2 Reis 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Afta Ahab don die, Moab pipol kon go fight Israel pipol.
1 Depois da morte de Acabe, Moabe rebelou-se contra Israel.
2 For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”
2 Certo dia, Acazias caiu da sacada do seu quarto no palácio de Samaria, e ficou muito ferido. Então enviou mensageiros para consultar Baal-Zebube, deus de Ecrom, para saber se ele se recuperaria.
3 But God angel tell Profet Elijah wey kom from Tishbe, “Get up! Go meet di messenjas wey Samaria king send kon tell dem, ‘Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God?
3 Mas o anjo do Senhor disse ao tesbita Elias: "Vá encontrar-se com os mensageiros do rei de Samaria e lhes pergunte: ‘Acaso não há Deus em Israel? Por que vocês vão consultar Baal-Zebube, deus de Ecrom? ’
4 So make una hear wetin God dey tell di king: “Yu nor go stand up from di bed wey yu dey so, bikos yu must die!” ’ ” So Elijah kon go.
4 Por isso, assim diz o Senhor: ‘Você não se levantará mais dessa cama e certamente morrerá! ’ " E assim Elias se foi.
5 Wen di messenjas go back, di king kon ask dem, “Wetin make una kwik kom back like dis?”
5 Quando os mensageiros voltaram ao rei, ele lhes perguntou: "Por que vocês voltaram? "
6 Dem ansa, “One man tell us, ‘Make una go back go tell di king sey, “Dis na wetin God tok: Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God? So di king nor go stand up from di bed wey e dey so, bikos e go die.” ’ ”
6 Eles responderam: "Um homem veio ao nosso encontro e nos disse: ‘Voltem ao rei que os enviou e digam-lhe: Assim diz o Senhor: "Acaso não há Deus em Israel? Por que você mandou consultar Baal-Zebube, deus de Ecrom? Por isso você não se levantará mais dessa cama e certamente morrerá! " ’ "
7 Di king kon ask dem, “Make una diskribe di man wey tell una all dis tin.”
7 O rei lhes perguntou: "Como era o homem que os encontrou e lhes disse isso? "
8 Dem ansa, “E get hair full en body kon tie leda belt for waist.”
8 Eles responderam: "Ele vestia roupas de pêlos e usava um cinto de couro". O rei concluiu: "Era o tesbita Elias".
9 Den di king send one offisa with fifty sojas make dem go arrest Elijah kom. Dem go meet Elijah for where e sidan on-top hill kon tell am, “Profet! Di king sey make yu follow us kom!”
9 Em seguida mandou um oficial com cinqüenta soldados procurar Elias. O oficial o encontrou sentado no alto de uma colina, e lhe disse: "Homem de Deus, o rei ordena que você desça"
10 Elijah ansa di soja oga, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down, burn all of dem.
10 Elias respondeu ao oficial: "Se sou homem de Deus, que desça fogo do céu e consuma você e seus cinqüenta soldados! " E desceu fogo do céu e consumiu o oficial e seus soldados.
11 Di king send anoda offisa and fifty sojas go again. Di offisa tell Elijah sey, “Profet! Di king sey make yu follow us kom.”
11 Depois disso o rei enviou outro oficial com mais cinqüenta soldados. E ele disse a Elias: "Homem de Deus o rei ordena que você desça imediatamente".
12 Den Elijah ansa, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down kon burn all of dem.
12 Respondeu Elias: "Se sou homem de Deus, que desça fogo do céu e consuma você e seus cinqüenta soldados! " De novo fogo de Deus desceu do céu e consumiu o oficial e seus soldados.
13 Di king still send anoda offisa and fifty sojas go. Dis third offisa go meet Elijah kon fall for en front dey beg am, “Profet! Abeg, make yu nor kill mi and my men wey bi yor savants.
13 Então o rei enviou um terceiro oficial com outros cinqüenta soldados. O oficial subiu o monte, caiu de joelhos diante de Elias e implorou: "Homem de Deus, tenha consideração por minha vida e pela vida destes cinqüenta soldados, teus servos!
14 True-true, wi know sey, fire kom down from heaven kon kill di two ofisas with dia men wey first kom. So wi dey beg make yu nor kill us.”
14 Sei que desceu fogo do céu e consumiu os dois primeiros oficiais com todos os seus soldados. Mas agora tenha consideração por minha vida! "
15 So God angel tell Elijah, “Make yu follow am go meet di king. Make fear nor katch yu at-all.” So Elijah stand up kon follow am go meet di king.
15 O anjo do Senhor disse a Elias: "Acompanhe-o; não tenha medo dele". Então Elias se levantou, desceu com ele e foi falar com o rei.
16 Elijah tell di king, “Dis na wetin God tok, ‘Wetin make yu send pipol go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos yu tink sey Israel pipol nor get God wey yu fit ask? Bikos of dis, yu nor go stand from di bed wey yu dey so and yu must die.’ ”
16 Ao chegar, disse ao rei: "Assim diz o Senhor: Acaso não há Deus em Israel? Por que você mandou consultar Baal-Zebube, deus de Ecrom? Por isso, você não se levantará mais dessa cama e certamente morrerá! "
17 Di king die just as God tok thru Elijah.
17 E Acazias morreu, conforme a palavra do Senhor, anunciada por Elias. Como não tinha filhos, Jorão foi o seu sucessor no segundo ano do reinado de Jeorão, rei de Judá, filho de Josafá.
18 Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.
18 Os demais acontecimentos do reinado de Acazias e suas realizações estão escritos nos registros históricos dos reis de Israel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.