2 Reis 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 King Josaya gada all di leaders for Judah and Jerusalem togeda
1 Então, deu ordem o rei, e todos os anciãos de Judá e de Jerusalém se ajuntaram a ele.
2 kon go God Temple and all di pipol for Judah, doz for Jerusalem, di priests and di profets kon follow am. All di pipol dey der, both small pikin, yong men and old pipol. E read di kovenant wey dey di book wey dem si for di temple.
2 O rei subiu à Casa do Senhor , e com ele todos os homens de Judá, todos os moradores de Jerusalém, os sacerdotes, os profetas e todo o povo, desde o menor até ao maior; e leu diante deles todas as palavras do Livro da Aliança que fora encontrado na Casa do Senhor .
3 Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
3 O rei se pôs em pé junto à coluna e fez aliança ante o Senhor , para o seguirem, guardarem os seus mandamentos, os seus testemunhos e os seus estatutos, de todo o coração e de toda a alma, cumprindo as palavras desta aliança, que estavam escritas naquele livro; e todo o povo anuiu a esta aliança.
4 Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
4 Então, o rei ordenou ao sumo sacerdote Hilquias, e aos sacerdotes da segunda ordem, e aos guardas da porta que tirassem do templo do Senhor todos os utensílios que se tinham feito para Baal, e para o poste-ídolo, e para todo o exército dos céus, e os queimou fora de Jerusalém, nos campos de Cedrom, e levou as cinzas deles para Betel.
5 E kill all di priest wey nor know God wey Judah kings bin choose sey na dem go dey offa sakrifice for di high place for di towns for Judah and di arias around Jerusalem. (Dem dey offa sakrifice to Baal, di sun and moon; to di planets and all di stars for di sky.)
5 Também destituiu os sacerdotes que os reis de Judá estabeleceram para incensarem sobre os altos nas cidades de Judá e ao redor de Jerusalém, como também os que incensavam a Baal, ao sol, e à lua, e aos mais planetas, e a todo o exército dos céus.
6 E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.
6 Também tirou da Casa do Senhor o poste-ídolo, que levou para fora de Jerusalém até ao vale de Cedrom, no qual o queimou e o reduziu a pó, que lançou sobre as sepulturas do povo.
7 Di men ashawo house wey dey di temple and di place where wimen for dey weave for Asherah juju, e distroy dem.
7 Também derribou as casas da prostituição cultual que estavam na Casa do Senhor , onde as mulheres teciam tendas para o poste-ídolo.
8 E bring all di priests from Judah kon skata di high place where dem for dey offa sakrifice from Gibeah go rish Beersheba. E skata di high place dem for di goat juju wey dey di door-mot for Joshua gate wey bi di main town wey dey di left side.
8 A todos os sacerdotes trouxe das cidades de Judá e profanou os altos em que os sacerdotes incensavam, desde Geba até Berseba; e derribou os altares das portas, que estavam à entrada da porta de Josué, governador da cidade, à mão esquerda daquele que entrava por ela.
9 (For dis time, di priests for di high place dem nor go God altar for Jerusalem go serve am, but dem follow di oda priests chop from di bread wey nor get yist).
9 (Mas os sacerdotes dos altos não sacrificavam sobre o altar do Senhor , em Jerusalém; porém comiam pães asmos no meio de seus irmãos.)
10 Di king skata Tofet for Ben-Hinnom Valley, so dat nobody go fit sakrifice en pikin for Molek juju again.
10 Também profanou a Tofete, que está no vale dos filhos de Hinom, para que ninguém queimasse a seu filho ou a sua filha como sacrifício a Moloque.
11 All di horse image wey di kings for Judah put for di temple gate to take woship di sun, di king skata all of dem. (Dem keep dem near Natan Melek; di lawyer room wey dey near di kourtyard.) Di king burn all di shariot wey dem take dey woship di sun.
11 Também tirou os cavalos que os reis de Judá tinham dedicado ao sol, à entrada da Casa do Senhor , perto da câmara de Natã-Meleque, o camareiro, a qual ficava no átrio; e os carros do sol queimou.
12 Di altars wey Judah kings build for Ahaz room for up, plus di one wey Manasseh build for di two kourtyard for God Temple, di king burn all of dem kon trow dia ashes for Kidron Valley.
12 Também o rei derribou os altares que estavam sobre a sala de Acaz, sobre o terraço, altares que foram feitos pelos reis de Judá, como também os altares que fizera Manassés nos dois átrios da Casa do Senhor ; e, esmigalhados, os tirou dali e lançou o pó deles no ribeiro de Cedrom.
13 Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.
13 O rei profanou também os altos que estavam defronte de Jerusalém, à mão direita do monte da Destruição, os quais edificara Salomão, rei de Israel, para Astarote, abominação dos sidônios, e para Quemos, abominação dos moabitas, e para Milcom, abominação dos filhos de Amom.
14 E skata dia juju pila finish kon kut Asherah juju pole rish groun, den e pak human being bones full di shrine.
14 Semelhantemente, fez em pedaços as colunas e cortou os postes-ídolos; e o lugar onde estavam encheu ele de ossos humanos.
15 E still skata di altar for Bethel and na Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin, build am. Den e burn all di high place to ashes kon distroy Asherah juju.
15 Também o altar que estava em Betel e o alto que fez Jeroboão, filho de Nebate, que tinha feito pecar a Israel, esse altar junto com o alto o rei derribou; destruiu o alto, reduziu a pó o seu altar e queimou o poste-ídolo.
16 As King Josaya turn, e kon si di grave for di mountin, so e sey make dem bring di bones kom out. E burn dem for di altar kon skata di ashes. Dis tin happen, just as God tok thru en profet for di time wey King Jeroboam stand for di altar, wen dem dey do one feast. King Josaya turn kon si di grave of di profet wey tok dis tins.
16 Olhando Josias ao seu redor, viu as sepulturas que estavam ali no monte; mandou tirar delas os ossos, e os queimou sobre o altar, e assim o profanou, segundo a palavra do Senhor , que apregoara o homem de Deus que havia anunciado estas coisas.
17 E kon ask, “Wetin bi dis sign wey I dey si so?” Di men from di town kon ansa, “Di profet wey kom from Bethel kon tok about dis tin wey yu don do to Jeroboam grave and Bethel altar, na en grave bi dis.”
17 Então, perguntou: Que monumento é este que vejo? Responderam-lhe os homens da cidade: É a sepultura do homem de Deus que veio de Judá e apregoou estas coisas que fizeste contra o altar de Betel.
18 Di king kon sey, “Make una nor skata or tosh en grave! Make nobody disturb am at-all.” So dem leave di profet grave, plus all di oda profets for Israel wey dem beri for der.
18 Josias disse: Deixai-o estar; ninguém mexa nos seus ossos. Assim, deixaram estar os seus ossos com os ossos do profeta que viera de Samaria.
19 King Josaya still distroy all di shrine for di high place for Samaria town. Na Israel kings build dem and dem dey make God vex. As e take distroy di altar for Bethel, na so too e distroy all dis ones.
19 Também tirou Josias todos os santuários dos altos que havia nas cidades de Samaria e que os reis de Israel tinham feito para provocarem o Senhor à ira; e lhes fez segundo todos os atos que tinha praticado em Betel.
20 All di priests for di high place, e sakrifice dem for di altars wey dey der kon burn human being bones for der. Den e go back to Jerusalem.
20 E matou todos os sacerdotes dos altos que havia ali, sobre os altares, e queimou ossos humanos sobre eles; depois, voltou para Jerusalém.
21 Di king kommand di pipol, “Make una dey obey di Oga una God Passova, just as E dey dis kovenant book.”
21 Deu ordem o rei a todo o povo, dizendo: Celebrai a Páscoa ao Senhor , vosso Deus, como está escrito neste Livro da Aliança.
22 E tok like dis bikos, dem neva celebrate Passova afta di time wey judge rule di kountry. Since dat time, no king for Israel or Judah don celebrate am.
22 Porque nunca se celebrou tal Páscoa como esta desde os dias dos juízes que julgaram Israel, nem durante os dias dos reis de Israel, nem nos dias dos reis de Judá.
23 But for eighteen years wen King Josaya dey rule, dem kon celebrate God Passova for Jerusalem.
23 Corria o ano décimo oitavo do rei Josias, quando esta Páscoa se celebrou ao Senhor , em Jerusalém.
24 King Josaya still distroy all di pit from where dem for dey koll evil spirit kom out. Di pipol wey dey do majik; dia juju for house; di yeye image and all di juju wey dey for Judah and Jerusalem land, e distroy dem too. Like dis, e kon do all di tins wey dem rite for di book wey Priest Hilkaya si for di temple.
24 Aboliu também Josias os médiuns, os feiticeiros, os ídolos do lar, os ídolos e todas as abominações que se viam na terra de Judá e em Jerusalém, para cumprir as palavras da lei, que estavam escritas no livro que o sacerdote Hilquias achara na Casa do Senhor .
25 E nor get any king before or afta wey turn kom meet God like King Josaya wey use en whole heart take serve God, just as Moses Law tok.
25 Antes dele, não houve rei que lhe fosse semelhante, que se convertesse ao Senhor de todo o seu coração, e de toda a sua alma, e de todas as suas forças, segundo toda a Lei de Moisés; e, depois dele, nunca se levantou outro igual.
26 Plus all dis ones, God still dey vex for Judah, bikos of all di wiked tins wey Manasseh do.
26 Nada obstante, o Senhor não desistiu do furor da sua grande ira, ira com que ardia contra Judá, por todas as provocações com que Manassés o tinha irritado.
27 God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”
27 Disse o Senhor : Também a Judá removerei de diante de mim, como removi Israel, e rejeitarei esta cidade de Jerusalém, que escolhi, e a casa da qual eu dissera: Estará ali o meu nome.
28 Di remainin tins wey Josaya do plus evritin wey e get, dem rite am put for Judah kings history book.
28 Quanto aos mais atos de Josias e a tudo quanto fez, porventura, não estão escritos no Livro da História dos Reis de Judá?
29 Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.
29 Nos dias de Josias, subiu Faraó-Neco, rei do Egito, contra o rei da Assíria, ao rio Eufrates; e, tendo saído contra ele o rei Josias, Neco o matou, em Megido, no primeiro encontro.
30 King Josaya savant karry en oga dead body from Megiddo on-top horse go back to Jerusalem for where dem for beri am for en grave. Di pipol for di land take Josaya pikin, Jehoahaz, pour olive oil for en head kon make am king for Judah.
30 De Megido, os seus servos o levaram morto e, num carro, o transportaram para Jerusalém, onde o sepultaram no seu jazigo. O povo da terra tomou a Joacaz, filho de Josias, e o ungiu, e o fez rei em lugar de seu pai.
31 Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin.
31 Tinha Joacaz vinte e três anos de idade quando começou a reinar e reinou três meses em Jerusalém. Sua mãe chamava-se Hamutal e era filha de Jeremias, de Libna.
32 E nor gri follow God kommand, just like en grand-grand papa dem.
32 Fez ele o que era mau perante o Senhor , segundo tudo que fizeram seus pais.
33 Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.
33 Porém Faraó-Neco o mandou prender em Ribla, na terra de Hamate, para que não reinasse em Jerusalém; e impôs à terra a pena de cem talentos de prata e um de ouro.
34 Fero Neko make Josaya pikin Eliakim king kon shange en name to Jehoiakim. E take Jehoahaz go Egypt where e for die.
34 Faraó-Neco também constituiu rei a Eliaquim, filho de Josias, em lugar de Josias, seu pai, e lhe mudou o nome para Jeoaquim; porém levou consigo para o Egito a Joacaz, que ali morreu.
35 Jehoiakim dey give Fero di normal amount wey e sey make dem dey gi-am. But to make sure sey e meet dis payment, e kon dey tax di pipol for di land. E dey kollect plenty money from each pesin, so dat e go fit pay Fero Neko.
35 Jeoaquim deu aquela prata e aquele ouro a Faraó; porém estabeleceu imposto sobre a terra, para dar esse dinheiro segundo o mandado de Faraó; do povo da terra exigiu prata e ouro, de cada um segundo a sua avaliação, para o dar a Faraó-Neco.
36 Jehoiakim na twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama na Zebidah wey bi Pedaaya from Rumah pikin.
36 Tinha Jeoaquim a idade de vinte e cinco anos quando começou a reinar e reinou onze anos em Jerusalém. Sua mãe se chamava Zebida e era filha de Pedaías, de Ruma.
37 E nor gri obey God, just like en grand-grand papa dem.
37 Fez ele o que era mau perante o Senhor , segundo tudo quanto fizeram seus pais.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.