2 Reis 21

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah.
1 Manassés tinha doze anos quando começou a reinar, e reinou cinqüenta e cinco anos em Jerusalém. O nome de sua mãe era Hefzibá.
2 E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.
2 E fez o que era mau aos olhos do Senhor, conforme as abominações das nações que o Senhor desterrara de diante dos filhos de Israel.
3 E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.
3 Porque tornou a edificar os altos que Ezequias, seu pai, tinha destruído, e levantou altares a Baal, e fez uma Asera como a que fizera Acabe, rei de Israel, e adorou a todo o exército do céu, e os serviu.
4 E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.”
4 E edificou altares na casa do Senhor, da qual o Senhor tinha dito: Em Jerusalém porei o meu nome.
5 For di two kourtyard wey dey God Temple, e build altar for all di stars wey dey di sky.
5 Também edificou altares a todo o exército do céu em ambos os átrios da casa do Senhor.
6 E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
6 E até fez passar seu filho pelo fogo, e usou de augúrios e de encantamentos, e instituiu adivinhos e feiticeiros; fez muito mal aos olhos do Senhor, provocando-o à ira.
7 E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever.
7 Também pôs a imagem esculpida de Asera, que tinha feito, na casa de que o Senhor dissera a Davi e a Salomão, seu filho: Nesta casa e em Jerusalém, que escolhi dentre todas as tribos de Israel, porei o meu nome para sempre;
8 I nor go porshu Israel pipol from dis land wey I don give to dia grand-grand papa, as long as dem obey all di kommand and laws wey I give dem thru Moses, my savant.”
8 e não mais farei andar errante o pé de Israel desta terra que tenho dado a seus pais, contanto que somente tenham cuidado de fazer conforme tudo o que lhes tenho ordenado, e conforme toda a lei que Moisés, meu servo, lhes ordenou.
9 But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.
9 Eles, porém, não ouviram; porque Manassés de tal modo os fez errar, que fizeram pior do que as nações que o Senhor tinha destruído de diante dos filhos de Israel.
10 So God kon tok thru en savant di profet sey:
10 Então o Senhor falou por intermédio de seus servos os profetas, dizendo:
11 “King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.
11 Porquanto Manassés, rei de Judá, cometeu estas abominações, fazendo pior do que tudo quanto fizeram os amorreus, que foram antes dele, e com os seus ídolos fez Judá também pecar;
12 So dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok, ‘I go kause wahala for Jerusalem and Judah pipol. And e go shok anybody wey go hear wetin happen.
12 por isso assim diz o Senhor Deus de Israel: Eis que trago tais males sobre Jerusalém e Judá, que a qualquer que deles ouvir lhe ficarão retinindo ambos os ouvidos.
13 As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.
13 Estenderei sobre Jerusalém o cordel de Samária e o prumo da casa de Acabe; e limparei Jerusalém como quem limpa a escudela, limpando-a e virando-a sobre a sua face.
14 Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,
14 Desampararei os restantes da minha herança, e os entregarei na mão de seus inimigos. tornar-se-ão presa e despojo para todos os seus inimigos;
15 bikos dem don sin against mi kon make mi dey vex since wen dia grand-grand papa komot from Egypt kon rish naw!’ ”
15 porquanto fizeram o que era mau aos meus olhos, e me provocaram à ira, desde o dia em que seus pais saíram do Egito até hoje.
16 Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
16 Além disso, Manassés derramou muitíssimo sangue inocente, até que encheu Jerusalém de um a outro extremo, afora o seu pecado com que fez Judá pecar fazendo o que era mau aos olhos do Senhor.
17 Di remainin tins wey Manasseh do, plus all wetin e get and di sins wey e kommit, dem rite dem put for Judah kings history book.
17 Quanto ao restante dos atos de Manassés, e a tudo quanto fez, e ao pecado que cometeu, porventura não estão escritos no livro das crônicas dos reis de Judá?
18 Manasseh die and dem beri am for Uzza gardin wey dey en palis and en pikin, Amon kon take-ova as king.
18 E Manassés dormiu com seus pais, e foi sepultado no jardim da sua casa, no jardim de Uzá. E Amom, seu filho, reinou em seu lugar.
19 Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman.
19 Amom tinha vinte e dois anos quando começou a reinar, e reinou dois anos em Jerusalém. O nome de sua mãe era Mesulemete, filha de Haniz, de Jotba.
20 E nor gri obey God kommand, but e sin like en papa Manasseh.
20 Ele fez o que era mau aos olhos do Senhor, como fizera Manassés, seu pai;
21 E dey do like en papa, bikos en too dey woship and bow to yeye gods and juju wey en papa woship.
21 e andou em todo o caminho em que seu pai andara, e serviu os ídolos que ele tinha servido, e os adorou.
22 E nor gri follow en grand-grand papa dem Oga wey bi God or listin to en kommand.
22 Assim deixou o Senhor, Deus de seus pais, e não andou no caminho do Senhor.
23 Amon savants kon plan and kill-am for en palis.
23 E os servos de Amom conspiraram contra ele, e o mataram em sua casa.
24 Di pipol for di land kon kill all doz wey plan kill King Amon, den dem kon make en pikin Josaya, king for Judah.
24 O povo da terra, porém, matou a todos os que conspiraram contra o rei Amom, e constituiu Josias, seu filho, rei em seu lugar.
25 Di remainin tins wey Amon do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book.
25 Quanto ao restante dos atos de Amom, porventura não está escrito no livro das crônicas dos reis de Judá?
26 Dem beri am for en own grave for Uzza gardin and en pikin Josaya kon take-ova as king.
26 E o puseram na sua sepultura, no jardim de Uzá. E Josias, seu filho, reinou em seu lugar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.