2 Reis 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Elisha ansa, “Make una hear God word, ‘By dis time tumoro, three kilogram for di best flower and six kilogram for barley, una go dey buy dem with one silva.’ ”
1 Então disse Eliseu: Ouvi a palavra do SENHOR; assim diz o SENHOR: Amanhã, quase a este tempo, haverá uma medida de farinha por um siclo, e duas medidas de cevada por um siclo, à porta de Samaria.
2 One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!”
2 Porém um senhor, em cuja mão o rei se encostava, respondeu ao homem de Deus e disse: Eis que ainda que o SENHOR fizesse janelas no céu, poder-se-ia fazer isso? E ele disse: Eis que o verás com os teus olhos, porém disso não comerás.
3 Four men wey get diziz for body, sidan for di town gate. So dem tell demsef, “Wetin make us just sidan for here dey wait di time wey wi go die?
3 E quatro homens leprosos estavam à entrada da porta, os quais disseram uns aos outros: Para que estaremos nós aqui até morrermos?
4 If wi enter di town, hongry go kill us and if wi stay here, hongry go still kill us! So make wi go Siria sojas kamp. Di highest wey dem fit do, na to kill us, but may bi dem go fit still sorry for us.”
4 Se dissermos: Entremos na cidade, há fome na cidade, e morreremos aí; e se ficarmos aqui, também morreremos. Vamos nós, pois, agora, e passemos para o arraial dos sírios; se nos deixarem viver, viveremos, e se nos matarem, tão-somente morreremos.
5 So, as day dey dark, dem kon go Siria sojas kamp, but wen dem rish der, dem nor si anybody,
5 E levantaram-se ao crepúsculo, para irem ao arraial dos sírios; e, chegando à entrada do arraial dos sírios, eis que não havia ali ninguém.
6 bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”
6 Porque o Senhor fizera ouvir no arraial dos sírios ruído de carros e ruído de cavalos, como o ruído de um grande exército; de maneira que disseram uns aos outros: Eis que o rei de Israel alugou contra nós os reis dos heteus e os reis dos egípcios, para virem contra nós.
7 So dat evening, Siria sojas run leave dia kamp, horse, donkey and evritin wey dem get for di kamp.
7 Por isso se levantaram, e fugiram no crepúsculo, e deixaram as suas tendas, os seus cavalos, os seus jumentos e o arraial como estava; e fugiram para salvarem a sua vida.
8 Wen di four men rish di kamp door-mot, dem enter di tent, chop and drink beleful kon kollect and go hide di silva, gold and klot wey dem si. Den, dem enter anoda tent kon do di same tin.
8 Chegando, pois, estes leprosos à entrada do arraial, entraram numa tenda, e comeram, beberam e tomaram dali prata, ouro e roupas, e foram e os esconderam; então voltaram, e entraram em outra tenda, e dali também tomaram alguma coisa e a esconderam.
9 Den dem tell each oda, “Wi nor suppose to dey do like dis! Wi get betta news and wi must go tell awa pipol. If wi wait until tumoro morning before wi tok, di king go ponish us. So make wi go naw go tell di king ofisas!”
9 Então disseram uns para os outros: Não fazemos bem; este dia é dia de boas novas, e nos calamos; se esperarmos até à luz da manhã, algum mal nos sobrevirá; por isso agora vamos, e o anunciaremos à casa do rei.
10 So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.”
10 Vieram, pois, e bradaram aos porteiros da cidade, e lhes anunciaram, dizendo: Fomos ao arraial dos sírios e eis que lá não havia ninguém, nem voz de homem, porém só cavalos atados, jumentos atados, e as tendas como estavam.
11 Di guards announce di news and dem kon go tell di king.
11 E chamaram os porteiros, e o anunciaram dentro da casa do rei.
12 By dat time, day don dark well-well, but di king tell en ofisas, “I go tell una wetin Siria sojas dey plan! Dem know sey honga one kill us, so dem don leave dia kamp go hide, bikos dem dey hope sey, wi go leave awa town go find food for dia kamp, den dem go katch us alive kon konker dis town.”
12 E o rei se levantou de noite, e disse a seus servos: Agora vos farei saber o que é que os sírios nos fizeram; bem sabem eles que esfaimados estamos, pelo que saíram do arraial, a esconder-se pelo campo, dizendo: Quando saírem da cidade, então os tomaremos vivos, e entraremos na cidade.
13 One of di ofisas ansa, “Di pipol wey dey di town don taya already, bikos dem bi like pipol wey don already die. So make wi send some men with five horse from di ones wey remain for di town. (Even if dem kill dem, na di same tin go still happen to evribody wey dey Israel, bikos all of us go still die!) Make wi send dem go, so dat wi go really know wetin dey happen.”
13 Então um dos seus servos respondeu e disse: Tomem-se, pois, cinco dos cavalos que restam aqui dentro (eis que são como toda a multidão dos israelitas que ficaram aqui; e eis que são como toda a multidão dos israelitas que já pereceram) e enviemo-los, e vejamos.
14 So dem choose some men and di king kon send dem go with two shariot sey, “Make una go look wetin happen to Siria sojas.”
14 Tomaram, pois, dois cavalos de carro; e o rei os enviou com mensageiros após o exército dos sírios, dizendo: Ide, e vede.
15 As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.
15 E foram após eles até ao Jordão, e eis que todo o caminho estava cheio de roupas e de aviamentos que os sírios, apressando-se, lançaram fora; e voltaram os mensageiros e o anunciaram ao rei.
16 Den Samaria pipol rush enter Siria kamp kon pak evritin wey dey der. And as God tok, three kilogram for di best flower or six kilogram for di best korn, dem kon dey sell am for one silva.
16 Então saiu o povo, e saqueou o arraial dos sírios; e havia uma medida de farinha por um siclo, e duas medidas de cevada por um siclo, conforme a palavra do Senhor.
17 So Israel king put en own offisa as guide for di town gate. But di pipol mash am die for der, just as Elisha tell di savant wen di king kom meet am.
17 E pusera o rei à porta o senhor em cuja mão se encostava; e o povo o atropelou na porta, e morreu, como falara o homem de Deus, o que falou quando o rei descera a ele.
18 Elisha don tell di king before sey by dis time tumoro for Samaria gate, dem go dey sell three kilogram for di best flower and six kilogram for di best korn for one silva
18 Porque assim sucedeu como o homem de Deus falara ao rei dizendo: Amanhã, quase a este tempo, haverá duas medidas de cevada por um siclo, e uma medida de farinha por um siclo, à porta de Samaria.
19 and dat ofisas bin ansa sey, “E nor fit happen, even if God ensef go send korn kom naw-naw!” And Elisha tell am, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from di food.”
19 E aquele senhor respondeu ao homem de Deus, e disse: Eis que ainda que o SENHOR fizesse janelas no céu poderia isso suceder? E ele disse: Eis que o verás com os teus olhos, porém dali não comerás.
20 And dat na wetin just happen to di man. Pipol mash am die for di town gate.
20 E assim lhe sucedeu, porque o povo o atropelou à porta, e morreu.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.