2 Reis 17
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 For twelf years wen King Ahaz dey rule Judah, Elah pikin, Hoshea kon bi king for Israel. E rule from Samaria for nine years.
1 No décimo segundo ano do reinado de Acaz, rei de Judá, Oséias, filho de Elá, tornou-se rei de Israel em Samaria, e reinou nove anos.
2 E nor gri obey God, but en own nor bad rish di tins wey di oda kings wey dey before am, do.
2 Ele fez o que o Senhor reprova, mas não como os reis de Israel que o precederam.
3 King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.
3 Salmaneser, rei da Assíria, foi atacar Oséias, que fora seu vassalo e lhe pagara tributo.
4 Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.
4 Mas o rei da Assíria descobriu que Oséias era um traidor, pois havia mandado emissários a Sô, rei do Egito, e já não pagava mais o tributo, como costumava fazer a cada ano. Por isso, Salmaneser mandou lançá-lo na prisão.
5 Assyria king and en sojas mash go attack Samaria kon seize am for three years.
5 O rei da Assíria invadiu todo o país, marchou contra Samaria e a sitiou por três anos.
6 For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
6 No nono ano do reinado de Oséias, o rei assírio conquistou Samaria e deportou os israelitas para a Assíria. Ele os colocou em Hala, em Gozã do rio Habor e nas cidades dos medos.
7 Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga dia God; di Pesin wey save dem from Egypt pipol and King Fero hand. Dem dey woship oda gods;
7 Tudo isso aconteceu porque os israelitas haviam pecado contra o Senhor seu Deus, que os tirara do Egito, de sob o poder do faraó, rei do Egito. Eles prestaram culto a outros deuses
8 di kountries wey God porshu bikos of Israel pipol, dem dey follow dem serve dia juju kon dey do all di bad-bad tins wey Israel kings do before.
8 e seguiram os costumes das nações que o Senhor havia expulsado de diante deles, bem como os costumes que os reis de Israel haviam introduzido.
9 Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well.
9 Os israelitas praticaram o mal secretamente contra o Senhor seu Deus. Desde torres de sentinela até cidades fortificadas, eles mesmos construíram altares idólatras em todas as suas cidades.
10 Dem build image and Asherah juju for evry high place and under evry green tree.
10 Ergueram colunas sagradas e postes sagrados em todo monte alto e debaixo de toda árvore frondosa.
11 Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.
11 Em todos os altares idólatras queimavam incenso, como fizeram as nações a quem o Senhor havia expulsado de diante deles. Fizeram males que provocaram o Senhor à ira.
12 Even as God kommand dem rish, dem still dey woship dia yeye juju.
12 Prestaram culto a ídolos, embora o Senhor houvesse dito: "Não façam isso".
13 God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”
13 O Senhor advertiu Israel e Judá por meio de todos os seus profetas e videntes: "Desviem-se de seus maus caminhos. Obedeçam às minhas ordenanças e aos meus decretos, de acordo com toda a Lei que ordenei a seus antepassados que obedecessem e que lhes entreguei por meio de meus servos, os profetas".
14 But una nor gri listin, instead una dey show strong head like dia grand-grand papa wey nor trust di Oga dia God.
14 Mas eles não quiseram ouvir e foram obstinados como seus antepassados, que não confiaram no Senhor seu Deus.
15 Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.
15 Rejeitaram os seus decretos, a aliança que tinha feito com seus antepassados e as suas advertências. Seguiram ídolos inúteis, tornando-se eles mesmos inúteis. Imitaram as nações ao seu redor, embora o Senhor tivesse lhes ordenado: "Não as imitem".
16 Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
16 Abandonaram todos os mandamentos do Senhor, do seu Deus e fizeram para si dois ídolos de metal na forma de bezerros e um poste sagrado. Inclinaram-se diante de todos os exércitos celestiais e prestaram culto a Baal.
17 Dem offa dia shidren as sakrifice and dey do majik and oda bad-bad tins. Dem decide to dey do bad tins for God present and na dis make God dey vex.
17 Queimaram seus filhos e filhas em sacrifício. Praticaram adivinhação e feitiçaria e venderam-se para fazer o que o Senhor reprova, provocando-o à ira.
18 So, bikos God dey vex for Israel pipol, E kon rijet dem; but Judah tribe still dey obey am.
18 Então o Senhor indignou-se muito contra Israel e os expulsou da sua presença. Só a tribo de Judá escapou,
19 Leta, Judah pipol nor gri obey wetin di Oga dia God tok; dem kon dey do like Israel pipol.
19 mas nem ela obedeceu aos mandamentos do Senhor seu Deus. Seguiram os costumes que Israel havia introduzido.
20 So God rijet all Jakob shidren-shidren; E disgrace and give dem to tif, until E komot all of dem from en present.
20 Por isso, o Senhor rejeitou todo o povo de Israel; ele o afligiu e o entregou nas mãos de saqueadores, até expulsá-lo da sua presença.
21 E remove Israel pipol from David generashon and Nebat pikin, Jeroboam kon bi dia king. Jeroboam drive Israel pipol komot from God present kon enkourage dem to sin well-well.
21 Quando o Senhor separou Israel da dinastia de Davi, os israelitas escolheram como rei Jeroboão, filho de Nebate, que induziu Israel a deixar de seguir o Senhor e o levou a cometer grande pecado.
22 Israel pipol kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin and dem nor gri turn kom meet God.
22 Eles permaneceram em todos os pecados de Jeroboão e não se desviaram deles,
23 So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.
23 até que o Senhor os afastou de sua presença, conforme havia advertido por meio de todos os seus servos, os profetas. Assim, o povo de Israel foi tirado de sua terra e levado ao exílio na Assíria, onde ainda hoje permanecem.
24 Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.
24 O rei da Assíria trouxe gente da Babilônia, de Cuta, de Ava, de Hamate e de Sefarvaim e os estabeleceu nas cidades de Samaria para substituir os israelitas. Eles ocuparam Samaria e habitaram em suas cidades.
25 Wen dem first rish der, dem nor gri woship God. So God kon send lion go meet and kill some of dem.
25 Quando começaram a viver ali, não adoravam o Senhor; por isso ele enviou leões para o meio deles, que mataram alguns dentre o povo.
26 Dem kon tell Assyria king wetin happen sey, “Di pipol wey yu bring kom dis town, nor know wetin God wont for di town, so E don send lion kom kill dem. Di lion dey kill pipol, bikos dem nor know wetin God wont for di land.”
26 Então informaram o rei da Assíria: "Os povos que deportaste e fizeste morar nas cidades de Samaria não sabem o que o Deus daquela terra exige. Ele enviou leões para matá-los pois desconhecem suas exigências".
27 So Assyria king ansa, “Make una go bring one among di priest wey wi take from der kom. E go stay der kon tish us wetin God wont for di land.”
27 Então o rei da Assíria deu esta ordem: "Façam um dos sacerdotes de Samaria que vocês levaram prisioneiro retornar e viver ali para ensinar as exigências do Deus da terra".
28 So di priest wey dem bin karry komot Samaria kon go back go stay for Bethel. E tish dem how to woship God.
28 Então um dos sacerdotes exilados de Samaria veio morar em Betel e lhes ensinou a adorar o Senhor.
29 But each tribe make dia own gods kon put dem for shrine for di high place wey Samaria pipol make. Each tribe do like dis for di town wey dem dey.
29 No entanto, cada grupo fez seus próprios deuses nas diversas cidades em que moravam e os puseram nos altares idólatras que o povo de Samaria havia feito.
30 Di pipol wey kom from Babilon make Sukkot-Benot; while di ones wey kom from Kut, make Nergal and doz wey kom from Hamat, make Ashima;
30 Os de Babilônia fizeram Sucote-Benote, os de Cuta fizeram Nergal e os de Hamate fizeram Asima;
31 di ones wey kom form Avva, make Nibhaz and Tartak; while doz wey kom form Sefarvaim dey burn dia sons for fire as sakrifice to Adrammelek and Anammelek wey bi Sefarvaim gods.
31 os aveus fizeram Nibaz e Tartaque; os sefarvitas queimavam seus filhos em sacrifício a Adrameleque e Anameleque, deuses de Sefarvaim.
32 Bikos dem dey fear God well-well, dem kon pick some from dia own pipol wey go work as priest for di shrine wey dey di high place dem.
32 Eles adoravam o Senhor, mas também nomeavam qualquer pessoa para lhes servir como sacerdote nos altares idólatras.
33 For di same time, dem dey woship God and serve dia gods, just as dem dey do from where dem from kom.
33 Adoravam o Senhor, mas também prestavam culto aos seus próprios deuses, conforme os costumes das nações de onde haviam sido trazidos.
34 Till today, dem still dey woship dia gods. Dem stop to woship God or obey en rules, kommand and laws wey E give Jakob shidren-shidren.
34 Até hoje eles continuam em suas antigas práticas. Não adoram o Senhor nem se comprometem com os decretos, com as ordenanças, com as leis e com os mandamentos que o Senhor deu aos descendentes de Jacó, a quem deu o nome de Israel.
35 God enter agriment with Israel pipol sey, “Una must nor woship anoda god. Make una nor bow, serve or offa sakrifice to dem.
35 Quando o Senhor fez uma aliança com os israelitas, ele lhes ordenou: "Não adorem a outros deuses, não se inclinem diante deles, não lhes prestem culto nem lhes ofereçam sacrifício.
36 Instead una must woship mi wey bring una kom out from Egypt with my great pawa. Una go bow and offa sakrifice to only mi.
36 Mas o Senhor, que os tirou do Egito com grande poder e braço forte, é a quem vocês adorarão. Diante dele vocês se inclinarão e lhe oferecerão sacrifícios.
37 Una must always dey obey my rules, laws and di kommandment wey I rite for una. Una must nor woship anoda god.
37 Vocês sempre tomarão o cuidado de obedecer aos decretos, e às ordenanças, às leis e aos mandamentos que lhes prescreveu. Não adorem a outros deuses.
38 Una must nor forget di agriment wey I make with una and make una nor woship anoda god.
38 Não esqueçam a aliança que fiz com vocês e não adorem a outros deuses.
39 Make una woship di Oga wey bi una God; den E go save una from all una enemies.”
39 Antes, adorem o Senhor, o seu Deus; ele os livrará das mãos de todos os seus inimigos".
40 But dem nor listin; instead dem do as dem dey do before.
40 Contudo, eles não deram atenção, mas continuaram em suas antigas práticas.
41 Even doh dis pipol dey woship God, dem still dey serve juju. So till today, dia shidren and shidren-shidren dey bihave like dem.
41 Mesmo enquanto esses povos adoravam o Senhor, também prestavam culto aos seus ídolos. Até hoje seus filhos e netos continuam a fazer o que seus antepassados faziam.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.