2 Reis 25

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.
1 Então, no nono ano do reinado de Zedequias, no décimo dia do décimo mês, Nabucodonosor, rei da Babilônia, marchou contra Jerusalém com todo o seu exército. Ele acampou em frente da cidade e construiu rampas de ataque ao redor dela.
2 En and en men dey der for two years and dat na di elevent year wen King Zedekaya dey rule.
2 A cidade foi mantida sob cerco até o décimo primeiro ano do reinado de Zedequias.
3 For di ninet day for di fourt mont for di same year wen honga for di town don strong well-well and all dia food don finish,
3 No nono dia do quarto mês, a fome na cidade havia se tornado tão severa que não havia nada para o povo comer.
4 di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.
4 Então o muro da cidade foi rompido, e todos os soldados fugiram de noite pela porta entre os dois muros próximos ao jardim do rei, embora os babilônios estivessem em torno da cidade. Fugiram na direção da Arabá,
5 But Babilon sojas porshu di king, katch am for Jeriko field and all en sojas run leave am.
5 mas o exército babilônio perseguiu o rei e o alcançou nas planícies de Jericó. Todos os seus soldados o abandonaram,
6 Dem katch di king kon karry am go meet King Nebukadnezzar for Riblah, where e for judge en matter.
6 e ele foi capturado. Foi levado até o rei da Babilônia, em Ribla, onde pronunciaram a sentença contra ele.
7 Dem kill all Zedekaya sons for Zedekaya present. So Babilon king sey make dem pul Zedekaya eyes komot kon shain am with bronze shain, den karry am go Babilon.
7 Executaram os filhos de Zedequias na sua frente; depois furaram seus olhos, prenderam-no com algemas de bronze e o levaram para a Babilônia.
8 For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.
8 No sétimo dia do quinto mês do décimo nono ano do reinado de Nabucodonosor, rei da Babilônia, Nebuzaradã, comandante da guarda imperial, conselheiro do rei da Babilônia, foi a Jerusalém.
9 E burn God Temple, di royal palis and all di house for Jerusalem.
9 Incendiou o templo do Senhor, o palácio real, todas as casas de Jerusalém e todos os edifícios importantes.
10 Babilon sojas wey kom with di soja oga kon distroy all di wall for Jerusalem.
10 Todo o exército babilônio, que acompanhava Nebuzaradã derrubou os muros de Jerusalém.
11 Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.
11 E ele levou para o exílio o povo que sobrou na cidade, os que passaram para o lado do rei da Babilônia e o restante da população.
12 But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.
12 Mas alguns dos mais pobres do país o comandante deixou para trás, para trabalharem nas vinhas e nos campos.
13 Babilon sojas break di two bronze pila wey dey God Temple, plus di stand wey dem dey move and di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” Dem karry di bronze dem go Babilon.
13 Os babilônios destruíram as colunas de bronze, os suportes e o tanque de bronze que estavam no templo do Senhor, e levaram o bronze para a Babilônia.
14 Dem still karry di pots, shovels, trimmin shear, pans and all di tins wey dem make with bronze wey di priest dey use.
14 Também levaram as panelas, as pás, os cortadores de pavio, as vasilhas e todos os utensílios de bronze utilizados no serviço do templo.
15 Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.
15 O comandante da guarda imperial levou os incensários e as bacias de aspersão, tudo o que era feito de ouro puro ou prata.
16 Di bronze tins wey King Solomon make for God Temple, plus di two pila, di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea,” di twelf bronze bull under “Di Sea” and di stand wey dem dey move, dey too heavy to karry.
16 As duas colunas, o tanque e os suportes, que Salomão fizera para o templo do Senhor, eram mais do que podia ser pesado.
17 Each of di pilas high rish twenty-seven fit. Di bronze top for one pila high rish four and half fit and dem dekorate di bronze with pomegranate fruit. Na so too dem dekorate di sekond pila.
17 Cada coluna tinha oito metros e dez centímetros de altura. O capitel de bronze no alto de cada coluna tinha um metro e trinta e cinco centímetros de altura e era decorado com uma fileira de romãs de bronze ao redor.
18 Nebuzaradan katch Priest Seraya, Zefanaya di sekond priest and di three pipol wey dey guide di gate, den e karry dem go as prisonas.
18 O comandante da guarda levou como prisioneiros o sumo sacerdote, Seraías, Sofonias, o segundo sacerdote, e os três guardas da porta.
19 From di town, e still take one among di sojas offisa, five pipol from di king adviser wey dem si for di town, one seketry among di sojas wey dey train pipol as sojas and sixty pipol from di land wey dem seize.
19 Dos que ainda estavam na cidade, ele levou o oficial responsável pelos homens de combate e cinco conselheiros reais. Também levou o secretário, principal líder responsável pelo alistamento militar no país e sessenta homens do povo.
20 Nebuzaradan karry dem go meet King Nebukadnezzar for Riblah.
20 O comandante Nebuzaradã levou a todos ao rei da Babilônia, em Ribla.
21 King Nebukadnezzar sey make dem kill all of dem for Riblah wey dey near Hamat. Na so dem take karry Judah pipol komot from dia land.
21 Lá, em Ribla, na terra de Hamate, o rei mandou executá-los. Assim Judá foi para o exílio, para longe de sua terra.
22 Naw, King Nebukadnezzar for Babilon kon make Gedalaya wey bi Ahikam pikin and Shafan grand-pikin, govnor ova Judah pipol wey dey en land.
22 Nabucodonosor, rei da Babilônia, nomeou Gedalias, filho de Aicam e neto de Safã, como governador do povo que havia sido deixado em Judá.
23 All di offisa for Judah sojas and dia men hear sey Babilon king don make Gedalaya govnor for Judah. So dem kon go meet Gedalaya for Mizpa. Di ofisas wey kom na, Netanaya pikin, Ishmael; Kareah pikin, Johanan; Tanhumet pikin, Seraya and Maakat pikin, Jaazanaya.
23 Quando Ismael, filho de Netanias, Joanã, filho de Careá, Seraías, filho do netofatita Tanumete, e Jazanias, filho de um maacatita, todos os líderes do exército, souberam que o rei da Babilônia havia nomeado Gedalias como governador, eles e seus soldados foram falar com Gedalias em Mispá.
24 Gedalaya kon promise sey e go save dem and dia men. E sey, “Make una nor fear to work with Babilon sojas. Make una stay for di land kon surenda to King Nebukadnezzar, den evritin go dey well.”
24 Gedalias fez um juramento a esses líderes e a seus soldados, dizendo: "Não tenham medo dos oficiais babilônios. Estabeleçam-se nesta terra e sirvam o rei da Babilônia, e tudo lhes irá bem".
25 But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
25 Mas no sétimo mês, Ismael, filho de Netanias e neto de Elisama, que tinha sangue real, foi com dez homens e assassinou Gedalias e os judeus e os babilônios que estavam com ele em Mispá.
26 Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.
26 Então todo o povo, desde as crianças até os velhos, juntamente com os líderes do exército, fugiram para o Egito, com medo dos babilônios.
27 For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.
27 No trigésimo sétimo ano do exílio de Joaquim, rei de Judá, no ano em que Evil-Merodaque se tornou rei da Babilônia, ele tirou Joaquim da prisão, no dia vinte e sete do décimo segundo mês.
28 E sorry and trit King Jehoiashin well kon gi-am house wey betta pass where all di oda kings for Babilon dey stay.
28 Ele lhe tratou com bondade e deu-lhe o lugar mais honrado entre os outros reis que estavam com ele na Babilônia.
29 E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol,
29 Assim, Joaquim deixou suas vestes de prisão e pelo resto de sua vida comeu à mesa do rei.
30 so King Evil-Merodak dey give Jehoiashin evritin wey e wont until Jehoiashin die.
30 E diariamente, enquanto viveu, Joaquim recebeu uma pensão do rei.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.