2 Reis 12

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 For di sevent year wen Jehu dey rule, Jehoash kon bi king; e rule Judah for forty years from Jerusalem. En mama na Zibaya wey kom from Beersheba.
1 Começou a reinar no sétimo ano de Jeú e reinou durante quarenta anos em Jerusalém. Sua mãe chamava-se Sébia, e era natural de Bersabéia.
2 Thru-out di time wey Jehoash dey rule, e do as God kommand, just as Priest Jehoiada tish am.
2 Joás fez o que era bom aos olhos do Senhor, durante todo o tempo em que esteve sob a direção do sacerdote Jojada.
3 But e nor skata di juju place dem; so di pipol still dey go offa sakrifice and burn incense for der.
3 Todavia, não destruiu os lugares altos, e ali o povo continuava sacrificando e queimando incenso.
4 Jehoash tell di priests, “All di silva wey dey God Temple, di ones wey dem kollect wen dem dey kount di pipol, all di silva wey dem kollect as vow and di ones wey pipol just drop on dia own, make una use dem ripair di Temple.
4 Joás disse aos sacerdotes: Todo o dinheiro consagrado, que for trazido ao templo do Senhor, assim como o dinheiro que for entregue por todo israelita recenseado, e o que provir do resgate das pessoas, após avaliação, como também os dons espontâneos oferecidos ao templo do Senhor,
5 Make una kollect di money from doz wey dey keep am kon ripair anywhere wey spoil for di Temple.”
5 recebam-no os sacerdotes, cada um receba-o dos seus clientes, e empreguem-no na reparação do edifício, onde quer que se encontre qualquer estrago.
6 For di twenty-three years wen Jehoash don bi king, di priests neva still ripair where spoil for di Temple.
6 Ora, no vigésimo terceiro ano do reinado de Joás, os sacerdotes não tinham ainda feito restauração alguma no templo.
7 So King Jehoash koll Jehoiada with oda priests kon sey, “Wetin make una neva ripair where spoil for di Temple? Naw, make una nor take any money again escept una won use am ripair di Temple.”
7 O rei chamou o sacerdote Jojada e os outros sacerdotes, e disse-lhes: Por que não fazeis vós a reparação do templo? Doravante não recebereis mais o dinheiro de vossos clientes, mas o entregareis para os reparos do templo.
8 Di priests dem gri sey dem nor go kollect money from di pipol, so dat nobody go akuiz dem sey dem nor ripair di Temple.
8 Os sacerdotes consentiram em não mais receber o dinheiro do povo, e declinaram do cargo das reparações do edifício.
9 But Jehoiada take one box kon kut hole put for en top and put am for di rite side for di altar where dem dey pass enter God house. Den di priest wey dey di temple gate, go pak and put all di money inside di box.
9 O sacerdote Jojada tomou um cofre, fez-lhe um buraco na tampa e colocou-o junto do altar, à direita da entrada do templo do Senhor. Os sacerdotes que guardavam a entrada do templo ali depositavam todo o dinheiro que era levado ao templo do Senhor.
10 Wen dem si sey di box don full, di royal seketry and di High Priest go kount and keep di money.
10 Quando viam que havia muito dinheiro no cofre, vinha um escriba do rei com o sumo sacerdote, que recolhia e contava todo o dinheiro que se encontrava no templo do Senhor.
11 Den dem give di money to di pesin wey dey ripair di Temple. Dem hire karpenters and builders wey go work for di Temple,
11 E uma vez pesado o dinheiro, era o mesmo entregue nas mãos dos que presidiam as obras do templo do Senhor. Estes empregavam-no pagando os carpinteiros e operários que trabalhavam nas reparações,
12 plus brick-laya and doz wey dey kut stone. Dem bring wood and chisel wey dem go take ripair di part wey spoil for di Temple kon pay for evry oda tin.
12 os pedreiros e canteiros, comprando a madeira e as pedras de cantaria necessárias às reparações, e cobrindo todas as despesas decorrentes dos trabalhos.
13 Di money wey dem bring kom God Temple, dem nor use am for silva bowl, wetin dem take dey burn incense, basins, trumpets or anytin wey bi gold or silva.
13 Não se faziam, porém, com esse dinheiro que era trazido ao templo do Senhor, taças, nem facas, nem bacias, nem trombetas, nem utensílio algum de ouro ou de prata;
14 Dem give di money to di workers wey go ripair God Temple.
14 mas era dado aos empreiteiros, que o empregavam nas reparações do templo do Senhor.
15 Di pesin wey dey pay di workers, dem nor ask am how e take dey spend di money, bikos dem trust and bilive am.
15 Não se pediam contas àqueles que recebiam o dinheiro destinado à paga dos operários, porque eram homens honestos.
16 (Di money wey dem kollect, plus di ripair and sin ofrins, dem nor bring dem kom God Temple, bikos na di priests own.)
16 Quanto ao dinheiro dos sacrifícios pelos delitos ou pelos pecados, não era levado à casa do Senhor, mas era dos sacerdotes.
17 For dat time, King Hazael for Siria kon attack and seize Gat. Hazael still attack Jerusalem.
17 Naquele tempo, Hazael, rei da Síria, sitiou Get e apoderou-se dela. Depois foi atacar Jerusalém.
18 King Jehoash for Judah kollect all di holy tins wey en grand-grand papa Jehoshafat, Jehoram and King Ahazaya keep for di Temple for Judah, plus di holy tins wey en ensef keep and all di gold wey dey for God Temple and di king palis kon send dem go give King Hazael for Siria, so dat e nor go kom attack Jerusalem again.
18 Joás, porém, rei de Judá, tomando os objetos sagrados oferecidos pelos seus pais, Josafá, Jorão e Ocozias, reis de Judá, e os que ele mesmo tinha oferecido, assim como todo o ouro que se achava nas reservas do templo do Senhor e do palácio real, mandou tudo isso a Hazael, rei da Síria, o qual desistiu de sua campanha contra Jerusalém.
19 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite dem for Judah kings history book.
19 O resto da história de Joás, seus atos e seus grandes feitos, tudo se acha consignado no livro das Crônicas dos reis de Judá.
20 En ofisas plan kon kill-am for Bet-Millo for di road wey face Silla.
20 Seus servos levantaram-se, fizeram uma conspiração e assassinaram o rei em Bet-Milo, no declive de Sela.
21 Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
21 Josacar, filho de Semaat, e Josabad, filho de Somer, seus criados, feriram-no, e ele morreu. Joás foi sepultado com seus pais na cidade de Davi. Seu filho Amasias sucedeu-lhe no trono.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Reis 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.