2 Reis 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
1 Certo dia, a mulher de um dos discípulos dos profetas foi falar a Eliseu: "Teu servo, meu marido, morreu, e tu sabes que ele temia o Senhor. Mas agora veio um credor que está querendo levar meus dois filhos como escravos".
2 Elisha ask di woman, “Wetin yu wont make I do for yu?” Make yu tell mi, “Wetin yu get for yor house?”
2 Eliseu perguntou-lhe: "Como posso ajudá-la? Diga-me, o que você tem em casa? " E ela respondeu: "Tua serva não tem nada além de uma vasilha de azeite".
3 Den Elisha tell am, “Make yu go borrow plenty empty gallon kom.
3 Então disse Eliseu: "Vá pedir emprestadas vasilhas a todos os vizinhos. Mas, peça muitas.
4 Afta yu don borrow dem, make yu enter house kon lock yor door, den pour di oil put for all di gallons and wons one full, put am for korna.”
4 Depois entre em casa com seus filhos e feche a porta. Derrame daquele azeite em cada vasilha e vá separando as que você for enchendo".
5 So di woman leave am kon lock en and en sons wey bring di gallon, for inside dia house. Den e bigin pour di oil put for inside di gallons.
5 Depois disso, ela foi embora, fechou-se em casa com seus filhos e começou a encher as vasilhas que eles lhe traziam.
6 Wen dem don full, e kon tell en sons, “Make una bring anoda gallon kom.”
6 Quando todas as vasilhas estavam cheias, ela disse a um dos filhos: "Traga-me mais uma". Mas ele respondeu: "Já acabaram". Então o azeite parou de correr.
7 Den di woman go tell Elisha wetin happen and Elisha sey, “Go sell di oil, use di money take pay yor debt, den make yu and yor sons sell di rest kon use di money take buy food make una chop.”
7 Ela foi e contou tudo ao homem de Deus, que lhe disse: "Vá, venda o azeite e pague suas dívidas. E você e seus filhos ainda poderão viver do que sobrar".
8 One day, Elisha go Shunem, where one woman wey get money dey stay. Di woman kon sey make Elisha kom chop for en house, so wen ever Profet Elisha dey go Shunem, e go stop chop for der.
8 Certo dia, Eliseu foi a Suném, onde uma mulher rica insistiu que ele fosse tomar uma refeição em sua casa. Depois disso, sempre que passava por ali, ele parava para uma refeição.
9 Den di woman tell en husband, “My mind dey tell mi sey, dis man wey dey always pass and kom here, na God profet e bi,
9 De modo que ela disse ao marido: "Sei que esse homem que sempre vem aqui é um santo homem de Deus.
10 so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”
10 Vamos construir lá em cima um quartinho de tijolos e colocar nele uma cama, uma mesa, uma cadeira e uma lamparina para ele. Assim, sempre que nos visitar ele poderá ocupá-lo".
11 So one day, Elisha kom visit dem; den e go rest for di room for up.
11 Um dia, quando Eliseu chegou, subiu ao seu quarto e deitou-se.
12 E kon tell en savant Gehazi, “Make yu go koll di woman kom.” So di savant do as e tell am and di woman kon follow am kom.
12 Ele mandou o seu servo Geazi chamar a sunamita. Então ele a chamou, e quando ela veio,
13 Elisha tell Gehazi, “Make yu tell di woman, ‘Yu do well as yu dey kare for us, so wetin yu wont make wi do for yu? Abi yu wont make I go tell di king and en sojas oga sey yu bi good pesin?’ ”
13 Eliseu mandou que Geazi dissesse a ela: "Você teve todo este trabalho por nossa causa. O que podemos fazer por você? Quer que eu interceda por você junto ao rei ou ao comandante do exército? " Ela respondeu: "Estou bem entre minha própria gente".
14 So Elisha tell Gehazi, “So na wetin yu wont make I do for am?” Gehazi ansa, “Dis woman nor get pikin and en husband don old.”
14 Mais tarde Eliseu perguntou a Geazi: "O que se pode fazer por ela? " Ele respondeu: "Bem, ela não tem filhos, e seu marido é idoso".
15 Elisha kon sey, “Make yu koll am kom.” So Gehazi koll am and di woman kon stand for di door-mot.
15 Então Eliseu mandou chamá-la de novo. Geazi a chamou, e ela veio até a porta.
16 Den Elisha tell am, “For dis same time next year, yu go karry yor son for yor hand.”
16 E ele disse: "Por volta desta época, no ano que vem, você estará com um filho nos braços". Ela contestou: "Não, meu senhor. Não iludas a tua serva, ó homem de Deus! "
17 Just as Elisha don promise am, di woman get belle kon born for di time wey Elisha tok.
17 Mas, como Eliseu lhe dissera, a mulher engravidou e, no ano seguinte, por volta daquela mesma época, deu à luz um filho.
18 Di pikin kon dey grow well-well. One day, e follow en papa go farm,
18 O menino cresceu e, certo dia, foi encontrar seu pai, que estava com os ceifeiros.
19 den e kon dey kry give en papa sey, “My head! My head dey pain mi!”
19 De repente, ele começou a chamar o pai, gritando: "Ai, minha cabeça! Ai, minha cabeça! " Então o pai disse a um servo: "Leve-o para a mãe dele".
20 So, di savant karry am go meet en mama. Di pikin sidan for di mama leg till aftanoon, den e kon die.
20 O servo o pegou e o levou à mãe, o menino ficou no colo dela até o meio-dia, quando morreu.
21 So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
21 Ela subiu ao quarto do homem de Deus, deitou o menino na cama, saiu e fechou a porta.
22 E koll en husband kon sey, “Abeg make yu send one among yor savant and one donkey kom, so dat I go kwik rush go meet di profet kon kom back.”
22 Ela chamou o marido e disse: "Preciso de um servo e uma jumenta para ir falar com o homem de Deus. Vou e volto depressa".
23 But di husband ask, “Wetin make yu wont go si am today? Today nor bi new moon or Sabat Day.”
23 Ele perguntou: "Mas, por que hoje? Não é lua nova nem sábado! " Ela respondeu: "Não se preocupe".
24 Den e enter di donkey kon tell en savant, “Make yu drive fast as yu fit drive rish, unless I sey make yu slow.”
24 Ela mandou selar a jumenta, e disse ao servo: "Vamos rápido, só pare quando eu mandar".
25 So di woman drive go meet Profet Elisha for Mount Karmel.
25 Assim ela partiu para encontrar-se com o homem de Deus no monte Carmelo. Quando ele a viu a distância, disse a seu servo Geazi: "Olhe! É a sunamita!
26 Make yu run go meet am kon ask am, ‘Evritin dey okay? Yor husband dey okay? Wot about yor pikin, e dey okay?’ ” Wen di savant run go meet and ask am, di woman ansa am, “Evritin dey okay.”
26 Corra ao encontro dela e lhe pergunte: ‘Está tudo bem com você? Tudo bem com seu marido? E com seu filho? ’ " Ela respondeu a Geazi: "Está tudo bem".
27 Wen di woman waka meet di profet on-top di mountin, e kon fall hold am for leg. Gehazi won kon porshu am komot, but di profet sey, “Leave am, dis woman dey pass thru pain and God nor let mi know before naw.”
27 Ao encontrar o homem de Deus no monte, ela se abraçou aos seus pés. Geazi veio para afastá-la, mas o homem de Deus lhe disse: "Deixe-a em paz! Ela está muito angustiada, mas o Senhor nada me revelou e escondeu de mim a razão de sua angústia".
28 Den di woman sey, “My oga, na mi ask yu for pikin? I know tell yu sey, ‘Make yu nor deceive mi.’ ”
28 E disse a mulher: "Acaso eu te pedi um filho, meu senhor? Não te disse para não me dar falsas esperanças? "
29 So Elisha kon tell Gehazi, “Tie yor garment well make yu follow dis woman with my walkin stik. If yu meet anybody for road, make yu nor greet am and if anybody greet yu, make yu nor ansa. Den if yu rish here, take my walkin stik take tosh di pikin.”
29 Então Eliseu disse a Geazi: "Ponha a capa por dentro do cinto, pegue o meu cajado e corra. Se você encontrar alguém, não o cumprimente e, se alguém o cumprimentar, não responda. Quando lá chegar, ponha o meu cajado sobre o rosto do menino".
30 Den di pikin mama sey, “As long as God and yu dey alive, I nor go-go without yu.” So Elisha kon follow di woman go.
30 Mas a mãe do menino disse: "Juro pelo nome do Senhor e por tua vida que, se ficares, não irei". Então ele foi com ela.
31 Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”
31 Geazi chegou primeiro e pôs o cajado sobre o rosto do menino, mas ele não falou nem reagiu. Então Geazi voltou para encontrar-se com Eliseu e lhe disse: "O menino não voltou a si".
32 Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed.
32 Quando Eliseu chegou à casa, lá estava o menino, morto, estendido na cama.
33 So e enter inside di room, klose di door kon pray to God.
33 Ele entrou, fechou a porta e orou ao Senhor.
34 Den e stand up kon go sleep on-top di dead body. E use en own mout take kover di boy mout, en eye for di boy eye and e hold di boy hand tie, den e stresh ensef on-top di boy and di pikin body kon warm.
34 Então, deitou-se sobre o menino, boca a boca, olhos com olhos, mãos com mãos. Enquanto se debruçava sobre ele, o corpo do menino foi se aquecendo.
35 Den Elisha get up kon dey waka up-and-down for di house. E waka go meet di pikin kon sleep on-top am again, den di boy kough seven times kon open en eye.
35 Eliseu levantou-se e começou a andar pelo quarto; depois subiu na cama e debruçou-se mais uma vez sobre ele. O menino espirrou sete vezes e abriu os olhos.
36 Elisha koll Gehazi kon sey, “Make yu go koll di Shunem woman kom.” So Gehazi go koll di woman. Elisha tell am, “Make yu go karry yor pikin.”
36 Eliseu chamou Geazi e o mandou chamar a sunamita. E ele obedeceu. Quando ela chegou, Eliseu disse: "Pegue seu filho".
37 Di woman bow kon use en face tosh groun for Elisha front, den e karry en pikin kon waka komot.
37 Ela entrou, prostrou-se a seus pés, curvando-se até o chão. Então pegou o filho e saiu.
38 Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”
38 Depois Eliseu voltou a Gilgal. Nesse tempo a fome assolava a região. Quando os discípulos dos profetas estavam reunidos com ele, ordenou ao seu servo: "Ponha o caldeirão no fogo e faça um ensopado para estes homens".
39 So, one among dem enter di field go gada leaf and vine wey e go take kook. Wen e kom back, e kut dem put for di stew, but dem nor know wetin dem dey do or wish kind leaf e bi.
39 Um deles foi ao campo apanhar legumes e encontrou uma trepadeira. Apanhou alguns de seus frutos e encheu deles o seu manto. Quando voltou, cortou-os em pedaços e colocou-os no caldeirão do ensopado, embora ninguém soubesse o que era.
40 Dem serve some give di men make dem chop, but as dem chop di stew, dem kon shaut dey sey, “Profet! Dis pot of stew go kill us o-o!” So dem nor fit chop am.
40 O ensopado foi servido aos homens, mas, logo que o provaram, eles gritaram: "Homem de Deus, há morte na panela! " E não puderam mais tomá-lo.
41 Den Elisha sey, “Make una give mi some flower.” E pour di flower inside di pot kon sey, “Serve some give di men make dem chop.” So di food kon dey good to chop.
41 Então Eliseu pediu um pouco de farinha, colocou no caldeirão e disse: "Sirvam a todos". E já não havia mais perigo no caldeirão.
42 Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”
42 Veio um homem de Baal-Salisa, trazendo ao homem de Deus vinte pães de cevada, feitos dos primeiros grãos da colheita, e também algumas espigas verdes. Então Eliseu ordenou ao seu servo: "Sirva a todos".
43 But Elisha savant sey, “Make I give twenty bread to dis hundred men?”
43 O auxiliar de Eliseu perguntou: "Como poderei servir isso a cem homens? " Eliseu, porém, respondeu: "Sirva a todos, pois assim diz o Senhor: ‘Eles comerão, e ainda sobrará’ ".
44 So e give di pipol and just as God tok, dem chop beleful and some still remain.
44 Então ele serviu a todos, e conforme a palavra do Senhor, eles comeram e ainda sobrou.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.