2 Reis 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Time kon rish wen God won take Elijah go heaven inside betta strong breeze. Elijah and Elisha dey travel kom from Gilgal.
1 Eis o que se passou no dia em que o Senhor arrebatou Elias ao céu num turbilhão: Elias e Eliseu partiram de Gálgala,
2 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait for mi, bikos God send mi go Bethel.”
2 e Elias disse a Eliseu: Fica aqui, porque o Senhor me mandou a Betel. Por Deus e por tua vida, respondeu Eliseu, não te deixarei. E desceram a Betel.
3 Den di profets sons wey dey Bethel kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?”
3 Os filhos dos profetas, que estavam em Betel, saíram ao encontro de Eliseu e disseram-lhe: Sabes que o Senhor vai tirar hoje o teu amo de sobre a tua cabeça? Sim, eu o sei: calai-vos!
4 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jeriko.”
4 Elias disse-lhe: Fica aqui, Eliseu, porque o Senhor manda-me a Jericó. Por Deus e por tua vida, respondeu ele, não te deixarei. E chegaram a Jericó.
5 Den di profets sons wey dey Jeriko kom meet and ask Elisha, “Yu know sey na today God won take yor oga komot yor hand?”
5 Os filhos dos profetas que estavam em Jericó foram ter com Eliseu e disseram-lhe: Sabes que o Senhor vai tirar hoje o teu amo de sobre a tua cabeça? Sim, eu o sei. Calai-vos.
6 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jordan River.”
6 Elias disse-lhe: Fica aqui, porque o Senhor manda-me ao Jordão. Por Deus e pela tua vida, respondeu Eliseu, não te deixarei. E partiram juntos.
7 Fifty student wey dey go profets skool kon stand dey look Elijah and Elisha as dem stand near Jordan River.
7 Seguiram-nos cinqüenta filhos de profetas os quais pararam ao longe, diante deles, enquanto Elias e Eliseu se detinham à beira do Jordão.
8 Elijah use en garment nak di wota and di wota divide into two. Den, two of dem waka pass for dry groun.
8 Elias tomou o seu manto, dobrou-o e feriu com ele as águas, que se separaram para as duas bandas, de modo que atravessaram ambos a pé enxuto.
9 Afta dem don waka pass, Elijah kon tell Elisha, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu, before God go take mi go heaven.”
9 Tendo passado, Elias disse a Eliseu: Pede-me algo antes que eu seja arrebatado de ti: que posso eu fazer por ti? Eliseu respondeu: Seja-me concedida uma porção dobrada do teu espírito.
10 Elijah kon ansa, “Wetin yu ask for so, nor dey eazy. But if yu si mi wen God dey karry mi go, yu go get am, but if yu nor si mi, yu nor go get am.”
10 Pedes uma coisa difícil, replicou Elias. Entretanto, se me vires quando eu for arrebatado de ti, isso te será dado: mas se não me vires, não te será dado.
11 As dem dey waka dey tok dey go, one shariot with fire kom out at wons kon separate dem two. Den strong breeze kon karry Elijah go heaven.
11 Continuando o seu caminho, entretidos a conversar, eis que de repente um carro de fogo com cavalos de fogo os separou um do outro, e Elias subiu ao céu num turbilhão.
12 As Elisha dey look, e kon dey shaut, “My papa, my papa, di shariot and sojas for Israel!” So e nor ever si Elijah again. Elisha kon tear en own klot to pieces. Strong breeze dey karry Elijah go heaven|alt="Elijah is carried to heaven in a whirlwind" src="co01167B.TIF" size="col" loc="2KG 2:10-12" copy="Cook" ref="2:12"
12 Vendo isso, Eliseu exclamou: Meu pai, meu pai! Carro e cavalaria de Israel! E não o viu mais. Tomando então as suas vestes, rasgou-as em duas partes.
13 Elisha take di garment wey fall from Elijah hand kon waka go back till e rish Jordan River wotaside.
13 Apanhou o manto que Elias deixara cair, e voltando até o Jordão, parou à beira do rio.
14 Den e take di garment wey Elijah drop for am take nak di wota kon sey, “Where di Oga wey bi Elijah God?” Den e nak di wota again and di wota divide into two. So Elisha kon waka pass go di oda side.
14 Tomou o manto que Elias deixara cair, feriu com ele as águas, dizendo: Onde está o Senhor, o Deus de Elias? Onde está ele? Tendo ferido as águas, estas separaram-se para um e outro lado, e Eliseu passou.
15 Wen di fifty student from Jeriko, si Elisha dey kom, dem kon sey, “Elijah spirit don enter Elisha.” Dem waka go meet am kon bow for en front.
15 Os filhos dos profetas que estavam em Jericó, vendo o que acontecera defronte deles, disseram: O Espírito de Elias repousa em Eliseu. Foram-lhe ao encontro, prostraram-se por terra diante dele,
16 Den dem tell Elisha, “Fifty strong men dey here with us wey bi yor savants, abeg make yu let dem go find yor oga. May bi God Spirit don karry am go put for one mountin or valley.”
16 e disseram: Sabe que entre os teus servos há cinqüenta homens valentes, que podem ir em busca do teu amo. Talvez o tenha arrebatado o Espírito do Senhor e atirado com ele para algum monte ou para algum vale. Não os mandeis, respondeu Eliseu.
17 But di student kon dey disturb am, so e kon sey, “Make una go fine am.” Dem send fifty men go fine am for three days, but dem nor si am.
17 Eles, porém, tanto insistiram que Eliseu teve vergonha {de recusar}: Mandai-os, disse ele. Mandaram, pois, cinqüenta homens, os quais procuraram Elias durante três dias, mas sem resultado.
18 Wen dem kom back kon meet Elisha for Jeriko, e kon tell dem, “I nor warn una sey make una nor go?”
18 Quando voltaram para Eliseu, que estava em Jericó, este disse-lhes: Não vos disse eu que não fôsseis?
19 Den di men for di town tell Elisha, “Awa oga! Even doh yu si sey di town dey for betta aria, di wota bad well-well and anytin wey dem plant for di land, nor dey grow.”
19 Os habitantes da cidade disseram a Eliseu: A cidade está muito bem situada, como o pode ver o meu senhor, mas as águas são más e tornam a terra estéril.
20 Den Elisha sey, “Make una give mi one bowl kon put salt for inside.”
20 Eliseu disse-lhes: Trazei-me um prato novo, e ponde nele sal. Eles lho trouxeram.
21 Elisha waka go where di wota for dey flow, pour salt put kon sey: “Dis na wetin God tok: ‘I don make dis wota good. E nor go ever kause deat or pain again.’ ”
21 Eliseu foi à fonte e deitou sal nela, dizendo: Eis o que diz o Senhor: Sanei estas águas, e elas não causarão mais nem morte, nem esterilidade.
22 So till today, di wota dey good, just as Elisha tok.
22 Ficaram as águas sadias e ainda o são, segundo a palavra que o Senhor tinha dito por Eliseu.
23 From Jeriko, Elisha kon go Bethel. As e dey waka for di street, some small-small boys kom outside from di town kon dey curse am dey sey, “Bololo head! Bololo head!”
23 Dali subiu a Betel. Enquanto ia pelo caminho, saíram da cidade alguns rapazes, e puseram-se a zombar dele, dizendo: Sobe, careca; sobe, careca!
24 So Elisha turn look dem kon curse dem with God name. Den two woman bear kom outside from di wood kon kill forty-two of di boys.
24 Eliseu, voltando-se para eles, olhou-os e amaldiçoou-os em nome do Senhor. Imediatamente saíram da floresta dois ursos e despedaçaram quarenta e dois daqueles rapazes.
25 From der, Elisha go Mount Karmel, den e kon go back to Samaria.
25 Dali se retirou para o monte Carmelo, de onde voltou para Samaria.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.