2 Reis 18

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 For di third year wen King Hoshea, Elah pikin dey rule for Israel, Ahaz pikin, Hezekaya kon bi king for Judah.
1 No terceiro ano do reinado de Oséias, filho de Elá, rei de Israel, Ezequias, filho de Acaz, rei de Judá, começou a reinar.
2 E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for twenty-nine years. En mama name na Abi wey bi Zekaraya pikin.
2 Ele tinha vinte e cinco anos de idade quando começou a reinar, e reinou vinte e nove anos em Jerusalém. O nome de sua mãe era Abia, filha de Zacarias.
3 E obey God, just like en grand-grand papa David.
3 Ele fez o que o Senhor aprova, tal como tinha feito Davi, seu predecessor.
4 E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
4 Removeu os altares idólatras, quebrou as colunas sagradas e derrubou os postes sagrados. Despedaçou a serpente de bronze que Moisés havia feito, pois até àquela época os israelitas lhe queimavam incenso. Ela era chamada Neustã.
5 E trust di Oga wey bi Israel God; so e nor get any king like am wey don rule Judah before or wey go rule Judah again.
5 Ezequias confiava no Senhor, o Deus de Israel. Nunca houve ninguém como ele entre todos os reis de Judá, nem antes nem depois dele.
6 E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.
6 Ele se apegou ao Senhor e não deixou de segui-lo; obedeceu aos mandamentos que o Senhor tinha dado a Moisés.
7 God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem.
7 E o Senhor estava com ele; era bem sucedido em tudo o que fazia. Rebelou-se contra o rei da Assíria e deixou de submeter-se a ele.
8 E win Filistia pipol for Gaza and di aria wey dey near der; rite from dia gate go rish di towns wey dem guide well-well for der.
8 Desde a torre de sentinela até à cidade fortificada, ele derrotou os filisteus, até Gaza e o seu território.
9 For di fourt year wen King Hezekaya dey rule (dat na seven years wey Elah pikin, King Hoshea don dey rule for Israel), King Shalmanesa for Assyria go fight Samaria kon surround di town.
9 No quarto ano do reinado do rei Ezequias, o sétimo ano do reinado de Oséias, filho de Elá, rei de Israel, Salmaneser, rei da Assíria, marchou contra Samaria e a cercou.
10 Afta three years, e kon seize Samaria (dat na di six years wey Hezekaya don dey rule) and na nine years wey King Hoshea don dey rule for Israel.
10 Ao fim de três anos, os assírios a tomaram. Assim a cidade foi conquistada no sexto ano do reinado de Ezequias, o nono ano do reinado de Oséias, rei de Israel.
11 Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town.
11 O rei assírio deportou os israelitas para a Assíria e os estabeleceu em Hala, em Gozã do rio Tabor e nas cidades dos medos.
12 Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.
12 Isto aconteceu porque os israelitas não obedeceram ao Senhor seu Deus, mas violaram a sua aliança: tudo o que Moisés, o servo do Senhor, tinha ordenado. Não o ouviram nem lhe obedeceram.
13 For fourteen years wen King Hezekaya dey rule, King Sennakerib for Assyria attack all di towns wey dem guide well-well for Judah kon seize dem.
13 No décimo quarto ano do reinado do rei Ezequias, Senaqueribe, rei da Assíria, atacou todas as cidades fortificadas de Judá e as conquistou.
14 King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya.
14 Então Ezequias, rei de Judá, enviou esta mensagem ao rei da Assíria, em Láquis: "Cometi um erro. Pára de atacar-me, e eu pagarei tudo que exigires". O rei da Assíria cobrou de Ezequias, rei de Judá, dez toneladas e meia de prata e uma tonelada e cinqüenta quilos de ouro.
15 King Hezekaya gi-am all di silva wey dey God Temple and for di palis.
15 Assim, Ezequias lhes deu toda a prata que se encontrou no templo e na tesouraria do palácio real.
16 For dat time, King Hezekaya for Judah, komot all di iron wey dem take make God Temple door kon give dem to Assyria king.
16 Nessa ocasião Ezequias, rei de Judá, retirou o ouro com que havia coberto as portas e batentes do templo do Senhor, e o deu ao rei da Assíria.
17 Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot.
17 De Láquis o rei da Assíria enviou ao rei Ezequias, em Jerusalém, seu general, seu oficial principal e seu comandante de campo com um grande exército. Eles subiram a Jerusalém e pararam no aqueduto do açude superior, na estrada que leva ao campo do Lavandeiro.
18 Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.
18 Eles chamaram pelo rei; e o administrador do palácio, Eliaquim, filho de Hilquias, o secretário Sebna e o arquivista real Joá, filho de Asafe, foram ao seu encontro.
19 Di shief adviser kon tell dem, “Make una tell Hezekaya sey:
19 O comandante de campo lhes disse: "Digam isto a Ezequias: Assim diz o grande rei, o rei da Assíria: Em que você baseia sua confiança?
20 To dey boast sey yu don plan well to fight mi, nor mean anytin. Na who dey give yu mind sey yu fit fight mi?
20 Você pensa que meras palavras já são estratégia e poderio militar. Em quem você está confiando para se rebelar contra mim?
21 Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am.
21 Você está confiando no Egito, aquele caniço quebrado, que espeta e perfura a mão do homem que nele se apóia! Assim o faraó, rei do Egito, retribui a quem confia nele.
22 May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”
22 Mas, se vocês me disserem: "Estamos confiando no Senhor nosso Deus"; não é ele aquele cujos santuários e altares Ezequias removeu, dizendo a Judá e Jerusalém: "Vocês devem adorar diante deste altar em Jerusalém? "
23 So, make yu follow my oga di king for Assyria enter agriment and e go give yu 2,000 horse as long as yu go fit find men wey go ride dem.
23 Aceite, pois, agora, o desafio do meu senhor, o rei da Assíria: Eu lhe darei dois mil cavalos; se você tiver cavaleiros para eles!
24 True-true, yu nor go sey no to even di smallest ofisas wey my masta get, bikos yu bilive sey Egypt pipol go kom help yu.
24 Como você pode derrotar o mais insignificante guerreiro do meu senhor? Você confia no Egito para lhe dar carros de guerra e cavaleiros?
25 I wont make yu know sey na as God kommand, I go take mash kon distroy dis place, bikos God sey, “Make yu mash go distroy dis land.” ’ ”
25 Além disso, será que vim atacar e destruir este local sem uma palavra da parte do Senhor? O próprio Senhor me disse que marchasse contra este país e o destruísse".
26 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Joah kon ansa di adviser sey, “Make yu use Aramaik language take tok to yor savant, bikos wi undastand am. Nor tok to us with Hibru bikos of di pipol.”
26 Então Eliaquim, filho de Hilquias, Sebna e Joá disseram ao comandante de campo: "Por favor, fala com teus servos em aramaico, porque entendemos essa língua. Não fales em hebraico, pois assim o povo que está sobre os muros entenderá".
27 But di shief adviser ansa, “My masta nor send mi sey make I kon tok dis message to only una and una oga. Dis message na for di pipol too wey sidan for di wall, bikos dem go chop dia own shit kon drink dia piss.”
27 O comandante, porém, respondeu: "Será que meu senhor enviou-me para dizer essas coisas, somente para o seu senhor e para você e não para os que estão sentados no muro, que, como vocês, terão de comer as próprias fezes e beber a própria urina? "
28 Di shief adviser kon from der shaut with Hibru language, “Make una listin to di message wey di great king for Assyria sey make I tell una.
28 Então o comandante levantou-se e gritou em hebraico: "Ouçam a palavra do grande rei, o rei da Assíria!
29 Dis na wetin di king tok: Make una nor let Hezekaya deceive una, bikos e nor go fit save una from my hand!
29 Assim diz o rei: Não deixem que Ezequias os engane. Ele não poderá livrá-los de minha mão.
30 Make una nor let Hezekaya tell una sey, ‘Make una trust God, bikos E go save us; so Assyria king nor go fit do us anytin.’
30 Não deixem Ezequias convencê-los a confiar no Senhor, quando diz: ‘Com certeza o Senhor nos livrará; esta cidade não será entregue nas mãos do rei da Assíria’.
31 “Make una nor listin to Hezekaya! Bikos Assyria king sey, ‘Make una rite leta kom sey una go respet am and do anytin wey e tok. Den each of una fit chop from di vine and fig kon drink wota from well,
31 Não dêem ouvidos a Ezequias. Assim diz o rei da Assíria: Façam paz comigo e rendam-se. Então cada um de vocês comerá de sua própria videira e de sua própria figueira e beberá água de sua própria cisterna,
32 until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’
32 até que eu venha e os leve para uma terra igual à de vocês, terra de cereais, de vinho, terra de pão e de vinhas, terra de oliveiras e de mel. Escolham a vida e não a morte! Não dêem ouvidos a Ezequias, pois ele os está iludindo, quando diz: ‘O Senhor nos livrará’.
33 E get any god for di oda kountry wey don save en pipol from Assyria king pawa?
33 Será que o deus de alguma nação conseguiu livrar sua terra das mãos do rei da Assíria?
34 Where di gods wey dey Hamat and Arpad? Where di gods wey dey Sefarvaim, Hena and Ivvah? True-true, una tink sey any god fit save Samaria from my pawa?
34 Onde estão os deuses de Hamate e de Arpade? Onde estão os deuses de Sefarvaim, Hena e Iva? Acaso livraram Samaria das minhas mãos?
35 Among all di gods for di land, na wish one don fit save en pipol and land from my pawa? So how God won kon take save Jerusalem and en pipol from my hand?”
35 Qual dentre todos os deuses dessas nações conseguiu livrar sua terra do meu poder? Como então o Senhor poderá livrar Jerusalém das minhas mãos? "
36 Di pipol kwayet and dem nor tok, bikos di king don tell dem sey, “Make nobody ansa.”
36 Mas o povo permaneceu calado e nada disse em resposta, pois o rei tinha ordenado: "Não lhe respondam".
37 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Asaf pikin Joah kon tear dia klot go meet and tell Hezekaya wetin di shief adviser tok.
37 Então o administrador do palácio, Eliaquim, filho de Hilquias, o secretário Sebna e o arquivista real Joá, filho de Asafe, retornaram com as vestes rasgadas a Ezequias e lhe relataram o que o comandante de campo tinha dito.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.