10 Os cães devorarão Jezabel no campo de Jezreel; não haverá quem a enterre. Dito isto, abriu a porta e fugiu.
11 Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”
11 Saindo Jeú aos servos de seu senhor, disseram-lhe: Vai tudo bem? Por que veio a ti este louco? Ele lhes respondeu: Bem conheceis esse homem e o seu falar.
12 But dem sey, “Yu dey lie! Make yu tell us wetin e tok.”
12 Mas eles disseram: É mentira; agora, faze-nos sabê-lo, te pedimos. Então, disse Jeú: Assim e assim me falou, a saber: Assim diz o Senhor : Ungi-te rei sobre Israel.
13 So each of dem kwik-kwik remove dia klot kon spread dem put for Jehu leg for di step. Dem blow di trumpet kon shaut sey, “Na Jehu bi king!”
13 Então, se apressaram, e, tomando cada um o seu manto, os puseram debaixo dele, sobre os degraus, e tocaram a trombeta, e disseram: Jeú é rei!
14 Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria.
14 Assim, Jeú, filho de Josafá, filho de Ninsi, conspirou contra Jorão. Tinha, porém, Jorão cercado a Ramote-Gileade, ele e todo o Israel, por causa de Hazael, rei da Síria.
15 So Jehu tell di oda ofisas, “If una dey with mi, make una make sure sey nobody komot from Ramot go warn Jezrel pipol.”
15 Porém o rei Jorão voltou para se curar em Jezreel das feridas que os siros lhe fizeram, quando pelejou contra Hazael, rei da Síria. Disse Jeú: Se é da vossa vontade, ninguém saia furtivamente da cidade, para ir anunciar isto em Jezreel.
16 Den Jehu enter en horse kon go Jezrel, bikos dem dey trit Joram for der. (For dis time, King Ahazaya for Judah don kom visit Joram.)
16 Então, Jeú subiu a um carro e foi-se a Jezreel, porque Jorão estava de cama ali. Também Acazias, rei de Judá, descera para ver a Jorão.
17 Naw, di gateman stand for di gate for Jezrel kon si Jehu men dey kom. So e sey, “I si some men dey kom!”
17 Ora, o atalaia estava na torre de Jezreel, e viu a tropa de Jeú, que vinha, e disse: Vejo uma tropa. Então, disse Jorão: Toma um cavaleiro e envia-o ao seu encontro, para que lhe pergunte: Há paz?
18 So dem send one man go meet Jehu kon ask, “Di king dey ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
18 Foi-lhe o cavaleiro ao encontro e disse: Assim diz o rei: Há paz? Respondeu Jeú: Que tens tu com a paz? Passa para trás de mim. O atalaia deu aviso, dizendo: Chegou a eles o mensageiro, porém não volta.
19 So e send anoda pesin go ask, “Dis na wetin di king ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
19 Então, enviou Jorão outro cavaleiro; chegando este a eles, disse: Assim diz o rei: Há paz? Respondeu Jeú: Que tens tu com a paz? Passa para trás de mim.
20 Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”
20 O atalaia deu aviso, dizendo: Também este chegou a eles, porém não volta; e o guiar do carro parece como o de Jeú, filho de Ninsi, porque guia furiosamente.
21 King Joram kon sey, “Make una ready my horse.” Wen dem don ready en horse, King Joram for Israel and King Ahazaya for Judah kon enter dia horse go meet Jehu. Dem meet am for one land wey bi Nabot for Jezrel own before.
21 Disse Jorão: Aparelha o carro. E lhe aparelharam o carro. Saiu Jorão, rei de Israel, e Acazias, rei de Judá, cada um em seu carro, e foram ao encontro de Jeú, e o acharam no campo de Nabote, o jezreelita.
22 Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?”
22 Sucedeu que, vendo Jorão a Jeú, perguntou: Há paz, Jeú? Ele respondeu: Que paz, enquanto perduram as prostituições de tua mãe Jezabel e as suas muitas feitiçarias?
23 King Joram kon tell King Ahazaya sey, “Na plan work!” Den e turn en horse kon dey run.
23 Então, Jorão voltou as rédeas, fugiu e disse a Acazias: Há traição, Acazias!
24 Jehu karry en bow and arrow kon shot King Joram and di arrow enter en heart, so e fall from en horse kon die.
24 Mas Jeú entesou o seu arco com toda a força e feriu a Jorão entre as espáduas; a flecha saiu-lhe pelo coração, e ele caiu no seu carro.
25 Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,
25 Então, Jeú disse a Bidcar, seu capitão: Toma-o, lança-o no campo da herdade de Nabote, o jezreelita; pois, lembra-te de que, indo eu e tu, juntos, montados, após Acabe, seu pai, o Senhor pronunciou contra ele esta sentença:
26 ‘I si as una kill Nabot and en sons yestiday. And I promise sey I go still ponish yu for dis same land.’ So make una trow di body for di field, so dat wetin God tok, go happen.”
26 Tão certo como vi ontem à tarde o sangue de Nabote e o sangue de seus filhos, diz o Senhor , assim to retribuirei neste campo, diz o Senhor . Agora, pois, toma-o e lança-o neste campo, segundo a palavra do Senhor .
27 Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.
27 À vista disto, Acazias, rei de Judá, fugiu pelo caminho de Bete-Hagã; porém Jeú o perseguiu e disse: Feri também a este; e o feriram no carro, à subida de Gur, que está junto a Ibleão. E fugiu para Megido, onde morreu.
28 En offisa karry en body go back to Jerusalem kon beri am with en grand-grand papa dem for David Town.
28 Levaram-no os seus servos, num carro, a Jerusalém e o enterraram na sua sepultura junto a seus pais, na Cidade de Davi.
29 Ahazaya na king for Judah for eleven years wen Joram, Ahab pikin dey rule.
29 No ano undécimo de Jorão, filho de Acabe, começara Acazias a reinar sobre Judá.
30 Jehu kon ride dey go Jezrel. Wen Jezebel hear wetin happen, e paint en eye, do en hair well kon dey look from di window.
30 Tendo Jeú chegado a Jezreel, Jezabel o soube; então, se pintou em volta dos olhos, enfeitou a cabeça e olhou pela janela.
31 As Jehu enter thru di gate, Jezebel kon sey, “Zimri, yu wey kill yor oga! Hope evritin dey okay? Wetin yu dey do for here?”
31 Ao entrar Jeú pelo portão do palácio, disse ela: Teve paz Zinri, que matou a seu senhor?
32 Jehu look up kon shaut, “Na who dey my side?” Like two or three kourt ofisas look am from di window.
32 Levantou ele o rosto para a janela e disse: Quem é comigo? Quem? E dois ou três eunucos olharam para ele.
33 So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.
33 Então, disse ele: Lançai-a daí abaixo. Lançaram-na abaixo; e foram salpicados com o seu sangue a parede e os cavalos, e Jeú a atropelou.
34 Jehu enter di palis kon sidan chop for der. Den e sey, “Make una go trowey dis wiked woman dead body. Make una beri am, bikos na king pikin e bi.”
34 Entrando ele e havendo comido e bebido, disse: Olhai por aquela maldita e sepultai-a, porque é filha de rei.
35 But wen dem won go beri Jezebel, dem nor si anytin escept en skull, leg and hand.
35 Foram para a sepultar; porém não acharam dela senão a caveira, os pés e as palmas das mãos.
36 Dem kon go back go tell Jehu wetin happen, den e sey, “All wetin God tok thru en savant Elijah wey kom from Tishbe, don really happen. Bikos Elijah warn dem sey, ‘Na for Jezrel land, dogs go for chop Jezebel flesh kon lick en blood.
36 Então, voltaram e lho fizeram saber. Ele disse: Esta é a palavra do Senhor , que falou por intermédio de Elias, o tesbita, seu servo, dizendo: No campo de Jezreel, os cães comerão a carne de Jezabel.
37 Wetin remain for Jezebel body, go skata like dirty for Jezrel land and pipol nor go fit know am at-all.’ ”
37 O cadáver de Jezabel será como esterco sobre o campo da herdade de Jezreel, de maneira que já não dirão: Esta é Jezabel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.