2 Reis 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Some profet kon tell Elisha “Si, di place where wi dey stay too small for us.
1 Disseram os discípulos dos profetas a Eliseu: Eis que o lugar em que habitamos contigo é estreito demais para nós.
2 So make wi go Jordan aria where wi go for get and kut betta wood kon build betta house for awasef for der.”
2 Vamos, pois, até ao Jordão, tomemos de lá, cada um de nós uma viga, e construamos um lugar em que habitemos. Respondeu ele: Ide.
3 But one of dem tell am, “Abeg oga, make yu follow us go.”
3 Disse um: Serve-te de ires com os teus servos. Ele tornou: Eu irei.
4 So e follow dem go.
4 E foi com eles. Chegados ao Jordão, cortaram madeira.
5 As dem dey kut, one of dem axe head kon fall enter Jordan river. Den e shaut, “My oga, I don die. Na borrow I borrow dis axe o-o!”
5 Sucedeu que, enquanto um deles derribava um tronco, o machado caiu na água; ele gritou e disse: Ai! Meu senhor! Porque era emprestado.
6 So Elisha ask, “Na wish side e fall put?” So di man show am where e fall put, den Elisha kut small branches for di tree kon drop am put for der, den di axe head kon float kom up.
6 Perguntou o homem de Deus: Onde caiu? Mostrou-lhe ele o lugar. Então, Eliseu cortou um pau, e lançou-o ali, e fez flutuar o ferro,
7 Elisha tell di man, “Make yu pick di axe komot from di wota.” So di man kon pick am.
7 e disse: Levanta-o. Estendeu ele a mão e o tomou.
8 Naw, Siria pipol kon dey fight Israel pipol. Siria king kon koll doz wey dey advise am and dem tell am where and wen e go take attack.
8 O rei da Síria fez guerra a Israel e, em conselho com os seus oficiais, disse: Em tal e tal lugar, estará o meu acampamento.
9 But Elisha sey make dem go tell Israel king sey, “Make yu nor pass thru dis place, bikos Siria king go attack der.”
9 Mas o homem de Deus mandou dizer ao rei de Israel: Guarda-te de passares por tal lugar, porque os siros estão descendo para ali.
10 So Israel king send message go meet en men about wetin Elisha tok and e warn dem well-well. Nor bi only wons dis tin happen.
10 O rei de Israel enviou tropas ao lugar de que o homem de Deus lhe falara e de que o tinha avisado, e, assim, se salvou, não uma nem duas vezes.
11 Di tin kon make Siria king dey vex well-well. So e koll all doz wey dey advise am kon sey, “E bi like sey one of us dey help Israel king.”
11 Então, tendo-se turbado com este incidente o coração do rei da Síria, chamou ele os seus servos e lhes disse: Não me fareis saber quem dos nossos é pelo rei de Israel?
12 One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
12 Respondeu um dos seus servos: Ninguém, ó rei, meu senhor; mas o profeta Eliseu, que está em Israel, faz saber ao rei de Israel as palavras que falas na tua câmara de dormir.
13 So di king sey, “Make una go find out where e dey, so dat I go send men go katch am kom.” Leta, dem kon tell di king, “Elisha dey for Dotan.”
13 Ele disse: Ide e vede onde ele está, para que eu mande prendê-lo. Foi-lhe dito: Eis que está em Dotã.
14 So e send strong sojas and horse make dem go katch Elisha kom. Dem rish der for nite kon surround di town.
14 Então, enviou para lá cavalos, carros e fortes tropas; chegaram de noite e cercaram a cidade.
15 Wen Elisha savant get up for early morning go outside, e kon si sey sojas surround di town with dia horse. Den e go tell Elisha, “Oga! Na die wi dey so o-o, wetin wi go do naw?”
15 Tendo-se levantado muito cedo o moço do homem de Deus e saído, eis que tropas, cavalos e carros haviam cercado a cidade; então, o seu moço lhe disse: Ai! Meu senhor! Que faremos?
16 Elisha ansa, “Make yu nor fear, bikos di ones wey dey with us, many pass di ones wey dey with dem.”
16 Ele respondeu: Não temas, porque mais são os que estão conosco do que os que estão com eles.
17 Den Elisha kon pray, “Oga God, make Yu open my savant eye, so dat e go si for ensef.” So God open di savant eye, so e kon si sey many horse with fire kover di mountins wey surround Elisha.
17 Orou Eliseu e disse: Senhor , peço-te que lhe abras os olhos para que veja. O Senhor abriu os olhos do moço, e ele viu que o monte estava cheio de cavalos e carros de fogo, em redor de Eliseu.
18 As Siria sojas dey kom, Elisha kon pray, “Oga God, make yu blind all dis pipol eye.” So God make dem blind, just as Elisha ask.
18 E, como desceram contra ele, orou Eliseu ao Senhor e disse: Fere, peço-te, esta gente de cegueira. Feriu-a de cegueira, conforme a palavra de Eliseu.
19 Den Elisha tell dem, “Dis nor bi di rite road or town. Make una follow mi and I go take una go meet di man wey una dey find.” So e karry all of dem go Samaria.
19 Então, Eliseu lhes disse: Não é este o caminho, nem esta a cidade; segui-me, e guiar-vos-ei ao homem que buscais. E os guiou a Samaria.
20 Wen dem don enter Samaria, Elisha kon sey, “My Oga God, make Yu open dia eye, so dat dem go si.” So God open dia eye and dem kon si sey dem dey inside Samaria.
20 Tendo eles chegado a Samaria, disse Eliseu: Ó Senhor , abre os olhos destes homens para que vejam. Abriu-lhes o Senhor os olhos, e viram; e eis que estavam no meio de Samaria.
21 Wen Israel king si dem, e kon ask Elisha, “My oga, make I kill all of dem?”
21 Quando o rei de Israel os viu, perguntou a Eliseu: Feri-los-ei, feri-los-ei, meu pai?
22 Elisha ansa, “Nor kill dem! Yu nor katch dem with yor swod or arrow, so who give yu di pawa to kill dem? Make yu give dem food chop and wota drink, den make dem go back go meet dia oga.”
22 Respondeu ele: Não os ferirás; fere aqueles que fizeres prisioneiros com a tua espada e o teu arco. Porém a estes, manda pôr-lhes diante pão e água, para que comam, e bebam, e tornem a seu senhor.
23 So di king do big party for dem and dem chop and drink. Den e send dem go back go meet dia oga. Afta dat, no soja for Siria ever kom fight against Israel pipol again.
23 Ofereceu-lhes o rei grande banquete, e comeram e beberam; despediu-os, e foram para seu senhor; e da parte da Síria não houve mais investidas na terra de Israel.
24 Leta, King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas go surround and attack Samaria.
24 Depois disto, ajuntou Ben-Hadade, rei da Síria, todo o seu exército, subiu e sitiou a Samaria.
25 Bikos of wetin dey happen so, Samaria pipol food kon finish and dem kon dey sell donkey head for eight silva and half pound for dove shit kon bi five silva.
25 Houve grande fome em Samaria; eis que a sitiaram, a ponto de se vender a cabeça de um jumento por oitenta siclos de prata e um pouco de esterco de pombas por cinco siclos de prata.
26 As Israel king dey strol pass di town wall, one woman kon shaut, “My king, make yu help us o-o!”
26 Passando o rei de Israel pelo muro, gritou-lhe uma mulher: Acode-me, ó rei, meu senhor!
27 Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”
27 Ele lhe disse: Se o Senhor te não acode, donde te acudirei eu? Da eira ou do lagar?
28 Den di king ask di woman, “Wetin bi yor problem?”
28 Perguntou-lhe o rei: Que tens? Respondeu ela: Esta mulher me disse: Dá teu filho, para que, hoje, o comamos e, amanhã, comeremos o meu.
29 So wi boil my pikin chop. Di next day, I kon tell am, ‘Bring yor pikin make wi chop,’ but e nor gri!”
29 Cozemos, pois, o meu filho e o comemos; mas, dizendo-lhe eu ao outro dia: Dá o teu filho, para que o comamos, ela o escondeu.
30 Wen di king hear wetin di woman tok, e tear en klot. As di king dey waka pass di town wall, di pipol kon si sey e wear sak klot.
30 Tendo o rei ouvido as palavras da mulher, rasgou as suas vestes, quando passava pelo muro; o povo olhou e viu que trazia pano de saco por dentro, sobre a pele.
31 Den di king sey, “Make God ponish mi if I nor kut Shafat pikin, Elisha head komot before today go end!”
31 Disse o rei: Assim me faça Deus o que bem lhe aprouver se a cabeça de Eliseu, filho de Safate, lhe ficar, hoje, sobre os ombros.
32 By dis time, Elisha sidan for en house with di kommunity leaders. Di king kon send pesin go for front, but before e rish der, Elisha tell di leaders, “Una nor know sey di pesin wey di king send dey kom kut my head komot? So, wen e rish here, make una lock di door, so dat e nor go enter, bikos en oga dey kom for back.”
32 Estava, porém, Eliseu sentado em sua casa, juntamente com os anciãos. Enviou o rei um homem de diante de si; mas, antes que o mensageiro chegasse a Eliseu, disse este aos anciãos: Vedes como o filho do homicida mandou tirar-me a cabeça? Olhai, quando vier o mensageiro, fechai-lhe a porta e empurrai-o com ela; porventura, não vem após ele o ruído dos pés de seu senhor?
33 E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
33 Falava ele ainda com eles, quando lhe chegou o mensageiro; disse o rei: Eis que este mal vem do Senhor ; que mais, pois, esperaria eu do Senhor ?

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.