2 Reis 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 E get one man wey en name na Naaman and na-im bi Siria sojas oga. Siria king like and dey respet am well-well, bikos thru am, God don make Siria pipol win many war. Naaman sabi fight well-well, but e get one kind diziz for body.
1 Naamã, general do exército do rei da Síria, gozava de grande prestígio diante de seu amo, e era muito considerado, porque, por meio dele, o Senhor salvou a Síria; era um homem valente, mas leproso.
2 So, wen Siria sojas go fight war for Israel, dem katch one small girl kon gi-am to Naaman wife, as en savant.
2 Ora, tendo os sírios feito uma incursão no território de Israel, levaram consigo uma jovem, a qual ficou a serviço da mulher de Naamã.
3 One day, di girl kon tell en madam, “If to sey my oga go gri go meet di profet for Samaria, e go fit cure am from dis diziz.”
3 Ela disse à sua senhora: Ah, se meu amo fosse ter com o profeta que reside em Samaria, ele o curaria da lepra!
4 So Naaman go tell di king wetin di Israel girl tok.
4 Ouvindo isso, Naamã foi e contou ao seu soberano o que dissera a jovem israelita.
5 Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot.
5 O rei da Síria respondeu-lhe: Vai, que eu enviarei uma carta ao rei de Israel. Naamã partiu com dez talentos de prata, seis mil siclos de ouro e dez vestes de festa.
6 E take di leta go give Israel king wey sey: “Dis leta na to let yu know sey na mi send my savant, Naaman kom meet yu, so dat yu go heal am from en sickness.”
6 Levou ao rei de Israel uma carta concebida nestes termos: Ao receberes esta carta, saberás que te mando Naamã, meu servo, para que o cures da lepra.
7 Wen Israel king read di leta, e tear en klot kon sey, “Na mi bi God wey get pawa to give and take life? Wetin make di king tink sey I go fit cure dis man? If yu tink am well-well, yu go si sey e dey find as e go take fight mi.”
7 Tendo lido a missiva, o rei de Israel rasgou as vestes e exclamou: Sou eu porventura um deus, que possa dar a morte ou a vida, para que esse me mande dizer que cure um homem da lepra? Vede bem que ele anda buscando pretextos contra mim.
8 Wen Elisha, God profet hear sey di king tear en klot, e kon send pipol go meet and tell di king, “Wetin make yu tear yor klot? Send am kom meet mi and e go know sey Israel really get betta profet wey God send kom.”
8 Quando Eliseu, o homem de Deus, soube que o rei tinha rasgado as vestes, mandou-lhe dizer: Por que rasgaste as tuas vestes? Que ele venha a mim, e saberá que há um profeta em Israel.
9 So Naaman with all en men go meet and stand for Elisha door-mot.
9 Naamã veio com seu carro e seus cavalos e parou à porta de Eliseu.
10 Elisha sey make en savant go tell Naaman, “Make yu go wosh yorsef seven times for Jordan River, den yu go well.”
10 Este mandou-lhe dizer por um mensageiro: Vai, lava-te sete vezes no Jordão e tua carne ficará limpa.
11 But Naaman vex waka komot dey sey, “I bin tink sey e go kom outside kom meet mi, den koll en God name and wave en hand for di diziz, so dat I go well.
11 Naamã se foi, despeitado, dizendo: Eu pensava que ele viria em pessoa, e, diante de mim, invocaria o Senhor, seu Deus, poria a mão no lugar infetado e me curaria da lepra.
12 Amanah and Farpar for Damaskus nor betta pass all di rivers for Israel? Why e nor send mi go one of dem, so dat I go well?” So Naaman vex komot from der.
12 Porventura os rios de Damasco, o Abana e o Farfar, não são melhores que todas as águas de Israel? Não me poderia eu lavar neles e ficar limpo? E, voltando-se, retirou-se encolerizado.
13 Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.”
13 Mas seus servos, aproximando-se dele, disseram-lhe: Meu pai, mesmo que o profeta te tivesse ordenado algo difícil, não o deverias fazer? Quanto mais agora que ele te disse: Lava-te e serás curado.
14 So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.
14 Naamã desceu ao Jordão e banhou-se ali sete vezes, como lhe ordenara o homem de Deus, e sua carne tornou-se tenra como a de uma criança.
15 Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
15 Voltando então para o homem de Deus, com toda a sua comitiva, entrou, apresentou-se diante dele e disse: Reconheço que não há outro Deus em toda a terra, senão o de Israel. Aceita este presente do teu servo.
16 But Elisha ansa, “God Forbid! As long as di Oga God wey I dey serve dey alive, I nor go take anytin from yu.” Naaman beg am well-well, but e nor gri.
16 Pela vida do Senhor a quem sirvo, replicou Eliseu, não aceitarei nada. E apesar da instância de Naamã, ele recusou.
17 So Naaman sey, “Since yu nor gri take anytin, abeg make yu give us two donkey wey wi go use take pak una san go awa land, bikos I nor go ever offa any ofrin give any oda god escept yor God.
17 Então Naamã disse: Se não o aceitas, permite ao menos que se dê ao teu servo da terra deste país, tanto quanto possam carregar duas mulas, porque doravante este teu servo não oferecerá mais holocausto nem sacrifício a outros deuses, mas só ao Senhor.
18 I pray make God forgive mi for dis tins: Wen my oga wey bi Siria king dey go woship en juju Rimmon for en temple, I go nid to follow am go, bikos na mi bi en rite-hand-man. But make God forgive mi even as I go bow to Rimmon for di temple.”
18 Entretanto, que o Senhor perdoe ao teu servo no seguinte: Quando o meu soberano entrar no templo de Remon para adorar, apoiando-se no meu braço, e que eu também me prostrar no templo de Remon, que o Senhor perdoe esse gesto ao teu servo.
19 So Elisha tell am, “Make peace follow yu as yu dey go.”
19 Eliseu respondeu: Faze-o tranqüilamente. E Naamã o deixou.
20 Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”
20 Naamã estava já a certa distância, quando Giezi, servo de Eliseu, disse consigo: Eis que meu amo poupou a esse sírio, Naamã, recusando aceitar de sua mão o que ele tinha trazido. Pela vida de Deus! Vou correr atrás dele, e obterei dele alguma coisa.
21 So Gehazi porshu Naaman. Wen Naaman si sey pesin dey run kom meet am, e kom down from en horse kon ask, “Hope evritin dey okay?”
21 E Giezi foi ao alcance de Naamã, o qual, vendo-o correr, desceu do carro e veio-lhe ao encontro. E disse-lhe: Tudo vai bem?
22 Gehazi ansa, “Yes! Evritin dey okay. Na my oga send mi kom meet yu sey, ‘Two of di profets savant just kom meet mi from Efraim hill kountry. So make yu give dem silva wey heavy rish seventy-five pounds and two difren klot.’ ”
22 Sim, respondeu Giezi; meu senhor manda-me dizer-te: Acabam de chegar à minha casa, da montanha de Efraim, dois jovens, filhos de profetas. Rogo-te que me dês para eles um talento de prata e dois hábitos de festa.
23 So Naaman ansa, “Abeg make yu take silva wey heavy rish one hundred and fifty pounds.” E beg Gehazi well-well kon pak am inside two bags with two difren klot. Naaman give dis tins to two of en savant make dem karry am follow Gehazi.
23 Naamã respondeu: É melhor que leves dois talentos. Naamã insistiu e, atando dois talentos e dois hábitos de festa em dois sacos, entregou-os a dois de seus escravos para que os levassem a Giezi.
24 Wen Gehazi rish di hill, e karry di gift from dem kon keep am for en house. Den e tell di men make dem dey go, so dem kon go.
24 Quando atingiram a colina, Giezi tomou os objetos de suas mãos e guardou-os na sua casa. Depois disso, despediu os dois homens e estes se retiraram.
25 Leta wen Gehazi go stand near en masta, Elisha kon ask am, “Gehazi, where yu go since?”
25 E, tendo entrado, apresentou-se ao seu amo. Eliseu disse-lhe: De onde vens, Giezi? Teu servo não foi a parte alguma, respondeu ele.
26 Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.
26 Mas Eliseu replicou: Não estava porventura presente o meu espírito, quando um homem saltou de seu carro ao teu encontro? É este o momento de aceitar dinheiro, adquirir vestes, oliveiras e vinhas, ovelhas e bois, servos e servas?
27 Bikos of dis tin wey yu do so, Naaman diziz go katch yu and yor shidren-shidren forever.” So wen Gehazi komot from Elisha front, di diziz kon katch am and en body kon dey white like snow.
27 A lepra de Naamã se pegará a ti e a toda a tua descendência para sempre. E Giezi saiu da presença de Eliseu coberto de uma lepra branca como a neve.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.